Latest news with #IbrahimBabangida


BBC News
21-07-2025
- Politics
- BBC News
Muhammed Babangida accept appointment as BOA chairman?
Recently Nigeria president Bola Tinubu appoint Muhammed Babangida, son of former military head of state General Ibrahim Babangida (rtd) as oga of Bank of Agriculture. Since di appointment, na silence follow as e be like say nothing big don happun. Few days afta di announcement tori burst out for social media say Babangida no gree take di appointment. But Nigerian Presidency say Muhammed Babangida don accept im new appointment as di chairman of di Bank of Agriculture contrary to wetin pipo dey tok. Dis na according to statement wey di President Tinubu special assistant on social media, Dada Olusegun bring come outside. Di statement reveal say, oga Babangida even thank di president say im trust am wit appointment. Oga Olusegun also quote oga Babangida say im "dismiss as lie and malicious, di tori wey dey go around online wey suggest say e reject di appointment. E call am deliberate attempt to mislead kontri pipo and spoil di image of di Tinubu administration". Despite di statement from di presidency, who sign am neva clear. Oga Muhammed Babangida no get any verified social media handle wia e don tok about di appointment. Dis dey come a day afta one statement wey bin dey linked to d pikin of di former head of states, wia e allegedly tok say e reject di appointment sake of say, personal and professional mata wey dey for im plate, e no go fit to accept di role. But di presidential special assistant quote am say im say, "we wan make di public know say di pipo wey dey fake di fake news go dey investigated well-well and dem go dey brought to justice". Muhammed Babangida appointment bin dey part of plenti appointments wey President Tinubu announce on Friday 18 July across goment institutions. E bin dey appointed to di Bank of Agriculture togeda wit Lydia Kalat Musa (Kaduna State) wey get Chairman, Oil and Gas Free Zone Authority (OGFZA) and Jamilu Wada Aliyu (Kano State) wey get Chairman, National Educational Research and Development Council (NERDC). Oda latest appointment na Yahuza Ado Inuwa (Kano State) wey bin get di Standard Organisation of Nigeria (SON) chairman; and Sanusi Musa (SAN, Kano State) as di Chairman of di Institute of Peace and Conflict Resolution(IPCR) Wetin be di Bank of Agriculture? Di Nigerian Bank of Africulture (BOA) Limited bin start as di Nigerian Agricultural Bank (NAB) for 1972 and start operations for 1973. Dem change di name again for 1978 to di Nigeria Agricultural & Co-operative Bank Limited (NACB), den again for 2000 wen dem change di name to di Nigeria Agricultural Cooperative & Rural Development Bank Limited (NACRDB) wen dem bin combine wit di now dead People's Bank of Nigeria (PBN), and di Family Economic Advancement Programme (FEAP). Na until 2010 dem name am di Bank of Agriculture Limited (BOA). E start to carry out di functions of Development Finance Institution (DFI) for di Agricultural and Rural Development sector. Na di Federal goment of Nigeria get am fully and dem own am through di Federal Ministry of Finance Incorporated (MOFI) and Central Bank of Nigeria (CBN) wit 60%:40%. E currently be di biggest agricultural financial institution for Nigeria

The Herald
15-07-2025
- Politics
- The Herald
Nigeria's former leader Buhari to be buried on Tuesday, official says
He referred to himself as a "converted democrat" and swapped his military uniform for kaftans and prayer caps. Ibrahim Babangida, a former military ruler who toppled Buhari in a coup in 1985, said he knew Buhari as a deeply spiritual and humble man. "We may not have agreed on everything, as brothers often don't, but I never once doubted his sincerity or his patriotism," Babangida. After leaving office in 2023, Buhari spent most of his time in Daura, away from the public eye. His successor Bola Tinubu inherited a country grappling with double digit inflation, foreign exchange shortages, economic hardship, low oil production and insecurity that had spread to most parts of Nigeria. Buhari's supporters, however, viewed him as Nigeria's conscience because he had a reputation for shunning the corruption and ostentatious lifestyles often associated with the country's political elites. To his critics, Buhari was "an absentee landlord, a leader who governed by delegation, who disappeared for long stretches (often to London for medical treatment), and whose aloofness felt like abandonment", the local BusinessDay newspaper said. Reuters


Arab News
14-07-2025
- Politics
- Arab News
Nigeria's former leader Buhari to be buried on Tuesday, official says
LAGOS: Nigeria's late former President Muhammadu Buhari, who died in a London clinic on Sunday aged 82, will be buried in his northern home state of Katsina on Tuesday, the state governor said. Buhari, a former military ruler after a coup in the 1980s, returned to frontline politics to become the first Nigerian president to oust an incumbent through the ballot box in 2015. He was re-elected for a second term four years later. Nigeria's Vice President Kashim Shettima and government officials were in London on Monday to organize the repatriation of the former president's remains. Katsina state governor Dikko Umaru Radda said after consultation with Buhari's family it was agreed the body would arrive in Nigeria on Tuesday for burial the same day in his home town of Daura. Among those who paid tribute to Buhari was Indian Prime Minister Narendra Modi, who posted on X platform that 'his wisdom, warmth and unwavering commitment to India–Nigeria friendship stood out.' Buhari earned a devoted following for his brand of anti-corruption conviction politics, especially in Nigeria's largely Muslim north. He referred to himself as a 'converted democrat' and swapped his military uniform for kaftans and prayer caps. Ibrahim Babangida, another former military ruler who toppled Buhari in a coup in 1985, said he knew Buhari as a deeply spiritual and humble man. 'We may not have agreed on everything — as brothers often don't — but I never once doubted his sincerity or his patriotism,' Babangida said in a statement. After leaving office in 2023, Buhari spent most of his time in Daura, away from the public eye. His successor Bola Tinubu inherited a country grappling with double digit inflation, foreign exchange shortages, economic hardship, low oil production and insecurity that had spread to most parts of Nigeria. Buhari's supporters, however, viewed him as Nigeria's conscience because he had a reputation for shunning the corruption and ostentatious lifestyles often associated with the country's political elites. To his critics, Buhari was 'an absentee landlord — a leader who governed by delegation, who disappeared for long stretches (often to London for medical treatment), and whose aloofness felt like abandonment,' the local BusinessDay newspaper said.


BBC News
13-07-2025
- Politics
- BBC News
Former Nigeria president, Muhammadu Buhari die at 82
Former Nigerian President Muhammadu Buhari don die at di age of 82. Former presidential spokesman Garba Shehu say ex-president Muhammadu Buhari die for one hospital for London. Buhari serve as military general in di 80's and elected president twice afta di kontri return to civilian rule in 1999. Dem bin overthrown im goment in 1985 by di den General Ibrahim Babangida. E die for im house in Kastina on Monday but details still dey stretchy. E die two years afta e comot from office in 2023. E bin serve as president from di year 2015-2023. Dem go bury di former president under di islamic rites, politicians and oda key political actors go pay dia respect to di deceased family. About Muhammadu Buhari Nigeria former president, Muhammadu Buhari na Muslim from di northern region and e bin serve as di immediate president from 2015-2023. E also rule as military general from December 1983 to August 1985. Dem born Buhari in December 1942, for Katsina and e be di second president wey rule twice during pre-democracy and afta democracy. Buhari enta goment in 1976 as minister under under Olusegun Obasanjo, di former military ruler. Den im rule as military ruler from 1983 to 1985. Before dem overthrown in goment in August 1985, and dem jail am for 40 months. E enta politics to contest for president in di 2003 and 2007 elections but e no win until 2014 election. E become di president in May 2015 and e serve for 8 years wey be two tenures.


BBC News
11-06-2025
- Politics
- BBC News
Wetin be ICC and why Nigerians dey para say goment rename am
Nigerians dey para afta di kontri present goment rename di Abuja International Conference Centre wey former President Ibrahim Babangida build to President Bola Tinubu name. On Tuesday, di Nigeria Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike, announcement during one unveiling ceremony afta di goment rehabilitate di centre, say dem don change di name to Bola Ahmed Tinubu International Centre. Wike also name halls inside di centre afta some politicians. Im name halls afta Vice President Kashim Shettima, Chief Justice of Nigeria Kudirat Kekere-Ekun, Senate President Godswill Akpabio and Speaker of the House of Representatives Tajudeen Abbas. According to di FCT Minister, dis n aim way to say thank you to dem for supporting im FCT Administration and for how di Judiciary and Legislative arms of goment dey collabo wit executive. But Nigerians dey para say di whole tin be like dem dey enjoy anoda man sweat. Isaac Fayose, di younger brother of one former Nigerian govnor, Ayodele Fayose, para say: "IBB, di man wey build am, no name am afta imsef. Tinubu renovate am, change im name. e say a lot. Nigerians dey suffer, but dem dey focus on keeping dia name forever." Former Nigeria Senator, Shehu Sani sef follow provoke for social media as im advise di president say: "Na IBB build di International Conference Centre Abuja. Make di President reject renaming di place wit im name". Abuja International Conference Center [ICC] Former President Ibrahim Badamosi Babangida bin build di Abuja International Conference Centre for 1991. According to Wike, Babangida bin build to ICC to host one Organization of African Unity meeting. Di meeting bin suppose happun for Ethiopia but dem gatz relocate am sake of security threat. Nigeria step in come begin urgent construction of di ICC through one oil swap arrangement wey e do to take raise di money. Di centre bin popular wella sake of na dia President Babagida constitution review committee bin dey examine and revise di Nigerian Constitution. Architecturally, di centre na mixture of modern design and Nigerian cultural decorations. E get spacious hall and beautiful gardens surround am to give am very cool atmosphere. Dis centre na one of Nigeria most iconic venues for high-level events, both local and international. E don host all kains of events from world summits to trade exhibitions and cultural showcases. Tinubu goment bin recently do one major renovation wey dem say cost ₦39 billion, and come commission an again for on Tuesday. Di renovation bin happu afta President Visit di place for 2024 begin complain about how di facility dey spoil. Inside eight months, Wike renovate an im to wetin im call "world-class" venue. Now di facility go dey bear di name of di president wey renovate am, no be di one wey build am. Oda goment buildings wey Tinubu name afta imsef Less dan two years wey di Nigeria president enta office, President Bola Tinubu don commission more dan three goment properties afta im name. Inside di first 19 months of im goment Tinubu commission one multibillion-naira army barrack wey dem bin start to construct for 2023. Di barracks project na intervention wey goment bin fund to provide more accommodation to military workers. E also commission one immigration complex as well as one new federal polytechnic, All of dem for Abuja.