
Wafcon 2024: Nigeria vs Tunisia match preview
Dem go face Tunisia for dia opening Group B match wey go shele for di Larbi Zaouli stadium, Casablanca.
Dis na di second time wey dem dey meet for di Women's Africa Cup of Nations.
Di only time dem bin meet before na for Wafcon 2008 wen dem play goalless draw, for Bata, Equatorial Guinea.
Nigeria Coach, Justin Madugu say "We dey prepare veri well and di girls dey respond positively ...we dey good to go!."
Coach Madugu add say dem need to show respect to evri team wey qualify for dis finals.
"We no dey take anybody forgranted sake of assumption say we don win all our previous games against nort African teams becos e go dey easy, no game dey easy" im conclude.
Super Falcons Captain Rasheedat Ajibade say "evritin dey go well, di backroom staff dey make sure say dem do evritin to make di team respond positively, we dey do evritin to make sure say we perform well for all our games".
Head coach of Tunisia Kamel Saada say "Nigeria get good players and Tunisia get good team even though dem no dey experienced. but we fit start well against Nigeria. Nigeria na favourite but as far say we [Tunisia] qualify we fit get sometin out.
Match Facts
Nigeria
According to Caf data, Nigeria don play 61 matches for Wafcon finals, dem win 45—more dan any oda team. Dia record include 9 draws and 7 defeats.
Nigeria na di highest scorer for di tournament history wit176 goals for 61 matches, wit di average of 2.89 goals per game and dem concede only 28.
Dia record for Wafcon opening matches na eight wins , two draws and two losses for di 12 games wey dem bin don play.
Dia biggest opening-game win na 8-0 victory against host Morocco for 1998.
Nigeria have bin score 40 goals across dia 12 tournament openers and concede 8— and six na for dia last five opening games.
Na only one time don don fail to score for dia opening match, and na1-0 dem lose to South Africa for 2018.
Nigeria neva lose any of dia opening games across dia first 10 appearances (W8 D2), but dem bin lose dia opening match for di last two tournaments—1-0 and 2-1 defeat to South Africa for 2018 and 2022.
Before dem lose dem bin win four straight openers (2010–2016).
Tunisia
For Tunisia dia record for opening matches na one win and one loss out of two games.
Dem bin lose 2-1 to South Africa for dia 2008 opener. Dia only Wafcon win na for dia 2022 opening match wey dem beat Togo 4-1.
Dem no score for dia last four finals matches and na 372 minutes e be in total witout a goal.
Tunisia bin keep two clean sheets for eight final games—both against West African opponents (Nigeria for 2008, Senegal for 2022).
Dia only group-stage draw na di 0-0 result against Nigeria for 2008.
Live match commentary go start by 4pm Nigerian time
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
21 hours ago
- BBC News
Which team make di highest profit from di Club World Cup $1bn prize pot?
Di Club World Cup get im critics but for di clubs wey bin dey involved di competition $1bn prize pot don prove to be good business. Now wey di first edition of di new-look tournament don complete, we fit analyse di financial rewards wey clubs wey compete get. BBC Sport explain di breakdown of di prize money and wetin e mean for di clubs wey get am. How much money bin dey on offer? Di new look competition bin get a prize pot of $1bn (£726m) to give out to di 32 competing clubs, out of dat money $525m dey divided between all clubs for participation and Fifa award $475m on a performance-related basis. Di money wey dem give European clubs for appearance dem share am based on sporting and commercial criteria, e mean say some clubs collect more pass odas for taking part. European clubs collect between $12.81m and $38.19m just for turning up, while teams from oda continents dem give dem a set fee - $15.21m for South America, $9.55m for North and Central America, and Asia and Africa, and $3.58m for Oceania. Fifa neva confam di individual amounts wey dem give to European clubs for taking part, so we dey use estimates from football finance website The Swiss Ramble based on Uefa club coefficient system. Di prize money figures dey converted from US dollars into pound sterling. Di big winners Tournament winners Chelsea na by far di most financially successful team, dem earn about £84m, while Paris St-Germain make about £78.4m for dia run to di final. European clubs, wey generally bin enjoy larger participation fees, make an average of around £39m while impressive runs from di likes of semi-finalists Fluminense mean say dat South American clubs make £24m on average. Money bin dey on offer for results for di group stage, wit around £1.5m for a win and £730k for a draw. Five clubs, including Pachuca and Seattle Sounders, bin lose all three group games dis one mean say dem only receive dia participation fee. Auckland City hit jackpot Despite say di prize money figures for di likes of part-time side Auckland City bin look small, di competition been dey incredibly lucrative for dem within di context of dia overall finances. Di £3.3m wey Auckland City take home na around seven times dia overall 2024 revenue of approximately £488,000, while di £67m wey Real Madrid make na just 4% of dia 2024 figure of £901m. While dis na huge positive for di part-time club, football finance expert Kieran Maguire share im concerns for di impact on oda sides from New Zealand. Im say: "Dem don earn so much money sotay e dey difficult to see anybody wey fit compete wit dem if dem invest di money for dia playing squad. "And dem get reason to do so becos e go boost dia chances of qualifying for di next Club World Cup. "E good for dem, but e no necessarily dey good for di league wen you dey try to sell a competitive league to broadcasters." Extra transfer funds For di European clubs, di extra revenue dey welcomed as dis na way of increasing dia transfer budget. In line wit Uefa rules, clubs dey limited to spending 70% of dia revenue on wages, transfers and agents' fees - so for every £50m dem earn, an extra £35m dey available for recruitment. Some clubs don already pay off dia summer transfer business sake of say dem take part for di competition. More dan 65% of Borussia Dortmund £57.9m transfer business so far dis summer dem don pay am off from dia participation for United States afta dem reach di quarter-final stage. Di £27m Dortmund bin pay to Sunderland for Jobe Bellingham already dey completely paid off. Chelsea bin spend £198m on reinforcements so far dis summer on di likes of Joao Pedro and Liam Delap - £84m of dat dey covered by dia impressive run for di Club World Cup. Despite Manchester City surprise last-16 exit to Al-Hilal, dem still earn around £38m from di tournament - wey equate to 35% of di summer business dem don conduct so far. In more simple terms, e don pay for dia £31m acquisition of Rayan Ait-Nouri from Wolves. Real Madrid bin pay Liverpool a fee of around £8.4m for Trent Alexander-Arnold to sign am one month early to dey part of dia squad for di competition - dem pay dat one off afta just three matches. "Di accountant for di football club like di idea. Di business go dey happy," na wetin finance expert Maguire tok about di competition lucrative incentives. "But I no sure say di fans dey happy, particularly European clubs, and e go be di same for players and managers. "We dey reach a crisis point as far as player welfare dey concerned. We fit enter a period of conflict between players and owners."


BBC News
a day ago
- BBC News
Ghana face Tanzania for do-or-die clash for 2024 Wafcon group C
Di final group C game for di ongoing Wafcon between Ghana and Tanzania go happun on Monday night. Na do-or-die match; di winner go fit qualify for di quarterfinal of di tournament sake of di two teams gat one point each from dia first two games. Both teams sabi say dem no fit do mistake for dis ogbonge game, sake of defending champions South Africa already bin qualify afta 2 wins from 2 games, and dem go play against Mali for di oda group C match. Di black queens so far dey struggle to score goals afta dem bin score only one goal from 31 shots for dia two games. Di twiga stars of Tanzania also bin score only one goal from dia two group games. But for dis match, di two coaches go put tactics for ground and hope say dem go find di luck wey go help dem score goals. If both teams play anoda draw today, dem go pack dia bags and comot di tournament. For di black queens - dem bin lose 2-0 to defending champions Banyana Banyana wia dem draw 1-1 wit di female eagles of Mali for di second game. Na so di twiga stars of Tanzania lose dia first game 1-0 to Mali wia dem draw 1-1 wit South Africa for di second match. Dem score first thru Opa Clement Tukumbuke for di first half bifor South Africa bin equalise afta di 70th minute. Wetin di two coaches tok Head coach for di Twiga stars Bakari Shime believe say im team fit build on dia 1-1 draw wit defending champions South Africa, for dis game against di black queens. "From di way we play dat match, e don give us confidence," oga Shime tok wey CAF online don quote. Shime also bin get im goalscorer Opa Clement Tukumbuke available for di game; im believe say she fit lead her girls to victory. "We to play dis last group game, na very important game for both teams but for us especially." Im add say "we gat one point so far wey we dey look forward to get 3 points wey go make us qualify for di next round." "We sabi Ghana well well, we don follow dia two games; but we wan walk away wit 3 points, we wan go forward, na so we go try to achieve our aim," Bakari Shime tok for pre-match press conference. For di black queens coach Kim Lars Björkegren, to comot di Wafcon for di group stage na shame. Im tok say im go keep to dia plan for dis game. "We gat everitin for our hands to win dis game v Tanzania. We bin dey hope to score more goals for our first two games, we gat di chances but we no fit do am." Im add say "I sabi say we dey good position, we for only win one game to play for di quarterfinal, we fit be second or third for di group, I still believe in our players. Back home, football fans and sabi pipo believe say coach Björkegren no deliver so far for di tournament, wey dem dey fear say Tanzania go comot Ghana. But di players say dem go try to make di fans proud for dis one. Head-to-head Dis Monday game na di first time Ghana and Tanzania bin dey face each oda. Both teams don score one goal for di Wafcon dis year, na only Tunisia and Botswana (0) no score any goal at all. Ghana neva get clean sheet for dia last 7 games Tanzania na di second lowest ranked team for dis tournament ; dem bin dey 137th for di FIFA women's ranking wey Ghana bin Dey 66th. For dia last five Wafcon, Ghana don only progress from di group stage for 2016 when dem bin finish third but dem don comot for group for 2008, 2010, 2014 and 2018. Di Twiga stars bin qualify for di Wafcon only two times, di first for 2010 and then dis current edition. For 2010, dem bin comot for di group stage. Dis na chance to progress from di group stage for di first time. Tins don set between di two for dis ogbonge clash for Monday night. For Ghana, di coach go dey without striker Doris Boaduwaa wey bin assist di only goal for di black queens for di competition. She don play 180 minutes for competition but di coach go hope say oda players like Princess Marfo go fit cause wahala for di left wing of di Twiga stars. Princella Adubea wey be striker go replace Dori Boaduwaa as di target pesin. Adubea fit hold di ball well well wey she fit play as di arrow head for di Ghana attack for dis game. Midfielder Jennifer Cudjoe wey bin win woman of di match award v Mali also go start for di center, she go dey key for di Ghana coach. For di Twiga stars, dia captain Opa Clement Tukumbuke wey bin score dia goal v South Africa, go dey available to lead. Coach Bakari Shime hope say she go lead from di front togeda wit star player Clara Luvanga. Luvanga bin dey treat one ankle injury but she come back for dis game. Di Al-Nassr player wey emerge from di Tanzania U17, U20 ranks fit make her debut for di game. Di game go happun at 7PM GM (8PM WAT) for di Berkane stadium. Make una dey wit us for di live text commentary for di ogbonge game. At di same time, South Africa and Mali go play each oda.


BBC News
2 days ago
- BBC News
Nigeria draw with Algeria as both sides progress at Wafcon
Nigeria set up a quarter-final showdown with Zambia at the 2024 Women's Africa Cup of Nations after a 0-0 draw with Algeria secured the Super Falcons top spot in Group result in Casablanca also meant the North Africans progressed to the last eight, where they will face the second-placed finisher in Group Botswana came from behind to beat Tunisia 2-1 and boost their chances of going through as one of the two best-ranked third-placed Khanchouch's 12th-minute effort put the Carthage Eagles ahead before Lesego Radiakanyo equalised midway through the second teams would have been eliminated by a 1-1 draw and it was Botswana who grabbed a dramatic winner in the sixth minute of stoppage time through Gaonyadiwe results mean defending champions South Africa and Mali are both assured of a place in the quarter-finals before Group C culminates on Monday (19:00 GMT).Banyana Banyana face the West Africans in Oujda, while Ghana take on Tanzania in Berkane with both of those sides needing to win to progress.