2 days ago
Wetin be ICC and why Nigerians dey para say goment rename am
Nigerians dey para afta di kontri present goment rename di Abuja International Conference Centre wey former President Ibrahim Babangida build to President Bola Tinubu name.
On Tuesday, di Nigeria Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike, announcement during one unveiling ceremony afta di goment rehabilitate di centre, say dem don change di name to Bola Ahmed Tinubu International Centre.
Wike also name halls inside di centre afta some politicians.
Im name halls afta Vice President Kashim Shettima, Chief Justice of Nigeria Kudirat Kekere-Ekun, Senate President Godswill Akpabio and Speaker of the House of Representatives Tajudeen Abbas.
According to di FCT Minister, dis n aim way to say thank you to dem for supporting im FCT Administration and for how di Judiciary and Legislative arms of goment dey collabo wit executive.
But Nigerians dey para say di whole tin be like dem dey enjoy anoda man sweat.
Isaac Fayose, di younger brother of one former Nigerian govnor, Ayodele Fayose, para say: "IBB, di man wey build am, no name am afta imsef. Tinubu renovate am, change im name. e say a lot. Nigerians dey suffer, but dem dey focus on keeping dia name forever."
Former Nigeria Senator, Shehu Sani sef follow provoke for social media as im advise di president say: "Na IBB build di International Conference Centre Abuja. Make di President reject renaming di place wit im name".
Abuja International Conference Center [ICC]
Former President Ibrahim Badamosi Babangida bin build di Abuja International Conference Centre for 1991.
According to Wike, Babangida bin build to ICC to host one Organization of African Unity meeting.
Di meeting bin suppose happun for Ethiopia but dem gatz relocate am sake of security threat.
Nigeria step in come begin urgent construction of di ICC through one oil swap arrangement wey e do to take raise di money.
Di centre bin popular wella sake of na dia President Babagida constitution review committee bin dey examine and revise di Nigerian Constitution.
Architecturally, di centre na mixture of modern design and Nigerian cultural decorations.
E get spacious hall and beautiful gardens surround am to give am very cool atmosphere.
Dis centre na one of Nigeria most iconic venues for high-level events, both local and international.
E don host all kains of events from world summits to trade exhibitions and cultural showcases.
Tinubu goment bin recently do one major renovation wey dem say cost ₦39 billion, and come commission an again for on Tuesday.
Di renovation bin happu afta President Visit di place for 2024 begin complain about how di facility dey spoil.
Inside eight months, Wike renovate an im to wetin im call "world-class" venue.
Now di facility go dey bear di name of di president wey renovate am, no be di one wey build am.
Oda goment buildings wey Tinubu name afta imsef
Less dan two years wey di Nigeria president enta office, President Bola Tinubu don commission more dan three goment properties afta im name.
Inside di first 19 months of im goment Tinubu commission one multibillion-naira army barrack wey dem bin start to construct for 2023.
Di barracks project na intervention wey goment bin fund to provide more accommodation to military workers.
E also commission one immigration complex as well as one new federal polytechnic, All of dem for Abuja.