
'Nigerians get freedom of movement within di kontri' - Nigerians tell Edo state govnor Okpebholo
Inside di trending video, di Edo state govnor say make Obi no come di state without telling him, as im security no dey guaranteed.
"I dey send direct message to am, new sheriff dey for town, e no fit come Edo make e no tell me, becos im security no go ever dey guaranteed. Whatever happun to am wen e dey Edo state, e go take am."
Govnor Okpebholo also allege say di last time di former Anambra state govnor visit Edo state wen e donate 15 million naira to one nursing school, crisis happun afta e comot, wey lead to di death of three pipo. BBC Pidgin don reach out to di state police command to verify dis claim, but dem neva reply yet.
Di govnor sama dis warning on Friday, 18 July for Uromi, Esan Northeast Local Government Area wen e dey receive some politicians wey decamp from di opposition Peoples Democratic Party (PDP) to di ruling All Progressives Congress (APC).
Oga Peter Obi neva react to di comment wey govnor Okpebholo make.
For 8 July, Peter Obi bin tweet on X about im visit to Philomena College of Nursing Sciences for Benin City, Edo State, wia e donate 15 million naira give dem to improve healthcare delivery.
'Obi na citizen wey get freedom of movement'
However, plenty Nigerians wey include di PeterObi Obidient Media Centre don react to di govnor statement.
For statement wey dem post on X, di Obidient Media Centre disagree wit wetin di Edo state govnor tok, as dem say Nigeria constitution guarantee di right of every Nigerian citizen to move freely and reside in any part of di kontri.
Dem say dis no be di first time dis dey happun, as di govnor of Benue state bin issue similar threat against dia principal wen e visit di state for goodwill and charity.
Di statement add say make Nigerians no see dis threat as small mata, as Nigeria belong to everybody, and no individual, no matter how highly placed, suppose try divide di kontri by inciting violence or wit dia words.
"We wish to alert Nigerians plus di international community say make dem no take dis threats lightly. If anytin untoward happun to im Excellency Peter Obi, make Nigerians know wia to look. Dis governors na di chief security officers of dia respective states, and dia utterances carry weight – no be just in words, but in potential consequences."
Di Interim tok-tok pesin for Africa Democratic Congress (ADC), Bolaji Abdullahi for im reaction say Peter Obi na free citizen and e no need di govnor clearance to visit Nigerians for dia own kontri.
"Edo State na Nigerian State. Di govnor statement betray deep insecurity. Wen a Governor begin panic ova courtesy visits and modest donations, na clear sign say sometin dey deeply wrong somewhere.
"Leaders wey don serve di pipo well no dey bother wen odas receive clap. Perhaps, di pipo wey dey celebrate PO simply dey remind di Edo state govnor di kind of leader e suppose be," Oga Abdullahi tok.
Labour Party govnorship candidate for di 2024 election, Olumide Apata say, "Peter Obi no need anyone permission to visit Edo State or any oda State for dat matter. Not now, not ever."
Di Edo state govnor comments dey come as reports say di Kaduna state police command don stop one rally wey supporters of Peter Obi dey plan in honour of im birthday for di state, as dem cite security concerns.
For one statement on Saturday, 19 July, di police tok-tok pesin Mansir Hassan tok say di rally dey happun di same day one primary elections dey hold for di state, and e fit lead to gbasgbos and break down of law and order.
"Intelligence information wey di command receive na say certain criminal elements dey plan to intrude and hijack di proposed rally, and use am as platform to cause disruption, incite violence, and disturb the prevailing public peace for di state."
Di police warn say e go take necessary legal action against any individual or group wey violate di directive.
Oda times state govnors don stop politicians from coming to dia state
Dis no be di first time a state govnor go kick against di visit of a politician to a state without security clearance from di govnor.
For April, di Kogi state goment bin ban rallies and public gatherings for di state, ahead of di homecoming ceremony of di suspended senator wey dey represent Kogi north-central Natasha Akpoti-Uduaghan to her constituency.
Di state goment bin cite security breach as dem say di intelligence reports wey dem receive show say some pipo dey plan to "stage some violent rallies in di guise of political and religious agitations" for Kogi Central.
Di commissioner of Information Kingsley Fanwo add say di state goment don direct say anybody wey wan enta di state wit convoy of security personnel must "obtain prior clearance from state commands of di deploying services.
Benue state goment for April also say any high profile pesin wey wan visit di state must get clearance from di govnor, Hyacinth Alia.
For one statement wey di Chief Press Secretary, Tersoo Kula, bin issue at di time, e say, "For anyone wey dey consider to visit Benue State without di knowledge or approval of di govnor, e dey important to reconsider, as dia safety and security no fit dey assured,"
Di statement further direct di individuals or organisations wey dey plan to visit Internally Displaced Persons (IDP) camps must obtain written clearance from di Benue State Emergency Management Agency (BSEMA).
Although, di goment no mention names for di statement, but di directive bin draw immediate criticism from many wey believe say di target na di Labour Party 2023 presidential candidate, Peter Obi, wey bin dey plan humanitarian visit to IDP camps for di state.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
3 hours ago
- BBC News
Planned Rivers state local government election na sign of return to democratic rule?
After more dan two years of political crisis for di oil rich State for Southern Nigeria, Rivers State political landscape don begin stabilize wit di local goment elections wey dem reschedule. Dis na as di Rivers State Independent Electoral Commission (RSIEC) release a revised timetable for di election. Dis one na sign to show say dem wan restore democratic governance for di State. RSIEC officials meet wit "critical stakeholders" wey include leaders of political parties, traditional rulers, security agencies, civil society groups, religious leaders, academics, and media pipo on Monday to finalize preparations for di local goment elections. Na di newly appointed RSIEC Chairman, Dr Michael Ekpali Odey, call di meeting. Na for dia e conclude wit di announcement say elections into di 319 wards and 23 local goment councils go now hold on 30 August 2025, wey be 21 days later dan di original date of August 9 wey di former RSIEC Chairman, Justice Adolphus Enebeli Rtd bin announce. According to di new timetable, political parties dey expected to express interest in di elections between July 28 and 30, while party primaries for chairmanship and councillorship positions suppose hold on 2 August 2025. Campaigns go start on 20 August 2025, ahead of di 30 August election day. How Political parties react to di new LGA Council election date? Different political parties react differently to di announcement by RSIEC as some dey ready to cooperate and work wit di new timetable while odas say dem no go participate. Dem say na sake of some legal issues wey surround recent developments, even as odas say dem go review di situation and take a decision later. For di Peoples Democratic Party PDP, di State Chairman Aaron Chukwuemeka say di party dey ready to swing into action to conduct primaries wey go produce candidates for di election. While for di APC, di Tony Okocha led faction dey ready for di polls, but di one led by Emeka Beke say dem no go follow for dis illegal exercise. But tok tok pesin for Rivers APC, Darlington Nwauju tell BBC Pidgin say, "dis na a continuation of di illegality wey don dey happen for Rivers State and we no go be a party to continue am." "If Inec wey be di baba of election for di kontri say sake of di emergency rule wey dey Rivers State, dem no go fit conduct bye elections for Khana Constituency 2 for di Rivers State House of Assembly, [wey di member wey bin dey represent am, Dinebari Loolo die for 2023], den on wat grounds wey RSIEC dey stand to conduct local goment elections for di State? "So we as APC no go participate for dat kain illegality." E tok. For di Action Peoples Party (APP) wey bin win 22 of di 23 LG seat for di last local council elections wey di Supreme Court nullify, di coming elections dey pose some serious legal kwesions wey dem dey ready to ask both di Commission and di law courts. Dis na becos di legal adviser of Action Peoples Party APP, Henry Ekine observe say di chairman of RSIEC bin don justify di postponement of di local goment election from 9 August sake of di State of emergency wey dey Rivers State. "So di fundamental kwesion now na if di situation wey Rivers State dey today, dat is di State of emergency, na di reason to postpone di election from 9 August, dem mean say by if by di 30th of August 2025 di State of emergency still dey dem go postpone di election again?" How di mata reach dis point? Di rescheduling of di Rivers Local Goment elections dey follow di Supreme Court ruling on February 28, 2025, wey nullify di October 5, 2024, council elections wey govnor Siminialayi Fubara bin conduct, citing violations of di 2022 Electoral Act. Di Supreme court rule say di process, wey di former RSIEC Chairman Justice Adolphus Enebeli Rtd carry out, bin dey wrong and lack legal basis. E also bar di Independent National Electoral Commission (INEC) from releasing dia voters register to RSIEC at di time. Although di Court of Appeal bin don overturn di lower court decision, di All Progressives Congress (APC) pursue di matter to di Supreme Court, wey uphold di original judgment. Dis ruling effectively dissolve all 23 local councils. Following dis judgement, govnor Fubara say e go abide by di decision of di Supreme Court and call all di former local goment chairmen wey bin dey under di Action Peoples Party APP to step aside and handover to do Head of Local Government Administration. Sake of di political crisis wey bin dey di State, President Bola Ahmed Tinubu declare a state of emergency in Rivers State on 18 March 18, 2025, for an initial six months. E suspend di elected govnor, deputy govnor Prof Ngozi Odu, and di House of Assembly and den appoint Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas Rtd as Sole Administrator to manage di State during di emergency period. Now di e don reach di fifth month, as di emergency rule dey expected to expire on September 18, 2025. As part of di transition back to democratic governance, Ibas dey oversee preparations for di local elections, even though many pesins dey challenge di Rivers State emergency rule for both federal and State High Courts. Controversy around di RSIEC chairman Di appointment of Dr Michael Odey, a retired INEC official as di RSIEC Chairman bin spark some controversy. Dis na becos particular Dr Odey no be Rivers prsin, e come from Cross River and e come without any consultation wit di suspended state leadership. However, after a conciliatory visit to di National Assembly, tensions reduce and di National Assembly approve im appointment. For di meeting on Monday, Dr Odey assure all political stakeholders and di pipo of Rivers State say di commission go deliver a free, fair, peaceful, and credible local goment elections. As di countdown now officially dey on, di coming weeks go dey critical to determine how fast Rivers State fit return to democratic normalcy after months of federal intervention and emergency rule.


BBC News
3 hours ago
- BBC News
Nigeria Wafcon: Victorious players promised $100,000 cash award and apartment
Nigerian President Bola Tinubu hailed the women's national football team for their victory at the 2024 Women's Africa Cup of Nations (Wafcon) at a grand celebratory reception where he promised them gifts and cash them at Aso Rock, the presidential residence, on Monday, Tinubu announced each player would get a $100,000 (£75,000) plus a three-bedroom 24-woman squad cheered when they heard the news, but there have been criticism in the past that prizes promised by Nigerian governments have not Super Falcons - as the team is known - defeated hosts Morocco 3-2 on Saturday in a stunning second-half comeback, clinching their 10th Wafcon title. Tinubu said the victory was a "triumph of courage, determination and consistency" adding that at some point "didn't want to watch the match" because of the stress."Today, you returned home as champions of Africa," he said. "We could not be prouder."On their arrival at the main airport in the capital, Abuja, the team had been welcomed by traditional dancers, drummers, journalists and government officials. They were then escorted to the presidential residence in a conferred national honours, the Officer of the Order of the Niger, to all the players and staff, saying this was "on behalf of a grateful nation".Captain Rasheedat Ajibade said that her team's victory was for "every young girl in our villages, towns and cities who dares to dream".She also outlined her vision for the Super Falcons to become the best team in the world but said this can only happen with continued support from the football federation and Super Falcons have won 10 of the 13 editions of Wafcon since it began in1998. The president described the latest win as a "milestone in the history of sport".While the players celebrated the extra gifts from the president, in the past, both the men's and women's national football teams in Nigeria have had repeated issues with the authorities over delayed payment of bonuses and government has only just honoured its three-decade promise of new homes for the victorious men's team, the Super Eagles, which won the 1994 Africa Cup of Super Falcons have several times been involved in sit-in protests during major tournaments over pay issues, including after their 2023 Women's World Cup has also been concerns over pay disparities, and in recent years, fans have called for them to be paid the same as the Supee of their final match on Saturday, Tinubu reportedly approved players' match allowances and bonuses, including backdated payments, adding that this would the standard practice in the future. You may also be interested in: What we learned from Women's Africa Cup of Nations 2024Wafcon winner will stay in my heart forever - EcheginiWatch: The Wafcon star who is also a doctor Go to for more news from the African us on Twitter @BBCAfrica, on Facebook at BBC Africa or on Instagram at bbcafrica


BBC News
3 hours ago
- BBC News
You fit sell your NIN?
Di National Identity Management Commission don comot statement afta di tori say some pipo dey sell dia National Identification Number (NIN) among oda personal information give FInTech companies. For di statement, NIMC draw ear give Nigerians say dem no get hand for anytin wey spoil bicos of dis exchange of personal informate. Dem remind kontri pipo say dem don warn dem plenti times say make dem no tell dia NIN give any unauthorized pesin or joinbodi. All dis infromate for dia statement come afta Nigeria anti-corruption body drop informate on one "fraud scheme wey na young Nigerians dey carry am for head, dey carry small money between 1500 and 2000 naira ($1.31) give dia victims wey go give dem copy of dia personal information details bifor dem come carry di same informate give some FinTech companies dem for like 5000 naira ($3.27)". NIMC say di mata na serious security concern and also get ogbonge consequences for di NIN holders. But pesin fit carry dia full Idenitiy number sell give anoda pesin just like dat? NIMC ansa dat kwesion for di statement wey di Head of Corporate Communications, Dr Kayode Adegoke share wit tori pipo. Dem tok say anytime pesin present di NIN to fit get access to services, di NIN go dey "duly verified" bifor dem go allow any pesin make e use am. Dem dey use NIN match pesin wit dia biometric data and oda details wey dey di National Identity Databases. E also dey used to: Wetin dey linked wit your NIN Accoridng to NIMC, di National Identification Number dey link to pesin biometrics wit any oda informate wey dey di national database. But e dey also linked wit oda tins. For December 2020, di Nigerian Communications Commission [NCC] announce di compulsory update of NIN to dia SIM registration to fit improve di integrity and transparency of di process for Nigeria For 1 December 2023, di CBN bin announce to all Nigerians for one statement wey dem release give all banks say any bank accounts wey no get both NIN and BVN no go fit withdraw money for dia account. Sabi pipo say na to make am easier to monitor transactions and detect fraud. Tori dey say, two years ago FCT Minister Nyesom WIke make am compulsory say any pesin wey wan register C of O for dia property must to run am wit dia NIN and BVN togeda. According to di 2017 Mandatory Use of di NIN regulations, all transactions wey involve di purchase use or transfer of land or landed properties fall inside. Di NIN also get Biometic data of pesin dat one include pesin face and fingerprint information.