logo
E dey legal for US to deport foreign criminals come Africa?

E dey legal for US to deport foreign criminals come Africa?

BBC News6 days ago
United States goment don turn Africa to dia new backyard wia dem dey deport migrants wey dem say be convicted criminals.
Even as dem don fly some of di migrants go kontris for Central and South America, dem bin send 12 men from kontris including Mexico, Myanmar and Yemen go Eswatini and South Sudan last month.
Dem bin also fly one South Sudan pesin go back home.
Di US goment dey also try convince some oda African kontris to accept pipo wey dia kontris no gree collect back, according to US authorities.
President Donald Trump mass deportation gada support during im campaign last year.
But UN human rights experts and human rights groups dey worry about wetin bin happun as dem argue say to carry migrants go kontris wey no be dia place of origin – wey dem dey call third kontri - fit dey against international law.
Third kontri deportation legal for international law?
Third-kontri deportations fit dey legal - but only for some kain conditions.
"Dis whole idea of third kontri removal dem dey see am as anoda kind of asylum," Prof Ray Brescia, from Albany Law School for US tok.
"E get principle for international law - wey dem dey call non-refoulement - e mean say you no suppose return pesin back to im kontri if e no dey safe for dem, so a third kontri fit be safe option for am," im tok.
Dis principle no only apply to di migrant home kontri but also to di kontri wey dem go wan send am go.
If dat kontri no safe, deportation fit dey against international law - like wen UK Supreme Court block British goment plan to send asylum seekers go Rwanda for 2023.
Due process also dey necessary.
Migrants gatz get chance to challenge deportation if di destination dey dangerous, based on evidence from credible sources like UN reports or US State Department findings.
Courts dey expected to assess dis risk carefully.
"Di court gatz torchlight di kain legal status wey migrants go get, if dem go detain dem, which kain house dem wan give dem," Dr Alice Edwards, UN Special Rapporteur on Torture and oda Cruel, Inhuman or Degrading Treatment or Punishment, tok.
But many migrants dey struggle to get access to legal support on time.
"E dey take serious effort and access to lawyer wey fit act sharpaly," Prof Brescia tok.
"Dat kain legal waka no dey available to evrione."
Eswatini and South Sudan deportations dey against international law?
"For sure dem dey, in two ways," Prof David Super, from Georgetown University Law Centre, tok.
"E no get evidence say US dey give pipo chance to challenge dia deportation, and dem no get permission to send pipo go kontris wia dem fit face oppression."
"South Sudan and Eswatini get serious questions about dia human rights records," im tell BBC.
Wen dem bin first bundle migrants go South Sudan for May, e get one legal challenge wey dem carry go one US district court afta di flight don already take off.
Di judge bin rule say attempt to deport di men dey against order wey im bin give say dem gatz allow migrants to challenge di decision to carry dem go anoda kontri.
Dem later divert dat plane go Djibouti, for East Africa, wia dem bin lock di men inside one shipping container for one US military base as court dey hear di case.
Dem refer di case to Supreme Court wey allow di deportations to continue, but no tok weda dem see South Sudan as safe place for di migrants.
"Wetin we don see for similar cases be say dem dey mostly deny pipo legal help wen dem need am, and di case dey start wen tins don already cast," Dr Edwards tok.
"For dis case, dem don already dey road dey go US military base and dat na deep wahala."
She add say court gatz remove hands from politics, especially wen e concern basic rights.
Prof Brescia warn say di Supreme Court decision fit set dangerous precedent.
"Di real concern be say e go encourage di goment to move even faster, bifor pipo go fit go courts at all," im tok.
Eswatini and South Sudan safe?
In addition to di process wey dey deny dem, dem dey potentially send di migrants go kontri wey no safe - breaking international law.
Di US State Department dey currently advise pipo make dem no travel go South Sudan sake of threats including crime, armed conflict and kidnapping.
Earlier dis year, tori be say di kontri wey be one of di poorest for world, almost return to civil war.
"E get some real concern about law and order for South Sudan - about violence, instability, and ongoing conflict," Dr Edwards tok.
Tori be say di pipo wey dem deport go South Sudan dem detain dem for one facility for di capital, Juba, wey dem sabi say e dey for poor conditions, according to political activist, Agel Rich Machar.
Di goment neva still confam dia location or how long dem go spend for detention.
For Eswatini, wey be one small landlocked kingdom for southern Africa, officials say di migrants dey for one prison and dem go repatriate dem wit support from International Organization of Migration (IOM).
Di US State Department say Eswatini prisons dey face problems of overcrowding, poor ventilation, and beta food and health services no dey.
"We no dey see am say dem go stay dia long enough to become part of di society," Eswatini goment tok-tok pesin Thabile Mdluli tell BBC, witout giving any any sign of how long dem go stay for di kontri, or weda dem go serve di rest of dia sentences first.
Di US goment say di pipo wey dem deport go Eswatini commit "barbaric" crimes including child rape, murder and sexual assault.
Eswatini pipo don dey begin para..
Di kontri biggest opposition party, di People United Democratic Movement (Pudemo) say di agreement between di two kontris na "human trafficking wey dem disguise as deportation deal".
Pro-democracy activist Lucky Lukhele say make di kontri no become "dumping ground for criminals".
Even if dem don break international law, Prof Super say di US fit no face di consequences as dem no recognise many international courts.
"Dis be like say na about deterrence, unto say dem dey send message say if you come US dem go treat you collect veri, veri harshly," im tok.
Even witout all di legal palava, third kontri deportation dey put pipo wey already dey vulnerable for unfamiliar environments wit small support or legal status, Dr Edwards tok.
"Na veri yeye idea."
She stress say human rights community no dey try to block each and evri deportation - na only wia pipo dey face human rights violations.
Wetin dey inside for di host kontris?
Di koko informate inside di deportation deals na big secret.
Ms Mdluli tell BBC say Eswatini reasons for accepting di deportees "go remain classified information for now".
However, both di Eswatini and South Sudan goments say na dia strong ties wit US be key motivation.
Prof Brescia dey suggest say some kontris dey fear say US fit revenge if dem refuse, like stricter visa rules or higher tariffs.
For April, US say e go revoke all visas wey dem give to South Sudan kontri pipo afta dem refuse to accept one deported citizen.
E no clear if dat one don change now wey dem don gree accept deportees from US.
Political activist Machar say South Sudan don also agree to dis deal as dem want make US lift sanctions on Vice-President Benjamin Bol Mel.
US goment issue sanctions against Bol Mel for 2021 sake of alleged corruption and dem renew am dis year.
However, oda kontris, like Nigeria neva gree.
"We get enough problems of our own," Nigerian Foreign Minister Yusuf Tuggar tok for July, as dem reject request to accept detainees from Venezuela.
Dr Edwards add say dat kain deals dey always come wit some beta, we go jinja di kontris.
"For past arrangements of third-kontri deportations, large sums of money, military and security cooperation, na part of di package," she tok.
For March, tori be say Trump goment say dem go pay El Salvador $6m (£4.5m) to accept Venezuelan deportees.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Only 1.5% of Gaza cropland left for starving Palestinians due to Israel's war, UN says
Only 1.5% of Gaza cropland left for starving Palestinians due to Israel's war, UN says

The Guardian

timean hour ago

  • The Guardian

Only 1.5% of Gaza cropland left for starving Palestinians due to Israel's war, UN says

Israel's destruction of Gaza has left starving Palestinians with access to only 1.5% of cropland that is accessible and suitable for cultivation, according to new figures from the UN. This is down from 4% in April, according to the Food and Agriculture Organization (FAO), suggesting Israel has continued to target Palestinian farmland since initiating a complete blockade in early March, severely restricting aid from entering the Gaza Strip, where 2 million starved people are trapped. Before the conflict, Gaza was a thriving agricultural hub, where farmers and ordinary Palestinians cultivated a wide variety of fruits, vegetables, nuts and grains for local consumption. According to the FAO, agriculture accounted for around 10% of the Gaza Strip's economy, and more than 560,000 people, or a quarter of the population, were at least partially supported by agriculture and fishing. Israel has targeted food sources – orchards, greenhouses, farmland and fishers – since the beginning of its siege on Gaza in October 2023. By 28 July 2025, Israel had damaged 86%, the equivalent of almost 13,000 hectares (32,000 acres), of farmland in the Gaza Strip – up from 81% in April, the FAO said. While just under 9% of cropland is still physically accessible, only 1.5% – the equivalent of 232 hectares – is both accessible and not damaged by the Israeli offensive. 'Gaza is now on the brink of a full-scale famine. People are starving not because food is unavailable, but because access is blocked, local agrifood systems have collapsed, and families can no longer sustain even the most basic livelihoods,' said FAO director-general Qu Dongyu. 'We urgently need safe and sustained humanitarian access and immediate support to restore local food production and livelihoods – this is the only way to prevent further loss of life. The right to food is a basic human right.' In northern Gaza, Israeli tanks and bombs have destroyed or damaged 94% of what was among the most fertile, productive land in the territory, and Palestinians have no access to the remaining 6% of their cropland. In Rafah, near the Egypt border, 79% is flattened and the rest has been blocked as part of Israel's so-called military corridor. Last week, Israeli forces partially demolished a seed bank in Hebron, in the West Bank, destroying tools and equipments used to used to reproduce heirloom seeds. UN experts, agencies and aid groups have been warning since early 2024 that Israel is orchestrating a campaign of deliberate mass starvation in Gaza by systematically destroying local food production and blocking aid, in violation of international law. Hundreds of Palestinians have now starved to death, and thousands more have been killed trying to access food aid. Earlier this week, Michael Fakhri, the UN special rapporteur on the right to food, told the Guardian: 'Israel has built the most efficient starvation machine you can imagine. So while it's always shocking to see people being starved, no one should act surprised. All the information has been out in the open since early 2024.'

Afghanistan's Taliban have 'weaponized' the judicial system to oppress women, UN expert says
Afghanistan's Taliban have 'weaponized' the judicial system to oppress women, UN expert says

The Independent

time3 hours ago

  • The Independent

Afghanistan's Taliban have 'weaponized' the judicial system to oppress women, UN expert says

Afghanistan's Taliban rulers have 'weaponized' the legal and judicial system to oppress women and girls in what amounts to 'crimes against humanity,' the independent U.N. investigator on human rights in the country said. Richard Bennett said in a report to the U.N. General Assembly circulated Wednesday that after seizing power in 2021 the Taliban suspended the 2004 constitution and laws protecting the rights of women and girls. These include a landmark law that criminalized 22 forms of violence against women, including rape and child and forced marriage. The Taliban dismissed all judges under the previous U.S.-backed government, including approximately 270 women, replacing them with men who share their extreme Islamic views, lack legal training and hand down decisions based on edicts issued by the Taliban, he said. In addition, he noted that the Taliban have assumed full control over law enforcement and investigative agencies, systematically purging Afghans who worked for the previous government. Bennett, who was appointed by the Geneva-based U.N. Human Rights Council, focused on access to justice and protection for women and girls in his report. He said he held meetings, focus-group discussions and one-on-one interviews with more that 110 Afghans inside and outside the country. He did so remotely because the Taliban have refused to grant him a visa to travel to Afghanistan. Since the Taliban took control of Afghanistan, their crackdown on women and girls has been widely reported and globally denounced. Taliban leaders have barred education for women and girls beyond sixth grade, banned most employment, and prohibited women from many public spaces, including parks, gyms and hairdressers. New laws ban women's voices and bare faces outside the home. The Taliban remain isolated from the West because of their restrictions on women and girls and have only been recognized by Russia. Bennett said the Taliban did not respond to an advance copy of the report and a request for information about their efforts to ensure access to justice and protection for women and girls. The Taliban defend their approach to justice by claiming they are implementing Islamic sharia law, but Islamic scholars and others have said their interpretation is unparalleled in other Muslim-majority countries and does not adhere to Islamic teachings. They say protecting the legal rights of women is a priority. Bennett said, however, that women have virtually no rights. 'Today, there are no women judges or prosecutors and no officially registered female lawyers, leaving women and girls with fewer safe channels to report abuse or seek redress,' he wrote. 'Coupled with a lack of female officials in the police and other institutions, the result is widespread underreporting of violence and discrimination against women and girls.' Bennett said access to justice for girls 'is further undermined by the dismantling of key legal safeguards and institutions protecting the rights of children,' including juvenile courts and juvenile rehabilitation centers. The Taliban requirement that a woman must be accompanied by a male relative also creates barriers to filing complaints and attending court proceedings, he said, and disproportionately affects widows, women who are the heads of their households, the displaced and disabled. 'Women who engage with the Taliban court system — whether as victims seeking redress, to resolve family issues, to obtain official documents or as alleged offenders — face a hostile environment,' Bennett said. ' Courts often reject complaints made by women and are especially reluctant to accept cases relating to divorce, child custody and gender-based violence.' Facing these obstacles, Bennett said, women increasingly turn to traditional and informal justice mechanisms, including formal jirgas and shuras — community councils of elders — and informal mediation by religious leaders, community elders or family. But these are all male-dominated and raise 'serious concerns about the rights of women and girls,' he said. He said international forums offer the best hope for justice. He pointed to the International Criminal Court's request on Jan. 23 for arrest warrants for two senior Taliban leaders accused of crimes against humanity for persecution 'on gender grounds.' And he urged all countries to support efforts to bring Afghanistan before the International Court of Justice, the U.N.'s highest tribunal, for violating the Convention on the Elimination of All Forms of Discrimination against Women.

Stanford student newspaper sues Trump administration for alleged free speech violations
Stanford student newspaper sues Trump administration for alleged free speech violations

Reuters

time3 hours ago

  • Reuters

Stanford student newspaper sues Trump administration for alleged free speech violations

Aug 6 (Reuters) - Stanford University's student newspaper sued the Trump Administration on Wednesday, arguing it has violated the free-speech rights of foreign students by threatening to deport them for writing stories that it considers "anti-American or anti-Israel." The Stanford Daily and two unidentified students said in the lawsuit, opens new tab, filed in federal court in California against Secretary of State Marco Rubio and Secretary of Homeland Security Kristi Noem, that foreign students at the Palo Alto, California, school have refused to write about the conflict in the Middle East for fear they could be arrested, detained and deported. "This pall of fear is incompatible with American liberty," the lawsuit said. "Our First Amendment stands as a bulwark against the government infringing the inalienable human right to think and speak for yourself." Spokespeople for the White House did not immediately respond to a request for comment. "In the United States of America, no one should fear a midnight knock on the door for voicing the wrong opinion,' Stanford Daily attorney Conor Fitzpatrick said in a statement. A spokesperson for Stanford University said the newspaper is an independent organization and that the school is not part of the lawsuit. The Trump administration has attempted to deport students who have expressed pro-Palestinian views, calling them antisemitic and extremist sympathizers whose presence in the country was adverse to U.S. foreign policy. Protesters say that the government wrongly conflates their criticism of Israeli actions in Gaza and advocacy for Palestinian rights with antisemitism and extremism. Judges have ordered the release of some students who the administration arrested and detained without being charged with a crime. The Stanford Daily said in its lawsuit that the administration has caused its foreign writers to self-censor to avoid being targeted. It argued that the administration's threats prevent them from "engaging in protected expression like attending protests, using certain slogans, and publicly voicing their true views about American foreign policy, Israel, and Palestine." The newspaper asked the court to rule that the U.S. Constitution prevents the government from deporting non-citizens for engaging in free speech.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store