Latest news with #NedNwoko


BBC News
5 days ago
- Entertainment
- BBC News
Who be Nigerian actress Angela Okorie wey dey di centre of Nollywood drama?
Celebrity life dey come wit fame, influence, money and constant public drama wey dey make dia life different from ordinary pesin. Nollywood actress Angela Okorie don dey di centre of di ongoing gbas-gbos between am, Mercy Johnson and Regina Daniels wey dey trend ontop social media. Angela recently make one post ontop social media say she don forgive Mercy Johnson, wey she bin get beef wit but Regina Daniel respond say "we no dey forgive for dis side". Na dis make Angela fire back. She verbally insult Regina Daniels claiming Regina marry her husband, Nigeria politician Ned Nwoko for money. Regina deny her claim and respond say na Angela dey beg her husband make im support am financially for her next project. Afta days of staying quiet, Mercy Johnson don tok say she go speak up for hersef and clear di air about di allegations against her. Who be Angela Okorie Angela Okorie na ogbonge musician and actress for Nollywood wey start her career as a model, bifor she break into stardom for 2009 wit her first feem 'Holy Serpent' and she don feature for several movies including 'Heart of a Widow' and 'Secret Code.' She don win several awards for di Nigeria movie industry. Angela win di 'Best Supporting Actress' category for di 2015 edition of di City People Entertainment Awards. Angela come from Enugu State, southeast Nigeria, but dem born am for Cotonou, Benin Republic, bifor she relocate to Nigeria wia she bin start to model for cosmetic brand for 2005 until she find her real passion wey be acting for 2009. Di actress get one pikin from her previous marriage wit Chukwuma Orizu. Di two dey togada for ten years bifor Angela announce her divorce ontop Instagram in 2015. She claim say her ex-husband no wan make she dey work as actress but di two still maintain dia relationship and dem still dey co-parent dia son. Beef for Nigerian entertainment industry Beef for Nigerian entertainment industry no be new tin. From music to movies, drama between celebrities don become almost as popular as di work dem dey produce. Weda na about ego, competition, betrayal, or just plain misunderstanding, beef dey always make headlines, and sometimes e dey even boost careers. For Nollywood, beef fit spark between actors, directors, producers, or even influencers. Many times, na ova who dey inside big role, who dey earn more endorsement deals, or who dey get more attention from di media. Oda times, na about personal issues wey dem bring into public space. E fit also be old friendship wey turn to enmity or comments wey pesin make for interview wey go di wrong way. Music is even dey more notorious. From di days of 2Baba vs Blackface, to more recent beef between new cats for di music industry, Nigerian entertainment industry don see im fair share of ego battles. But shey na all beef dey bad? Some pipo believe say e dey create healthy competition. Wen two top entertainers dey compete, dem dey often drop dia best work. Di fan and di industry benefit in dat manner. But beef fit lead to division as fans dey pick sides and engage in toxic trolling online.


BBC News
27-03-2025
- Entertainment
- BBC News
'Six years later, she still no fit resist me!' - Regina Daniels husband poem to her totori pipo
Nigerian Senator, Ned Nwoko write one 24 stanza poem wey e post for im social media handle, to celebrate im sixth year marriage anniversary wit im wife, actor, Regina Daniels. E also announce say dem dey expect dia third child. Oga Ned for di poem bin tok about di past years wey im and Regina don be togeda. E express im deep affection for her, describe dia union as one strong love wey don endure challenges and still dey stand. Di senator post dey come afta one recent tori bin go round about im and Regina marriage. For February, Regina bin comot Ned Nwoko name from her bio, deleting all pictures wia e show for her Instagram page. Dis one happun as tori bin dey fly around dat time say one Nollywood actress dey pregnant for oga Ned. Sometin wey di senator and di actress say no be true. Oga Ned tok about dia children and how Regina dey take care of dia two sons. E further address di rumours, di tori of crisis for dia marriage say no be true. "Dis morning, feeling bold, and true, I bin send you a message, out of di blue: 'Will you marry me?'. "Your laughter pour out like golden rays. 'Hahahahaha! Always! Di biggest YES!' Oh, my queen, you love me so truly. Make I gather di elders, pay di price? For you, I go do am all anew!" Part of di senator poem read. Senator Ned Nwoko also address pipo wey dey tok about dia expectations for im marriage, "dey whisper of love for measured tones, As if hearts dey caged, made of stone. But ours, Regina, dey fierce and wild, A dance of fire, God own child. "Some claim faith but live in disguise, Preach devotion wit wandering eyes. Yet here we stand, bare and true, no lies to hide, no games to rue. "A good man, monogamous or not, dey bring peace to di home, keep am hot. Better to love wit honesty bold, dan sell a dream wrapped in fool's gold." Bloggers dey always link Senator Ned Nwoko to news wey concern polygamy - di latest one na dis link to popular actress Chika Ike. For 2023 and 2024 tori bin fly again say im wan marry actress Chika Ike. Na dat tori wey start to spread again afta she post pregnancy fotos. Rumours by local tori pipo dey always wan link female entertainers to billionaire politicians or businessmen for Nigeria. Ned Nwoko na politician wey dey represent Delta North Senatorial District, na former House of Representatives member. Di politician recently defect from opposition party, di Peoples Democratic Party (PDP) to di All Progressives Congress (APC). For recent interview wit BBC Pidgin, Ned Nwoko wey tok say im focus na to work for im pipo explain say one of di reasons wey make am jump from PDP and APC na to get Anioma State wey im pipo don dey fight for since over 50 years. But for di recently proposed 'new states' wey di House of Representatives bin do, Anioma State no dey inside. Early, Ned Nwoko wife, Regina Daniels Nwoko, bin tok for one BBC Pidgin interview say, she and her husband and co-wives no get any issue at all. She also say she fit enta politics one day as she go continue to support her husband. Di mother of two, dey always hail her husband evritime for social media, but Nigeria begin tok say she no chook mouth for her husband defection and she also deactivate her Instagram account. Dis two tins na im follow make di tori wey dem tok say na fake new waka far.


BBC News
18-02-2025
- Entertainment
- BBC News
'I no be anybody seventh wife, no be Ned Nwoko get my belle' – Chika Ike clear rumour about her pregnancy
Nollywood actress Chika Ike don clear di air on di paternity of di belle wey she carry. Di actress for statement say no be Nigerian politican Ned Nwoko get di belle. Di 39-year-old actress tok say pipo no sabi anytin about her becos she dey "private" and Ned no be her pikin papa and polygamy no be for her. "Una fit come later wit your guessing games and like I don tok bifor. I no be anyone seventh wife! Polygamy no be for me," she tok for her Instagram page. "I don get belle for months now and no one even get clue about my pregnancy until I announce am and you all tink you go sabi, my pikin papa or anytin wey dey happun for my life? e dey very laughable and clueless!" She add say she no care about di rumour wey pipo don begin dey dig up becos of her career choice but she don come out to tok becos dis na about her pikin "My privacy na my peace and no one fit unsettle me. I dey happy becos of my pregnancy and na wetin matter to me now," she tok. "Dem don draw our attention to di recent false rumours wey dey allege say Senator Prince Ned Munir Nwoko dey plan to marry Nollywood actress Chika Ike as im seventh wife and say she dey pregnant (get belle) for him. "We categorically state say dis claims dey entirely baseless and na a product of malicious speculation," di Director of media tok for statement. E also react to tori wey bin fly upandan say di lawmaker bin chook mouth for di mata of Tuface. "Similarly, reports wey dey claim say im bin make statements about Tuface and polygamy dey completely untrue. " Di tok-tok pesin for di statement, explain say oga Ned Nwoko na public figure and as im wife Regina Daniel na actress, na normal tin for bloggers to use her to get attention, na why dem dey forge all dis tori dem. Im add say, Senator Nwoko wey currently dey on national assignment, dey focused to deliver im political mandate, and im no get time for distractions. "Dis office dey available to journalists for verification of information, and we dey remind media practitioners of di consequences of spreading fake news." Bloggers dey always link Senator Ned Nwoko to news wey concern polygamy - di latest one na dis link to popular actress Chika Ike. Some years ago tori bin fly say di lawmaker wey get six wives, wan marry teenage entertainers. For 2023 and 2024 tori bin fly again say im wan marry actress Chike Ike. Na dat tori wey start to spread again afta she post pregnancy fotos. Rumours by local tori pipo dey always wan link female entertainers to billionaire politicians or businessmen for Nigeria. E neva too tey wey BBNaija star Nengi Hampson name spread say she get belle for one govnor, but both she and di govnor tok say na lie. Who be Chika Ike Chika Ike na popular Nollywood actress, producer and businesswoman. According to her profile for social media, she be former model too. She study Human Kinetics and Health Education for di University Of Lagos, Nigeria. For 2014 she obtain a post graduate degree from di New York Film Academy in Los Angeles, California. She don feature for many movies and she don now get her own production company wey be Chika Ike Production. Ned Nwoko na politician wey dey represent Delta North Senatorial District, na former House of Representatives member. Di politician recently defect from opposition party, di Peoples Democratic Party (PDP) to di All Progressives Congress (APC). For recent interview wit BBC Pidgin Ned Nwoko wey tok say im focus na to work for im pipo explain say one of di reasons wey make am jump from PDP and APC na to get Anioma State wey im pipo don dey fight for since over 50 years. But for di recently proposed 'new states' wey di House of Representatives bin do, Anioma State no dey inside. Early, Ned Nwoko wife, Regina Daniels Nwoko, bin tok for one BBC Pidgin interview say, she and her husband and co -wives no get any issue at all. She also say dhe fit enta politics one day as she go kontinu to support her husband. Di mother of two, dey always hail her husband evritime for social media, but Nigeria begin tok say she no chook mouth for her husband defection and she also deactivate her Instagram account. Dis two tins na im follow make di tori wey dem tok say na fake new waka far.


BBC News
05-02-2025
- Politics
- BBC News
'PDP don scatta, dem don frustrate me'
Nigerian lawmaker wey dey represent Delta north senatorial district, don port from di Peoples Democratic Party (PDP) to di ruling All Progressives Congress (APC). Senator Ned Nwoko officially announce on di floor of di Senate on Wednesday 4 February during plenary say im don defect from di PDP to APC. Tori bin dey fly upandan recently say di Nigerian politician don comot from di major opposition parties for Nigeria. Oga Ned for dis exclusive interview wit BBC Pidgin confam say im don port true-true and im tok why im comot from PDP afta over twenty years. "Yes I don comot from APC, now I be a card carrying member of di APC and I don resign formally last week from PDP". "PDP dey in disarray, you dey see di fights for television, you dey see di crisis, we bin get hope say PDP go be a formidable (strong) opposition but no be wetin I experience for di last two years". Im explain say dis na di first time wey im dey for opposition goment and e no dey favour im pipo concerning projects wey suppose happun for di state wey go beta dia lives. According to am, di pipo wey vote am suppose benefit and one of di reasons wey im decide to make dis "sacrifice" na sake of di over fifty years agitation of im pipo to get dia own Anioma state. Im also tok say di leadership of di Peoples Democratic party don fail at evri level and di kasala wey dey for di party na wetin dem no go fit solve again. 'No opposition for Nigeria, PDP crisis no dey solvable' Senator Ned Nwoko tell BBC Pidgin say, "di hierarchy (leadership) of PDP no know wetin to do" sake of say, opposition no dey for Nigeria and e dey pain am well-well. Im tok say im do tok-tok (consultation) wit im pipo and im bin tink say to dey opposition wey dey vibrant, wey get di interest of di pipo for dia mind go help democracy grow for Nigeria, but no be so e be for di PDP. Di Peoples Democratic Party, na one of di oldest and strongest political party for Nigeria between 1999 to 2015 wen former President Goodluck Jonathan lose election to former President, Muhammadu Buhari. But since 2015, PDP dey struggle to reclaim power for di centre (federal level) but e neva work for dem. Tori about how di political party dey struggle and how dem dey try to settle kasala among demsefs both internally and externally dey enta news evritime. Na some of dis wahala dem wey di party dey face Senator Ned Nwoko tok say make "di problems for PDP no dey solvable" and na why im port. "Di pipo wey for help PDP settle dis crisis within PDP like Atiku Abubakar and odas don decide to comot from PDP to form a mega party, na wetin I sabi, so as dem dey comot from PDP, di kasala now go plenti becos now we go get two opposition parties wey no go fit really compete wit APC". Im add say di only way to get beta opposition for Nigeria na wen di new mega party wey di pipo wey wan break out from PDP wan form, join bodi wit di second opposition party. According to di Delta state politician, if di two political parties stand on dia own, e go make tins worse as e no go give dem chance to compete, and na wetin im dey avoid for im pipo. 'PDP no dey support di dream to create Anioma state' Anoda reason wey di popular businessman give na say im wan fight for di creation of Anioma state for di South East geopolitical zone. Im say Anioma state na wetin im wan achieve and if joining APC go help am achieve dis tin for im pipo, im ready to make di sacrifice. Im say since im begin push for di creation of Anioma state wey im describe as di state of equity, wey im pipo don dey agigate for since, im former political party, PDP no support am but na APC pipo dey support am. "Di creation of state na a veri difficult process I understand, but South East, Ndi-Igbo deserve one extra state, to make am six just like di oda zones except North West wey get seven. Most of my members dey look at di sixth state, wey dem dey call equity state, so dat di Igbos go get a sense of justice and belonging. "South South get six states, North Central six, North East six, South East five, and di young ones for South East dey fight for recognition and justice, dem dey fight becos dem dey marginalised." Ned say di injustice wey di South East dey face since di war don do, and as war time don pass, time don reach make dem get justice wit dis Anioma state creation. 'I no wan be Govnor of Delta State' Di Nigerian lawmaker tell BBC Pidgin say im no get any ambition to become di govnor of Delta State. Im say wen di time reach, im wit oda stakeholders for di state to sitdown do tok-tok about who go become di state govnor for 2027. Im add say young pipo dey wey dem fit choose from and im dey sure say APC go produce di next govnor of Delta State even though di state na one of di strongholds of PDP now. "Di pesin go sitdown wit us, we go tell di pesin say dis na di tins we need for Anioma, Delta North, Central and di South, we go sign agreement, we go get a projected performance for four years. If you agree we go sign am, if you no agree, we go look for anoda pesin wey go develop di pipo and di infrastructure and empower di pipo." Di former PDP lawmaker say no mata wetin happun in future, im go dey APC so far as e go benefit im pipo and im no go just dey for APC dey look pipo face. "I go be a key player for APC, I no go be observer or by-stander, so di tin wey suppose be for my pipo, dem must do am for my pipo" im add. On Tinubu policies and di future Concerning some of di policies wey di leadership of President Bola Tinubu don bring, oga Ned tok say even though e dey tough on di citizens of Nigeria for now, wit time, evritin go dey alright in future. "Di reforms on taxes dey pipo friendly, e go help small business and pipo wey no dey earn a particular amount of money." "I dey happy say di govnors from di north wey bin dey oppose am, no dey oppose am again becos dem don understand say, to get tax laws wey dey togeda under one document, is better, instead of having one million tax laws evriwia" Im add say, opportunity dey for anybody wey no dey happy wit di laws to go tribunal wey go deal wit am. Apart from di tax reforms and subsidy removal on petrol, oga Ned say oda areas dey wey President Tinubu go still touch wey go sweet im belle like di use of foreign currencies for Nigeria and di ban on importation of non essentials goods. Im say na dis tins dey spoil di economy for Nigeria and if goment stop am, di economy go grow. "Wen we stop to measure our naira wit Pounds and Dollars and we become self sufficient wit our local products, wen our economy good, evribody go benefit from am. Weda you rich or poor no dey important becos evribody go dey happy. But all of us must dey prepared to go through a period of planning, wen we do am, at least you go know say in di next five, ten years we dey try to get Nigeria to a level, make we tighten our belt but e must be across board, from local goment chairmen to govnors and di president." Im conclude.