logo
BBC expose child sex abuse for South Africa illegal mines

BBC expose child sex abuse for South Africa illegal mines

BBC News19-05-2025

Dis story contain details, including video, wey some pipo fity find distressing.
Di most shocking tin for Jonathan, wey don endure six tough months dey live and work underground for one abandoned South African gold mine, na di abuse wey e witness wey children dey suffer.
Some dey recruited for cheap labour, but dem bring odas in specifically for sex, campaigners tok.
Jonathan, now e dey im late 20s, don migrate to South Africa from one nearby kontri on di promise to make easy money as e dey work in one of it dozens of mines wey dem no dey use well, closed by multinationals becos dem no longer dey commercially viable.
We dey protect im full identity as e fear attacks from di violent criminal gangs wey dey run di illegal mining industry sake of e tok to di media.
Details of wetin di young pipo dey go though show afta di death of dozens of illegal miners near di town of Stilfontein late last year wen police block di mine.
For one calm and steady voice, Jonathan describe di heat, long hours and limited food and sleeping options wey take a toll on im bodi.
But one enduring memory na wetin happun to di underage miners in di shaft wia e bin work.
"I use to see dis kids in di mine - teenagers actually, 15, 17-year-olds.
"Odas use to take advantage of dem sometimes. IE dey fear small-small, and I bin no dey comfortable wit am."
E say di adult miners dey rape dem and dey promise to give dem some of di gold dey find in exchange for sex.
"If dat kid dey desperate for money, e go take di risk."
Jonathan describe how di children go approach teams of miners for protection but "say di team go get conditions".
Sex also dey used as punishment if di teenagers fail to complete a task for dia team.
Jonathan say di children in di mine wia e dey work be all foreign and no realise wetin dem dey get demselves into.
Mining researcher and activist Makhotla Sefuli back dis up.
E say criminal gangs specifically dey target children to work in illegal mines across South Africa.
Many of dem dey abducted from neighbouring kontries and trafficked. Dem dey enticed by baseless promises say dem go find dem employment in di formal mining industry.
"Dia passports dey confiscated wen dem enta South Africa… Na common knowledge say dis young boys dey abused," Oga Sefuli tok.
Di BBC don tok to miners wey dey work in at least two oda illegal mines wey tell us say dem see children wey dey abused in di shafts wia dem dey work.
Tshepo, no be im real name, say e bin see older men dey force young boys to have sex wit dem underground.
"In some instances, dey bin do am for di money. Some dey recruited only for dat purpose, sake of di financial incentives wey go come wit di practice of maybe trading sex underground."
E add say di abuse deeply affect di children.
"Dey change dia behaviour patterns and get trust issues. Dem no want you to get close to dem, sake of say dey feel say dey no longer fit trust anyone."
South Africa illegal mining industry bin make global headlines last year following one standoff between police and miners for di Buffelsfontein gold mine, near di town of Stilfontein in di North West Province.
Di authorities don dey try to reduce illegal mining, wey di govment say di cost South Africa economy $3.2bn (£2.6bn) in lost revenue last year.
Dey bin launch one operation Vala Umgodi, or seal di hole, in December 2023, wit promise to take a tough stance on di gangs.
As part of di operation, di police bin limit di amount of food and water wey bin go down di Stilfontein mine to, as one minister put am, "smoke out" di illegal miners. Officials say di men no gree come out sake of fear say dem go dey arrested.
Soon video begin show from within di mine wey show dozens of emaciated men wey dey beg for rescue, as well as rows of bodi bags. Eventually one court bin order di authorities to save di men.
Among those dem bring up na many wey say dem dey underage, but as a number of dem na migrants without documents wey confam how old dem dey, di authorities bin carry out medical tests to get estimate.
Through dis, di Department of Social Development (DSD) bin confam say dem find say 31 of di rescued Stilfontein miners na children. Dey all be Mozambican nationals and in November, 27 of dem dey repatriated.
Save di Children South Africa bin help translate some of di interviews between di underage miners and di rescue workers.
"Dem bin go through trauma, sake of say some of dem bin also see odas dey sexually exploited," di charity CEO Gugu Xaba tell di BBC.
"Just di feeling say dey fit no come out of there bin destroy those children mentally.
"Di adult miners go start by grooming dem, by acting like say dey like dem."
She say dey go den make di children to perform sexual acts on di adults and den rape dem, days afta day.
"You find say di adult go get three or four of dem wey dem dey do di same tin to."
Ms Xaba say mining gangs dey recruit children sake of say dem dey easier to manipulate and cheaper.
"Children no understand wen you say: 'I go pay you 20 rands ($1; £0.80) per day.' Di adults sometimes dey refuse to work, but children find demselves wit no choice. So e dey easier to use a child to do di work. E dey easier to take a child wey dey one kind voiceless and to bring dem down dia."
Beyond say dem dey exploit dem financially, she say gangs dey wey dey recruit children specifically for sex.
Many illegal miners dey spend months underground, rarely go up to di surface. Markets dey spring up underground to provide dem wit anytin dey need.
"Most children dey trafficked in order to dey used as sex slaves. And you get a pimp wey dey take di money, and e mean say every day dis child dey used as commercial sex worker."
Di BBC bin ask di police and di DSD whether anyone go dey charged over di sexual abuse allegations. Dey no respond to our requests.
One source wey dey work on di Stilfontein miners cases tok say many of di children no wan testify.
Meanwhile, di illegal mining industry kontinu to thrive.
And wit estimate of 6,000 vacant mines wey dey potentially available to explore, na one business dey unlikely to end anytime soon, e leave thousands of vulnerable children at risk.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

‘He's a bad guy': Trump backs decision to bring Kilmar Abrego Garcia back to US to face charges
‘He's a bad guy': Trump backs decision to bring Kilmar Abrego Garcia back to US to face charges

The Independent

time10 hours ago

  • The Independent

‘He's a bad guy': Trump backs decision to bring Kilmar Abrego Garcia back to US to face charges

Donald Trump has called Kilmar Abrego Garcia a 'bad guy' and backed the decision to return him to the US to face criminal charges. Abrego Garcia was wrongly deported to El Salvador nearly three months ago under the Trump administration. He was returned to the US on Friday (6 June) and charged with trafficking migrants into the country. The charges relate to a 2022 traffic stop, during which the Tennessee Highway Patrol suspected him of human trafficking. Speaking to reporters on Saturday, Trump said: 'By bringing him back, you show how bad he is.' 'He's a bad guy,' he added.

Boy, eight, found murdered in plastic bag in an attic after being preyed on by unlikeliest of killers
Boy, eight, found murdered in plastic bag in an attic after being preyed on by unlikeliest of killers

Daily Mail​

time20 hours ago

  • Daily Mail​

Boy, eight, found murdered in plastic bag in an attic after being preyed on by unlikeliest of killers

An eight-year-old Ohio boy, who was found dead in plastic bags in an attic, is revealed to have been allegedly killed by his own mother. Martonio Wilder was found wrapped in a garbage bag in the attic of his Columbus home on June 28, 2024, around six hours after his mom, Lashanda Wilder, reported the boy missing. Martonio's mother, 33, and her girlfriend Johnna Lowe, 34, were both charged with murder, tampering with evidence, abuse of a corpse, and felonious assault. Wilder had told police that Martonio had run away and that it had happened before, before his body was found at around 6.30pm. Martonio was found severely malnourished, weighing only 35 pounds, and dehydrated with signs of blunt force trauma, including multiple bruises and cuts on his face and head, according to the Franklin County Prosecuting Attorney. The Franklin County Coroner's Office determined that the young boy had died from 'deep neck compression.' His autopsy report said his eyes and stomach were 'sunken' and he had a 'severe loss of muscle mass' allowing for his bones to be clearly visible through his skin. Lowe, Wilder, and two other children left the home after police arrived with a cadaver dog to assist in the search for Martonio prompting an amber alert for the two kids. They were later located with Lowe's mother, 68-year-old Mary Johnson, who is facing obstruction of justice charges. Lowe pled guilty to murder and abuse of a corpse and was sentenced to twelve months as well as fifteen years to life with the possibility of parole, according to court documents. The boy's life was described by prosecutor's as 'brutal,' according to ABC News. 'Multiple witnesses and some family members told detectives that Miss Wilder treated Martonio Wilder different than her other sons,' a prosecutor said. 'They spoke about unusual punishments for Martonio, including holding a weighted ball and walking up and down the steps while naked and restricting food. Witnesses also stated Martonio was always hungry and stole food from other homes he was at, including his school.' Lowe had turned herself in to police and prosecutors said she admitted that the couple intended to blame one of Martonio's siblings for his death, the Dispatch reported. Wilder remains in custody in Franklin County Jail on a $2 million bond and is scheduled to appear in court in July.

US charges Kilmar Abrego Garcia with transporting illegal immigrants into the country
US charges Kilmar Abrego Garcia with transporting illegal immigrants into the country

The Independent

timea day ago

  • The Independent

US charges Kilmar Abrego Garcia with transporting illegal immigrants into the country

Kilmar Abrego Garcia has been charged with in the United States with transporting illegal immigrants into the country, nearly three months after the Trump administration mistakenly deported him to his native El Salvador. The human trafficking charges stem from a 2022 vehicle stop in which the Tennessee Highway Patrol suspected him of human trafficking. A report released by the Department of Homeland Security in April states that none of the people in the vehicle had luggage, while they listed the same address as Abrego Garcia. Abrego Garcia was never charged with a crime, while the officers allowed him to drive on with only a warning about an expired driver's license, according to the DHS report. The report said he was traveling from Texas to Maryland, via Missouri, to bring in people to perform construction work. The Justice Department was expected to announce charges Friday.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store