
Who be Ezeani wey Nigerian authorities gbab for accuse say e bury pipo alive for Enugu
Dem catch di man wey many dey refer to as native doctor for di border between Nigeria and Benin Republic as e bin wan run comot from di kontri, according to one statement by di NIS tok-tok pesin AS Akinlabi.
Di NIS say na during one stop and search operation for di Gbaji checkpoint for Seme border, by security forces including di Nigeria police, na dia dem gbab di suspect as e dey on top bike wan cross over.
"We confam im identity using one National Identity Management Commission slip wey we find for im possession, and during interrogation," di statement tok.
Di tori of dis suspected ritualist na wetin don dey trend for social media for days now as many Nigerians express shock and anger for videos wey dey circulate wey show say dem bury pipo for inside im compound for Enugu State.
Nwaobu don deny all di accusations - e say na set up.
How evritin take start
Tori about dis suspected ritualist Onyeka Nwaobu break wen one small girl allegedly escape from im hand afta di man and im gang bin allegedly kidnap her.
Dis event according to wetin local pipo tell BBC tori pesin, happun on Monday, 26 May, 2025, for Umumba Ndiagu village, Ezeagu local goment area of Enugu State.
For one video wey don go viral on social media, di girl tok say she and her father bin go to dia farm to fetch firewood, wen di men approach dem and beg her father to help dem wit dia motorcycle wey spoil.
Dem later overpower her papa bifor dem carry her run, tie her mouth and legs.
"Dem put me for one hole for di ground and cover am wit leaves, but as I continue to dey make sound, e attract some vigilante pipo wey dey pass and dem come rescue me," di girl tok for di video.
Afta dis rescue, villagers gada for di native doctor house wit vex and set am on fire, by den di man imsef - wey im native doctor name na Ozor Ezeani - don run.
One man Ambrose Obieze, wey dey live for Umumba village tell BBC Igbo say dem see plenty ditches for di man house wia e allegedly bury pipo for inside.
Videos and pictures of inside di compound of di native doctor, and di plenty juju materials wey di villagers see wen dem go dia, don go viral on top plenty social media platforms.
Enugu State goment and police act
Govnor Peter Mba of Enugu State order di demolition of di house of di suspected ritualist, and goment bulldozers don already level di man entire compound.
Several states for di southeast region get law say any property belonging to a kidnapper, goment go destroy am and seize di land.
Also, di Enugu State police command don chook mouth for di matter, as di Commissioner of Police, Mamman Bitrus Giwa, hail di Neighbourhood Watch vigilante pipo wey rescue di kidnapped little girl and also capture three of di suspects wey bin kidnap her.
Tok-tok pesin for di police, Daniel Ndukwe, give di names of di arrested suspects and confam say dem discover di decomposing corpses of one man and one woman for di ditches wey di native doctor dig for im house.
Wetin relatives and locals tok
One family member of di suspect tell BBC say dia brother bin come back from Togo wia e bin dey, and e no tey, e start to dey build house.
"We bin tink say e don make money, but we no know say e carry juju come back wey dey demand human head," e tok.
"Wetin we know be say im na native doctor and e dey usually shoot local canon for midnight. We no know say e dey kill pipo."
Another villager also tell BBC tori pesin say di suspect na "veri bad and strong juju" e dey do.
Di villager allege say di land wia di suspect dey build im house currently na land wey e allegedly collect by force from one woman wey im husband die.
Nwaobu say di allegations no be true and add say e no be native doctor. E say na okrika e dey sell.
Who be Onyeka Nwobu?
According to wetin local pipo tell BBC, di suspect Onyeka Nwobu, na ogbonge native doctor wey pipo dey fear well-well for di area.
Im native doctor name na Ozor Ezeani but e also get nickname 'ichie million' wey mean 'chief of millions'. Dis name na sake of how e dey usually spray money for events and ceremonies for di village.
E bin dey stay for Togo bifor e come back village and tok say im na traditionalist now.
Ikechukwu Chime wey be priest of di Anglican Church for di village, tell BBC say di man follow for di youths wey come back home wit di disguise say dem wan return to di tradition and religion of dia ancestors, "but now e don clear us say na blood dem dey drink".
A history of ritual killings
Ritual killing to make money no be new tori for Nigeria, a kontri wey get large youth population, but wia unemployment and poverty rate dey veri high.
For March dis year, di Rivers State Police Command, for di south-south region, arrest one native doctor and im accomplice wey allegedly kill two seven-year old girls from di same family for ritual purpose.
Also, for January 2023, Police for Ogun State arrest one herbalist and five odas wey allegedly kidnap, kill and sell body parts of one 26 years old woman for Ijebu Ode area of di state.
For March of di same 2023, one magistrate court for Ekiti State remand three pipo for prison sake of alleged kidnapping and killing of one 82-year-old man, Michael Obasuyi, for ritual purposes.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
18 hours ago
- BBC News
Wetin dey do Third Mainland Bridge and how much govment say di repair go cost
Nigerians still dey wonder how govment wan spend 3.6 trillion naira to repair 3rd Mainland Bridge. Minister of Works for Nigeria, David Umahi, tok say Third Mainland Bridge go chop at least 3.6 trillion naira to repair am. Dis na sake of di problems wey di bridge don get from di structures wey dey underwater. David Umahi tok say sake of di urgency of di mata , im carry waka go di recent Federal Executive Council [FEC] wey President Bola Tinubu lead for Aso, Rock. Di FEC approve a total of N493 billion for two ogbonge projects. Di projects na to buoild new Carter Bridge for N359 billion and to upgrade di Kano-Katsina bridge to 152 kilometres for N134 billion. For Third Mainland Bridge for Lagos, South-West Nigeria, oga Uma tok say dem no go fit repair am sake of structural damage. Im add say di price to repair am cost well-well. Why Carter Bridge go chop N359 billion Di Minister of works tok say for 2019 dem bin do one study to show wetin dey happun under di water of Third Mainland bridge and di Carter bridge. Di pipo wey bin do di study discover say plenti problems dey. Dem bin install di pires [columns]in a technical term of skin friction becos dem no go fit discover rock. Skin friction na method we dem dey use secure di pires and under di aggregate of di pires na dia di pire cap dey, so dem discover say dis pires wey sand dey hold don wash away sake of illegal minning of sand and ocean current. Im explain say for 2019, dem do anoda study and dem discover say di pires don spoil well-well, some dey rust due to chlorine wey dey inside di water and dem dey lose sand well-well. Im tok say na President Bola Tinubu bin give directive make dem chook eyes for how dem go take repair di Third Mainland bridge. Umahi say dem don resurface am by 11.8 kilometres by 16 lanes. Im add say dem also chook eye for wetin dey happun under di deck above di water. "We bin give di contract to Julius Berger, Ido bridge, Carter bridge and Third Mainland bridge at a contract sum of 65 billion and dia job na to repair all di pires wey don rust, dem go also chook eye for di pire caps kon treat am sake of say dem dey exposed and e dey rust badly. Im add say wen dem bin dey do dis one wey add am for dia contract to chooking for di 2013 and 2019 underwater investigation wey be part of dia contract. According to di Minister, Julius Berger tell am say dem need to close Carter bridge sharp sharp sake of traffic and di bridge dey beyond repair dem gatz construct new one. "Dem give us a cost of about 38 something billion to repair am and e no dey realistic and di one wey dey realistic na to 359 billion for brand new bridge and dem discuss wit Dutch bank to fund am." 'Nobody submit proposal for Third Mainland Bridge but e go chop 3.8 trillion' - David Umahi For di Third Mainland bridge, Oga Umahi explain say nobody submit any proposal, but na di same underwater problems wey Carter bridge dey face na im Third Mainland bridge dy face too. "Wen we bin do a pro rata [na process wey dem go use di proportional cost of part of di work take compare to di whole work] for di part wey we go repair, e reach 3.8 trillion and if we go do new construction na 3.6 trillion." Im say dem go meet FEC to give dem approval to not less dan seven specialist contractors to do comprehensive investigation, design and bidding to reconstruct and to build new ones or to repair dem. Im say di third request na to advertise for Public, Private , Partnership [PPP] "We bin submit memo and di title for di memo na di approval for constructive engagement on di rehabilitation or construction of new Carter and Third Mainland Bridge for Lagos state." Im explain. Oda bridges wey need repairs for Nigeria Di former govnor of Ebonyi state say no be only Carter and Third Mainland bridges wey need urgent work. Im confam say oda bridges dey wey no good across di kontri and dem need sharp-sharp attention too. "I bin draw di attention of di Federal Executive Council [FEC] to di fact say we go intervene on some construction of new bridges and emergencies for a number of bridges across di nation..." Some of di bridges wey need woek include: Jaimata bridge for Adamawa state wey we don already complete. Murtala Mohammed bridge for Kogi state wey still dey go on. Jebba bridge for Niger state. Gashuwa bridge for Yobe state. Koltaka Marine bridge. Independence bridge. Akata bridge for Lagos. Ibi bridge for Taraba state, Artizan bridge for Enugu state. Apoah bride for Ebonyi state. Opobo bridge for Rivers state. Baro bridge for Niger state. Bukuru bridge for Benue state. And bridges wey don collapse along di East-West road wey include two for Delta and one for Bayelsa state.


BBC News
21 hours ago
- BBC News
Who be di most wanted Ansaru terrorist group leaders wey Nigeria security forces gbab
Di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, don announce say di Nigeria military don gbab two top Ansaru terrorist group leaders wey e identify as identified Abu Baraa, di Amir, and Mahmuda, di deputy Amir. Ribadu yarn dis one for press briefing on security developments for di Office of di National Security Adviser. Di NSA say na dis two men dey responsible for planning several terrorist operations for Nigeria and high-profile kidnappings. According to Ribadu, Mahmud Muhammad Usman (aka Abu Bara'a/Abbas/Mukhtar), na self-styled Emir of ANSARU. "Na im be di coordinator of various terrorist sleeper cells across Nigeria. Na im also be di mastermind of several high-profile kidnappings and armed robberies wey dem dey use to finance terrorism ova di years. Ribadu say Mahmud al-Nigeri (aka Mallam Mamuda) na Abu Bara's proclaimed Chief of Staff and Deputy. Di NSA say Mamuda na di leader of "Mahmudawa" cell wey around di Kainji National Park, between Niger and Kwara States up to di Benin Republic. "Mamuda bin train for Libya between 2013 and 2015 under foreign jihadist instructors from Egypt, Tunisia, and Algeria, and specialise in weapons handling and IED fabrication." According to di NSA said di two men don dey on Nigeria most-wanted list for years, afta dem jointly lead multiple attacks on civilians, security forces, and critical infrastructure. We dey update dis tori


Times
a day ago
- Times
Love Island's Billykiss Azeez: People assume I'm not Irish. It hurts
The government has come under pressure from an unlikely advocate for hate speech legislation: a Love Island contestant. Billykiss Azeez, who lives in Westmeath but is originally from Nigeria, has spoken about her disappointment with the decision by the Fianna Fail and Fine Gael-led coalition to park new laws after a political and public backlash over perceived threats to free speech. 'It's disappointing to hear that the government, whose job and responsibility is obviously to protect the people, will not push to get that hate speech legislation in place,' Azeez, 28, told The Sunday Times. It's disappointing to see that they're not putting the people first. The people is everyone; it doesn't matter if their ethnicity is pure Irish, white Irish, or if they're black Irish.'