logo
'PDP don scatta, dem don frustrate me'

'PDP don scatta, dem don frustrate me'

BBC News05-02-2025

Nigerian lawmaker wey dey represent Delta north senatorial district, don port from di Peoples Democratic Party (PDP) to di ruling All Progressives Congress (APC).
Senator Ned Nwoko officially announce on di floor of di Senate on Wednesday 4 February during plenary say im don defect from di PDP to APC.
Tori bin dey fly upandan recently say di Nigerian politician don comot from di major opposition parties for Nigeria.
Oga Ned for dis exclusive interview wit BBC Pidgin confam say im don port true-true and im tok why im comot from PDP afta over twenty years.
"Yes I don comot from APC, now I be a card carrying member of di APC and I don resign formally last week from PDP".
"PDP dey in disarray, you dey see di fights for television, you dey see di crisis, we bin get hope say PDP go be a formidable (strong) opposition but no be wetin I experience for di last two years".
Im explain say dis na di first time wey im dey for opposition goment and e no dey favour im pipo concerning projects wey suppose happun for di state wey go beta dia lives.
According to am, di pipo wey vote am suppose benefit and one of di reasons wey im decide to make dis "sacrifice" na sake of di over fifty years agitation of im pipo to get dia own Anioma state.
Im also tok say di leadership of di Peoples Democratic party don fail at evri level and di kasala wey dey for di party na wetin dem no go fit solve again.
'No opposition for Nigeria, PDP crisis no dey solvable'
Senator Ned Nwoko tell BBC Pidgin say, "di hierarchy (leadership) of PDP no know wetin to do" sake of say, opposition no dey for Nigeria and e dey pain am well-well.
Im tok say im do tok-tok (consultation) wit im pipo and im bin tink say to dey opposition wey dey vibrant, wey get di interest of di pipo for dia mind go help democracy grow for Nigeria, but no be so e be for di PDP.
Di Peoples Democratic Party, na one of di oldest and strongest political party for Nigeria between 1999 to 2015 wen former President Goodluck Jonathan lose election to former President, Muhammadu Buhari.
But since 2015, PDP dey struggle to reclaim power for di centre (federal level) but e neva work for dem.
Tori about how di political party dey struggle and how dem dey try to settle kasala among demsefs both internally and externally dey enta news evritime.
Na some of dis wahala dem wey di party dey face Senator Ned Nwoko tok say make "di problems for PDP no dey solvable" and na why im port.
"Di pipo wey for help PDP settle dis crisis within PDP like Atiku Abubakar and odas don decide to comot from PDP to form a mega party, na wetin I sabi, so as dem dey comot from PDP, di kasala now go plenti becos now we go get two opposition parties wey no go fit really compete wit APC".
Im add say di only way to get beta opposition for Nigeria na wen di new mega party wey di pipo wey wan break out from PDP wan form, join bodi wit di second opposition party.
According to di Delta state politician, if di two political parties stand on dia own, e go make tins worse as e no go give dem chance to compete, and na wetin im dey avoid for im pipo.
'PDP no dey support di dream to create Anioma state'
Anoda reason wey di popular businessman give na say im wan fight for di creation of Anioma state for di South East geopolitical zone.
Im say Anioma state na wetin im wan achieve and if joining APC go help am achieve dis tin for im pipo, im ready to make di sacrifice.
Im say since im begin push for di creation of Anioma state wey im describe as di state of equity, wey im pipo don dey agigate for since, im former political party, PDP no support am but na APC pipo dey support am.
"Di creation of state na a veri difficult process I understand, but South East, Ndi-Igbo deserve one extra state, to make am six just like di oda zones except North West wey get seven.
Most of my members dey look at di sixth state, wey dem dey call equity state, so dat di Igbos go get a sense of justice and belonging.
"South South get six states, North Central six, North East six, South East five, and di young ones for South East dey fight for recognition and justice, dem dey fight becos dem dey marginalised."
Ned say di injustice wey di South East dey face since di war don do, and as war time don pass, time don reach make dem get justice wit dis Anioma state creation.
'I no wan be Govnor of Delta State'
Di Nigerian lawmaker tell BBC Pidgin say im no get any ambition to become di govnor of Delta State.
Im say wen di time reach, im wit oda stakeholders for di state to sitdown do tok-tok about who go become di state govnor for 2027.
Im add say young pipo dey wey dem fit choose from and im dey sure say APC go produce di next govnor of Delta State even though di state na one of di strongholds of PDP now.
"Di pesin go sitdown wit us, we go tell di pesin say dis na di tins we need for Anioma, Delta North, Central and di South, we go sign agreement, we go get a projected performance for four years. If you agree we go sign am, if you no agree, we go look for anoda pesin wey go develop di pipo and di infrastructure and empower di pipo."
Di former PDP lawmaker say no mata wetin happun in future, im go dey APC so far as e go benefit im pipo and im no go just dey for APC dey look pipo face.
"I go be a key player for APC, I no go be observer or by-stander, so di tin wey suppose be for my pipo, dem must do am for my pipo" im add.
On Tinubu policies and di future
Concerning some of di policies wey di leadership of President Bola Tinubu don bring, oga Ned tok say even though e dey tough on di citizens of Nigeria for now, wit time, evritin go dey alright in future.
"Di reforms on taxes dey pipo friendly, e go help small business and pipo wey no dey earn a particular amount of money."
"I dey happy say di govnors from di north wey bin dey oppose am, no dey oppose am again becos dem don understand say, to get tax laws wey dey togeda under one document, is better, instead of having one million tax laws evriwia"
Im add say, opportunity dey for anybody wey no dey happy wit di laws to go tribunal wey go deal wit am.
Apart from di tax reforms and subsidy removal on petrol, oga Ned say oda areas dey wey President Tinubu go still touch wey go sweet im belle like di use of foreign currencies for Nigeria and di ban on importation of non essentials goods.
Im say na dis tins dey spoil di economy for Nigeria and if goment stop am, di economy go grow.
"Wen we stop to measure our naira wit Pounds and Dollars and we become self sufficient wit our local products, wen our economy good, evribody go benefit from am. Weda you rich or poor no dey important becos evribody go dey happy.
But all of us must dey prepared to go through a period of planning, wen we do am, at least you go know say in di next five, ten years we dey try to get Nigeria to a level, make we tighten our belt but e must be across board, from local goment chairmen to govnors and di president." Im conclude.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

FCT administration get power to seal foreign missions for Nigeria sake of ground rent?
FCT administration get power to seal foreign missions for Nigeria sake of ground rent?

BBC News

time6 hours ago

  • BBC News

FCT administration get power to seal foreign missions for Nigeria sake of ground rent?

Di publication of names of property owners for Abuja wey dey owe ground rent, according to di Federal Capital Territory, don cause plenty tok-tok for Nigeria, especially becos many embassy of foreign kontris appear for di list. Minister of di FCT, Nyesom Wike bin don threaten plenty times say goment go take over di property of pipo or companies wey dey owe ground rent. On 26 May, 2025, officials of di FCTA start to dey seal buildings of pipo wey dem tok say dey owe ground rent for as long as 20 years. Dem seal di headquarters of di Peoples Democratic Party (PDP) and di Abuja office of di Federal Inland Revenue Service (FIRS), among odas. Pipo bin condemn di action as dem say Wike dey use im power as FCT Minister to dey carry out vendetta attack on im party as e dey quarrel wit di party leadership. However, President Bola Tinubu later intervene for di matter and give a 14-day grace period to allow pipo wey dey owe to pay up. Dat grace period expire on Monday, 9 June 2025. Di list of debtors wey di BBC Pidgin see get 3,383 names inside am, including some popular pipo, top religious organisations and more dan 35 foreign missions. Tori don dey go round say di FCT authority fit carry out dia threat to revoke di ownership of property owners wey dey owe ground rent, but many dey ask weda dem get such power? Wetin di law tok? Popular human rights lawyer, Femi Falana, advise di FCT Minister, Wike, make e no go cause diplomatic wahala between Nigeria and foreign kontris wey get dia embassy for Abuja. "You no fit invade embassies sake of say dem neva pay ground rent, wey no dey applicable for all of dem," Falana tok for TV interview. E say foreign missions dey protected by di Vienna convention wey Nigeria be signatory to, and article 22 of dis convention tok say embassies and even vehicles of foreign diplomats get immunity, so nobody fit violate am. "If we embark on invading di embassy of any kontri, e go lead to serious diplomatic wahala for Nigeria. E no dey allowed," Falana tok. Also, a civil society group for Nigeria, Serap, ask President Tinubu to caution Minister Wike and direct am make e no carry out im threat. Article 22 of di Vienna convention say: "Di premises of di mission go dey inviolable. Di agents of di receiving State no fit enta dem, except wit di consent of di head of di mission. "Di receiving State dey under special duty to take all appropriate steps to ... prevent any disturbance of di peace of di mission or impairment of its dignity. "Di premises of di mission, dia furnishings and oda property and di means of transport of di mission go dey immune from search, requisition, attachment or execution." However, some oda lawyers tok say foreign missions suppose to dey pay all di money wey di law require for di kontri wia dem dey, even though dem get immunity. Abdul Mahmud wey be legal practitioner and founder of di Public Interest Lawyers League (Pill) explain say na "common misconception" to think say di premises of embassies go be sovereign territory of di embassy. "Embassy no be di sovereign territory of di sending state. Rather, e be di premises of a diplomatic mission under Article 22 of di Vienna Convention," oga Mahmud explain on X. "Di land wia di Embassy dey still belong to di Host State. Di idea say embassy na extraterritorial or sovereign soil of di sending state na legal fiction, no be legal fact. According to di legal expert, article 23 of di Vienna Convention exempt embassies and heads of missions from paying some direct taxes for di premises wia dem dey stay. "However, dem still fit dey pay for services, like ground rent, utility charges, or lease obligations, bicos dis na contractual or customary obligations, no be taxes," e tok. Wike go really seal di embassies? E neva dey clear wetin go be di next step of di FCT Minister Nyesom Wike for dis matter. Di expected drive by FCTA workers wey suppose resume dis Tuesday, afta di 14 days grace period wey President Tinubu give expire, no go ahead. Also, BBC Pidgin notice say di amount wey some of di embassies dey owe - according to di list wey di FCTA bin publish - na small money. For instance, di Mauritania embassy dey owe 8,150 naira ($5.17); di Thai embassy owe just 500 naira; di Malian embassy dey owe 8,600 naira; Kuwait and Saudi Arabia embassies dey naira 10,800 ($6) each, while di embassy of di UAE dey owe approximately over 6,000 naira. E dey highly unlikely say di Federal Capital Territory Authority go seal any of di embassies sake of dis shikini moni.

Flight carrying 35 people deported from Ireland makes stop over medical incident
Flight carrying 35 people deported from Ireland makes stop over medical incident

Belfast Telegraph

time5 days ago

  • Belfast Telegraph

Flight carrying 35 people deported from Ireland makes stop over medical incident

The 21 men, nine woman and five children left on a chartered flight which departed Dublin Airport on Wednesday night for Nigeria. Minister for Justice Jim O'Callaghan confirmed it was the third chartered flight used for deportations this year, at a cost of 324,714 euros which he said was 'value for money'. The plane was required to make the unscheduled stop, but Mr O'Callaghan said he was 'happy to say' that the flight was able to resume its journey with 'all 35 returnees arriving safely' in Lagos on Thursday morning. We need your consent to load this Social Media content. We use a number of different Social Media outlets to manage extra content that can set cookies on your device and collect data about your activity. The people deported were Nigerian nationals. Mr O'Callaghan confirmed the 'completion of a successful deportation operation' in a statement on Thursday morning. He said that the deported children were part of a family unit. It is the third operation carried out since the recommencement of charter flights for deportations in February of this year. 'Access to these services has significantly increased the capacity of An Garda Siochana to enforce deportation orders and is a measure Mr O'Callaghan is deploying to step up immigration enforcement,' the justice department said. 'Further charter operations will be conducted as the year progresses.' Mr O'Callaghan said that people coming to Ireland must follow the 'appropriate pathways' for legal migration. 'Ireland has a rules-based immigration system. It is important that those rules are robust and enforced,' he added. 'The return of people whose applications have been refused and deportation orders have issued is the foundation of any modern rules-based immigration process. 'People coming to Ireland must follow the appropriate pathways for legal migration and these pathways must be adhered to and protected for our immigration system to work fairly and effectively. 'If a person's application for international protection is refused and they are ordered to leave the State they must do so. 'This is the third charter operation this year. Removal operations of this nature send a clear message that there are consequences for people who remain in our country without permission and underscores this Government's intention to protect the integrity of our immigration system. 'The flight was required to make an unscheduled stop due to a medical incident on board, but I am happy to say that the flight was able to resume its journey with all 35 returnees arriving safely in Nigeria this morning. 'I want to thank the members of An Garda Siochana and my officials for their work in conducting this successful operation.' The charter flights are used in addition to commercial flights. These operations are conducted under a contract signed by the State in November 2024 for the provision of charter aircraft. Mr O'Callaghan added: 'Enforced removals are conducted as a measure of last resort when the person concerned has not removed themselves from the State or availed of assisted voluntary return measures. 'Before a deportation order is made, the person is offered assistance to return home voluntarily which is the preferred option. 'There has been a significant increase in the number of people leaving voluntarily and I continue to appeal to those who are given this opportunity to avail of it where appropriate.' Two charter flights already conducted this year have removed 71 people who were subject to deportation orders. This operation brings the number of people removed by charter flight to 106. Additionally, 54 deportation orders have been enforced on commercial flights and 23 people subject to deportation orders are confirmed to have left Ireland unescorted so far in 2025. Minister for Migration Colm Brophy said: 'Having a modern immigration system where its laws are effective and enforced is a key priority for this Government. 'The removal of people who have no legal right to be in the State, and the enforcement aspect of our immigration laws, are essential for the system to work effectively. 'Today's flight, the third charter flight this year, underpins the Government's commitment in this area. I would like to thank members of An Garda Siochana for their ongoing hard work and commitment to ensuring that our returns system is effective and efficient. 'This Department has a voluntary return programme to assist people to return prior to the issuance of a deportation order. 'This is the preferred option, and I would encourage those who are provided the opportunity to return voluntarily to avail of it. So far this year, 694 people have availed of the voluntary return programme.' In a statement, a spokesman for the gardai said that the Garda National Immigration Bureau (GNIB) carried out the operation. An Garda Siochana said it continues to work closely with the Department of Justice in implementing immigration policy. Minister for Children Norma Foley said parents who are subject to deportation orders should consider leaving Ireland voluntarily, saying it is in the 'best interest' of everyone. Speaking on Thursday, Ms Foley said she accepts it is a 'really, really challenging space and very difficult'. 'I absolutely accept that. I would have to say, though, that we have to have a very clear, rules-based system,' she added. 'I think people who come to the country need to know what the rules are, and the system will work as per the rules. It is my understanding in this instance, when you come and your case is assessed, if you have a right to be here, you stay here. You are supported here. 'If it is deemed that you don't have a right to be here, you have a right to challenge that. And there is an appeal process, and if you're unsuccessful with the appeal process, you are given the opportunity to leave the country voluntarily, and there is assistance provided for you to leave voluntarily. 'Many, many take up that opportunity to leave voluntarily. But if you don't leave, then there is this option that has to be taken in terms of you are being competitively. 'I would not want any child or any person to be in a stressful or stressed situation, but I think we must be clear as well that it is a rules based system. 'We want it to be fair, and we want the outcome to be fair. I think it's very important, and I think parents really should maybe consider this as an option. 'If you are given the opportunity to leave the country voluntarily, if assistance is provided to support you to do that, it would be in the best interest of everybody that you would do that voluntarily. 'This measure of being compelled to leave, that's a measure of last, last resort.'

Who be Nigerian actress Angela Okorie wey dey di centre of Nollywood drama?
Who be Nigerian actress Angela Okorie wey dey di centre of Nollywood drama?

BBC News

time6 days ago

  • BBC News

Who be Nigerian actress Angela Okorie wey dey di centre of Nollywood drama?

Celebrity life dey come wit fame, influence, money and constant public drama wey dey make dia life different from ordinary pesin. Nollywood actress Angela Okorie don dey di centre of di ongoing gbas-gbos between am, Mercy Johnson and Regina Daniels wey dey trend ontop social media. Angela recently make one post ontop social media say she don forgive Mercy Johnson, wey she bin get beef wit but Regina Daniel respond say "we no dey forgive for dis side". Na dis make Angela fire back. She verbally insult Regina Daniels claiming Regina marry her husband, Nigeria politician Ned Nwoko for money. Regina deny her claim and respond say na Angela dey beg her husband make im support am financially for her next project. Afta days of staying quiet, Mercy Johnson don tok say she go speak up for hersef and clear di air about di allegations against her. Who be Angela Okorie Angela Okorie na ogbonge musician and actress for Nollywood wey start her career as a model, bifor she break into stardom for 2009 wit her first feem 'Holy Serpent' and she don feature for several movies including 'Heart of a Widow' and 'Secret Code.' She don win several awards for di Nigeria movie industry. Angela win di 'Best Supporting Actress' category for di 2015 edition of di City People Entertainment Awards. Angela come from Enugu State, southeast Nigeria, but dem born am for Cotonou, Benin Republic, bifor she relocate to Nigeria wia she bin start to model for cosmetic brand for 2005 until she find her real passion wey be acting for 2009. Di actress get one pikin from her previous marriage wit Chukwuma Orizu. Di two dey togada for ten years bifor Angela announce her divorce ontop Instagram in 2015. She claim say her ex-husband no wan make she dey work as actress but di two still maintain dia relationship and dem still dey co-parent dia son. Beef for Nigerian entertainment industry Beef for Nigerian entertainment industry no be new tin. From music to movies, drama between celebrities don become almost as popular as di work dem dey produce. Weda na about ego, competition, betrayal, or just plain misunderstanding, beef dey always make headlines, and sometimes e dey even boost careers. For Nollywood, beef fit spark between actors, directors, producers, or even influencers. Many times, na ova who dey inside big role, who dey earn more endorsement deals, or who dey get more attention from di media. Oda times, na about personal issues wey dem bring into public space. E fit also be old friendship wey turn to enmity or comments wey pesin make for interview wey go di wrong way. Music is even dey more notorious. From di days of 2Baba vs Blackface, to more recent beef between new cats for di music industry, Nigerian entertainment industry don see im fair share of ego battles. But shey na all beef dey bad? Some pipo believe say e dey create healthy competition. Wen two top entertainers dey compete, dem dey often drop dia best work. Di fan and di industry benefit in dat manner. But beef fit lead to division as fans dey pick sides and engage in toxic trolling online.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store