
Wetin be ICC and why Nigerians dey para say goment rename am
Nigerians dey para afta di kontri present goment rename di Abuja International Conference Centre wey former President Ibrahim Babangida build to President Bola Tinubu name.
On Tuesday, di Nigeria Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike, announcement during one unveiling ceremony afta di goment rehabilitate di centre, say dem don change di name to Bola Ahmed Tinubu International Centre.
Wike also name halls inside di centre afta some politicians.
Im name halls afta Vice President Kashim Shettima, Chief Justice of Nigeria Kudirat Kekere-Ekun, Senate President Godswill Akpabio and Speaker of the House of Representatives Tajudeen Abbas.
According to di FCT Minister, dis n aim way to say thank you to dem for supporting im FCT Administration and for how di Judiciary and Legislative arms of goment dey collabo wit executive.
But Nigerians dey para say di whole tin be like dem dey enjoy anoda man sweat.
Isaac Fayose, di younger brother of one former Nigerian govnor, Ayodele Fayose, para say: "IBB, di man wey build am, no name am afta imsef. Tinubu renovate am, change im name. e say a lot. Nigerians dey suffer, but dem dey focus on keeping dia name forever."
Former Nigeria Senator, Shehu Sani sef follow provoke for social media as im advise di president say: "Na IBB build di International Conference Centre Abuja. Make di President reject renaming di place wit im name".
Abuja International Conference Center [ICC]
Former President Ibrahim Badamosi Babangida bin build di Abuja International Conference Centre for 1991.
According to Wike, Babangida bin build to ICC to host one Organization of African Unity meeting.
Di meeting bin suppose happun for Ethiopia but dem gatz relocate am sake of security threat.
Nigeria step in come begin urgent construction of di ICC through one oil swap arrangement wey e do to take raise di money.
Di centre bin popular wella sake of na dia President Babagida constitution review committee bin dey examine and revise di Nigerian Constitution.
Architecturally, di centre na mixture of modern design and Nigerian cultural decorations.
E get spacious hall and beautiful gardens surround am to give am very cool atmosphere.
Dis centre na one of Nigeria most iconic venues for high-level events, both local and international.
E don host all kains of events from world summits to trade exhibitions and cultural showcases.
Tinubu goment bin recently do one major renovation wey dem say cost ₦39 billion, and come commission an again for on Tuesday.
Di renovation bin happu afta President Visit di place for 2024 begin complain about how di facility dey spoil.
Inside eight months, Wike renovate an im to wetin im call "world-class" venue.
Now di facility go dey bear di name of di president wey renovate am, no be di one wey build am.
Oda goment buildings wey Tinubu name afta imsef
Less dan two years wey di Nigeria president enta office, President Bola Tinubu don commission more dan three goment properties afta im name.
Inside di first 19 months of im goment Tinubu commission one multibillion-naira army barrack wey dem bin start to construct for 2023.
Di barracks project na intervention wey goment bin fund to provide more accommodation to military workers.
E also commission one immigration complex as well as one new federal polytechnic, All of dem for Abuja.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
9 hours ago
- BBC News
Key take aways from President Tinubu June 12 message to Nigerians
President Bola Ahmed Tinubu don grant presidential pardon and confer national honours on di Ogoni Nine, wey bin lead to di death of late environmental activist and writer Ken Saro-Wiwa. Di men lead to oppose di operation of Shell oil corporation in di Niger Delta region in di 80s. Di president also confer national honours on MKO Abiola, Alfred Rewane, Anthony Enahoro and odas during im June 12 address to a joint session of the National Assembly in Abuja. Di president for im speech say e dey important to commemorate di sacrifices of di men and women wey bin fought to restore democratic governance to Nigeria. "Furthermore, I also confer posthumous national honours on Ken Saro Wiwa (CON), di leader of di Ogoni Nine and im fellow travellers, Saturday Dobee (OON), Nordu Eawo (OON), Daniel Gbooko (OON), Paul Levera (OON), Felix Nuate (OON), Baribor Bera (OON), Barinem Kiobel (OON), and John Kpuine (OON)." "I shall also be exercising my powers under di prerogative of mercy to grant dis national heroes a full pardon, togeda wit odas wey dia names shall dey announced later in conjunction wit di National Council of State." Tinubu commend President Muhammadu Buhari say e reach back into history to rectify national misdeed by making June 12 Democracy Day. Also say e officially acknowledge say Chief Moshood Kashimawo Olawale Abiola and im running mate, Babagana Kingibe, as winners of June 12, 1993 presidential elections. "Di struggle no ever be di province of any one group or section of di kontri, na pan-Nigerian for im conception and go be even more pan- Nigerian as we strive to perfect am. Oga Tinubu also honour some Nigerians, including human rights lawyer Femi Falana, Nobel Laureate Wole Soyinka, and di Catholic Bishop of Sokoto Diocese, Hassan Kukah, wit national awards. Full list of Nigerians wey President Tinubu confer national honours on Prof Wole Soyinka (GCON) Prof Olatunji Dare (CON) Journalist and journalism teacher; Kunle Ajibade (OON) Nosa Igiebor (OON) Dapo Olorunyomi (OON) Bayo Onanuga (CON) Ayo Obe (OON) Dare Babarinsa (CON) Bishop Matthew Hassan Kukah (CON) Senator Shehu Sani (CON) Governor Uba Sani (CON) Femi Falana, SAN (CON) Prof Shafideen Amuwo (CON) Barrister Luke Aghanenu (OON) Senator Tokunbo Afikuyomi (CON) Labaran Maku (OON) Dr Tunji Alausa (CON) Mr Nick Dazang (OON) Abdul Oroh (OON) Odia Ofeimun (CON) Seye Kehinde (OON) Barrister Felix Morka (CON) Barrister Ledum Mitee (CON) Olawale Osun (CON) Amos Akingba (CON) Prof Segun Gbadegesin (CON) Mobolaji Akinyemi (CFR) Dr Kayode Shonoiki (CON) Prof Julius Ihonvbere (CON) Prof Bayo Williams (CON) Sen Abu Ibrahim (CFR), and Sen Ameh Ebute (CFR) General Alani Akinrinade, GCON Sam Amuka Pemu CON


BBC News
a day ago
- BBC News
Wetin be ICC and why Nigerians dey para say goment rename am
Nigerians dey para afta di kontri present goment rename di Abuja International Conference Centre wey former President Ibrahim Babangida build to President Bola Tinubu name. On Tuesday, di Nigeria Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike, announcement during one unveiling ceremony afta di goment rehabilitate di centre, say dem don change di name to Bola Ahmed Tinubu International Centre. Wike also name halls inside di centre afta some politicians. Im name halls afta Vice President Kashim Shettima, Chief Justice of Nigeria Kudirat Kekere-Ekun, Senate President Godswill Akpabio and Speaker of the House of Representatives Tajudeen Abbas. According to di FCT Minister, dis n aim way to say thank you to dem for supporting im FCT Administration and for how di Judiciary and Legislative arms of goment dey collabo wit executive. But Nigerians dey para say di whole tin be like dem dey enjoy anoda man sweat. Isaac Fayose, di younger brother of one former Nigerian govnor, Ayodele Fayose, para say: "IBB, di man wey build am, no name am afta imsef. Tinubu renovate am, change im name. e say a lot. Nigerians dey suffer, but dem dey focus on keeping dia name forever." Former Nigeria Senator, Shehu Sani sef follow provoke for social media as im advise di president say: "Na IBB build di International Conference Centre Abuja. Make di President reject renaming di place wit im name". Abuja International Conference Center [ICC] Former President Ibrahim Badamosi Babangida bin build di Abuja International Conference Centre for 1991. According to Wike, Babangida bin build to ICC to host one Organization of African Unity meeting. Di meeting bin suppose happun for Ethiopia but dem gatz relocate am sake of security threat. Nigeria step in come begin urgent construction of di ICC through one oil swap arrangement wey e do to take raise di money. Di centre bin popular wella sake of na dia President Babagida constitution review committee bin dey examine and revise di Nigerian Constitution. Architecturally, di centre na mixture of modern design and Nigerian cultural decorations. E get spacious hall and beautiful gardens surround am to give am very cool atmosphere. Dis centre na one of Nigeria most iconic venues for high-level events, both local and international. E don host all kains of events from world summits to trade exhibitions and cultural showcases. Tinubu goment bin recently do one major renovation wey dem say cost ₦39 billion, and come commission an again for on Tuesday. Di renovation bin happu afta President Visit di place for 2024 begin complain about how di facility dey spoil. Inside eight months, Wike renovate an im to wetin im call "world-class" venue. Now di facility go dey bear di name of di president wey renovate am, no be di one wey build am. Oda goment buildings wey Tinubu name afta imsef Less dan two years wey di Nigeria president enta office, President Bola Tinubu don commission more dan three goment properties afta im name. Inside di first 19 months of im goment Tinubu commission one multibillion-naira army barrack wey dem bin start to construct for 2023. Di barracks project na intervention wey goment bin fund to provide more accommodation to military workers. E also commission one immigration complex as well as one new federal polytechnic, All of dem for Abuja.


Daily Mail
a day ago
- Daily Mail
Porsha Williams's estranged husband deported back to Nigeria after ICE detainment
's estranged husband Simon Guobadia has been deported back to Nigeria after a four-month ICE detainment. has confirmed that the 61-year-old ex of The Real Housewives Of Atlanta star, 43, was released from the U.S. Immigration And Customs Enforcement's custody and sent back to his home country. Guobadia is also no longer listed on the system of the U.S. Department Of Homeland Security. has reached out to representatives of Williams and Guobadia. His friend Tai Savat told Us Weekly that Guobadia was sent back on a flight home to Nigeria a couple of days ago and was in 'good spirits' despite the tough experience of four months at the detention center - which was the first time he was ever imprisoned. Amid the ongoing immigration protests in Los Angeles, Savet said that Guobadia is not mad at President Donald Trump and would actually like a sit-down meeting with him. In February, Porsha broke her silence after her estranged husband was detained by U.S. Immigration And Customs Enforcement (ICE). The entrepreneur was being held at Stewart Detention Center in Lumpkin, Georgia, at the time, according Us Weekly. His status was listed as 'in ICE custody,' according to U.S. Department Of Homeland Security's records. Amid the news in February, the TV star - who's going through a contentious divorce from Guobadia - took to her Instagram to reflect on the situation. She wrote: 'It's disheartening to see my estranged husband make choices that have led to this outcome. At this moment, my priority is moving forward with my family.' Guobadia, who immigrated from Nigeria to the U.S. in 1982, allegedly overstayed his visa and was declared deportable in 1985. He subsequently returned to the U.S. in 1986 and once more overstayed his work visa. It came amid Trump 's order for massive deportations of illegal migrants, which he signed off on earlier this year. The order allows for the deportation of undocumented immigrants to their countries of origin. Guobadia, who pleaded guilty to fraud in 1987 and was deported in 1992 after two more arrests, returned to the U.S. a month later. His 2016 naturalization attempt was denied. In 2024, the Atlanta Black Star reported that he had been repeatedly denied residency. Porsha filed for divorce last year after just 15 months of marriage. The couple wed in November 2022 after getting engaged in May 2021. Their divorce is still ongoing.