logo
#

Latest news with #Agunechemba

'Dem threaten to shoot me' - female corps member assaulted by Anambra vigilante tok her side of di story
'Dem threaten to shoot me' - female corps member assaulted by Anambra vigilante tok her side of di story

BBC News

time9 hours ago

  • BBC News

'Dem threaten to shoot me' - female corps member assaulted by Anambra vigilante tok her side of di story

Di female corp member wey some vigilante group bin assault and tear her clothe for Anambra don come out to tell her own side of di story of wetin happun. Operatives of di Agunechemba security for Anambra bin naked di girl and drag her outside afta beating and hitting her wit blow. Di incident happun for Oba, Idemili South Local Govment Area of Anambra State, and e cause serious tok tok for social media. According to di girl, she say di incident bin happun for 23 July 2025, around 5pm wen dem bin dey inside dia lodge for Anambra. She say di men wey come her lodge bin begin use dia legs hit di door to break in, but wen she open to see who dem be, dem just carry gun dey shout but dem no wear any security uniform. Di young lady give her account inside one video interview wey she do wit media personality Aproko King, wia she narrate di incident give am. She say she bin dey inside di lodge wit her oda corpers for di three storey building wey get plenti flats, wen heavy knocks begin dey land for dia door. According to her narration, she say di door for hit her wen she wan go open am to see who dey use aggression hit am, if no be say she dey jeje. "I see masked man wit gun. E no dey wear any form of uniform, notin to take identify dem. At first, I bin fear say na armed robber until I hear am say, "all of you, outside". She tok say she find courage ask di man say why e want make all of dem come outside, as e no introduce imsef or tell dem di reason why e come dia lodge. "All of us na corpers for di room. E no tell us wia e dey come from or introduce imself. My colleague bring im ID and tell odas make dem bring dia own too, but dem ignore us. "Dem force dia way into our rooms, search laptops and phones. Dem become aggressive and say we dey do yahoo." Di female corper say dem try explain to di men say dem no be yahoo, say dem dey serve, but di men no gree. She say na nine of dem di vigilante men bin carry dat day and all of dem na corpers dem be. She say wen di men search dem, dem no find anytin and dem even show di NYSC portal for dem to see sake of say some just come for dia place of primary assignment. "But dem push us downstairs. Dem ask me why I bin dey challenge dem as woman. Wen we reach downstairs, we see dia vehicle and realise say dem be Anambra vigilante group." "Even if we we go go wit dem to dia office, we suppose call our LGI so dem go know, since we no sabi wia dem dey take us go." She narrate say di men of di vigilante group no allow dem call anybody and dem begin beat her say why she go ask dem kwesion. According to di corper, she beg dem make she change her cloth but dem refuse and force her into dia vehicle, afta dem also beat some oda corpers wey chook mouth for di mata. "Dem start dey beat me, say wetin give me di right to kwesion dem. Dem say dem go smash our phones if we call anyone. Dem beat me, tea my clothes. One of my colleagues bin dey beg on my behalf, but dem hit her wit iron rod." From di video wey go viral, we see how di men bin drag her clothe till e tear and still dey push her up and down. For her side of di story, di female corper say di vigilante men bin call her ashawo say dem go shoot her and throway her bodi. "Dem slap me, call me prostitute. Dem threaten to shoot me and throw my corpse for bush." Now, di young lady dey ask say she must get justice make all dose vigilante pipo get punishment. Meanwhile, Anambra State govment don dismiss di eight Agunechemba operatives wey dey involved for di assault on di female member of National Youth Service Corps (NYSC) wey bin dey serve for di state. Dem parade di operatives for front of Agunechemba Security Command for Anambra state, wia dem go from dia land for police hand for more investigation. Di incident wey go viral for social media bin vex plenti Nigerians wey demand say dem must get justice for di lady wey dem assault. Also, di National Youth Service Corps (NYSC) condemn di "unacceptable and dehumanising" attack on di corpers. Caroline Embu di Acting tok-tok pesin for statement say dem believe in and support di ongoing investigation by di Nigeria Police Force to find out wetin happen. "Dis we trust go help get justice for di Corps Member in kwesion and any oda aggrieved party,", Embu tok for statement.

Anambra govment dismiss eight Agunechemba vigilante operatives wey assault female corps member, hand dem to police
Anambra govment dismiss eight Agunechemba vigilante operatives wey assault female corps member, hand dem to police

BBC News

timea day ago

  • BBC News

Anambra govment dismiss eight Agunechemba vigilante operatives wey assault female corps member, hand dem to police

Anambra State govment don dismiss di eight Agunechemba operatives wey dey involved for di assault on di female member of National Youth Service Corps (NYSC) wey bin dey serve for di state. Dem parade di operatives for front of Agunechemba Security Command for Anambra state, wia dem go from dia land for police hand for more investigation. Di incident wey go viral for social media bin vex plenti Nigerians wey demand say dem must get justice for di girl wey dem assault. Wit di video wey go viral for social media, di security operatives of di Agunechemba wit dia guns bin join hand beat di young female corps member wit slaps, blows and di girl dey shout 'please' but dem no leave her. Afta different Nigerians including NGOs, politicians, police and even NYSC demsef chook mouth for di mata, di vigilante group don take step to remove di operatives wey carry out di operation and hand dem ova to di police. According to di special adviser to Govnor Soludo on Community Security for Anambra State, Ken Emeakayi wey make di announcement for di state broadcasting station, e say dem no dey cova di mata up. According to di special adviser to di govnor of Anambra wen e dey tok for Anambra Broadcasting Service on Wednesday 20 August 2025, e say dem no dey sweep di mata under carpet. "In readiness for openness and to dey fair to evribodi, we dey hand dem ova to di police. Dat na wetin we dey do, na di reason why we bring dem out make pipo see dem. We no dey hide dem E add say Anambra state govnor no support make any security outfit bin dey assault anybodi for di state. "Pipo dey tok say we dey try sweep dis under di carpet, dat no be wetin we dey do. Di govnor of Anambra no send us out to molest anybodi," e tok for di video. Wetin happun bifor Di young lady dey identified as corps members for Anambra State wen vigilante operatives bin assault and tear her clothes.. Inside di video, men wey wear mufti wit heavy guns bin enta into one compound and begin beat one lady. Dem tear her clothes and drag her left and right till dem push her out. Di incident happun for Oba, Idemili South Local Govment Area of Anambra State, and e don cause serious tok tok for social media. Di National Youth Service Corps (NYSC) condemn di "unacceptable and dehumanising" attack on di corpers. Caroline Embu di Acting tok-tok pesin for statement say dem believe in and support di ongoing investigation by di Nigeria Police Force to find out wetin happen. "Dis we trust go help get justice for di Corps Member in kwesion and any oda aggrieved party,", Embu tok for statement. She add say "Furthermore, necessary administrative procedures dey go on to assist di Corps member to manage di physiological and psychological trauma resulting from dis unfortunate incident." According to di police for Anambra State, na di Agunechemba Vigilante Group bin carry out di assault. Dem add say di incident no be recent one as e don happun for July 2025. However, Anambra authority condemn di act and describe am as unfortunate incident wey no suppose happun. Anambra authority react to assault video Di special adviser to Govnor Soludo on Community Security for Anambra State, Ken Emeakayi don react to di trending video wia vigilante operatives bin assault di female corps member and odas. E say di operatives bin dey carry out operation wen di incident happun but e dey veri sad say dat kain tin happun. "Wetin happun for dat incident dey veri unfortunate. We no rule out dis unfortunate incident wey happun, we get di report and di step we take be say we arrest di operatives wey dey involved for di act." "We detain dem, invite di victim wit di NYSC state coordinator. Den we say, our men wey go dat place, dia action dey unacceptable." Di special adviser to Anambra State govnor tok for di interview wit Channels TV say na men of di local security outfit Agunechemba bin carry out di operation. E say dem bin dey pursue some suspected cultists wey run inside di compound wey di mata happun. According to Emeakayi, Udo Ga-Achi na di operational code name wey di operatives dey take carry out di operation. E say di operation get di police, DSS, army, civil defence and all di security agencies for Anambra State but Agunechemba na di state security outfit wey be say na homeland security law create am. According to di community security adviser for Anambra State, na di law of di state empower di Agunechemba security outfit "to enta any compound wey any questionable pesin run into wen dem dey pursue am". E say di Agunechemba security outfit fit form squad for di purpose of tackling kidnapping, banditry, cultism, and any oda vices. For dis video wey dem naked di female corps member and beat odas, e say di Agunechemba security outfit bin purse suspected cultists into di compound and dem begin search di building. E say na wetin carry di operatives go dat building be dat. "Di Agunechemba for Oba town bin dey chase group of cultist guys wey dey ride for motorcycle. During dat period, di suspected cultist run into one isolated area and into some houses." "Di operatives pursue dem into di compound, wia some pipo run into different houses and di operatives enta dia to bring dem out to screen and identify dem." However, e condemn di action of di security operatives wia e tok say dat assault no suppose happun. 'We don sabi di suspects' - Police Meanwhile, di Anambra State Police Command don condemn di sad incident wia vigilante bin naked di young female corps member. "Di assault dey carried out by vigilante operatives. Following di incident, we don identify di suspects wey dey involved," Anambra State police tok-tok pesin, SP Tochukwu Ikenga, tok for statement. E say di reason why di case neva move forward since e happun na becos say di victim dey unavailable. Ikenga also say dem don begin investigation into di case, and dem no go gree for any form of assault becos say na criminal offence under Nigerian law. "Any form remain criminal offence under di Nigerian law and get di right to take necessary legal action to help di court proceedings while we dey wait for di victim." Police also cut warning give vigilante groups say make dem stop dey use brutality and abuse of authority during dia operation.

Anambra state don set to arraign popular native doctors Akwa Okuko, Eke Hit and Onye Eze
Anambra state don set to arraign popular native doctors Akwa Okuko, Eke Hit and Onye Eze

BBC News

time04-04-2025

  • Politics
  • BBC News

Anambra state don set to arraign popular native doctors Akwa Okuko, Eke Hit and Onye Eze

Di Anambra state goment don set to arraign three popular native doctors for di state, wey dey known as Akwa Okuko, Eke Hit and Onye Eze for court, less dan one month afta dia initial arrest. Chidozie Nwangwu wey pipo sabi as Akwa Okuko and Ekene Igboekweze wey pipo sabi as Eke Hit, bin dey arrested back in February say dem allegedly get hand for illegal activities for di state. Dia arrest bin dey based on a new law wey di state Govnor Chukwuma Soludo bin sign for January dis year to tackle increasing insecurity. Dis new law wey di name na 'Anambra State Homeland Security Law 2025' also get provisions to stop wetin di goment describe as di increase of fake traditional priests and priestesses wey dem say na im dey behind rising insecurity for di region. Di law na primarily to establish a security outfit for di state called Agunechemba. However, section 18 of di law tok about decriminalisation of money rituals. Di section say: "Any pesin wey administer powers or charm on any oda pesin for di purpose of commission of any offence or for di purpose of accumulation of wealth by supernatural means oda dan by any known lawful means of livelihood commit offence and e dey liable on conviction to imprisonment for a term of six years wit option of fine of 20 million naira or both". Di law also tok say na offence for anybodi to claim say e get supernatural powers, and anybodi wey dey arrested for di offence get to prove say e get di powers true-true or im go dey liable to conviction of six years imprisonment or fine of 20 million naira or both.

Who be Ekene Hit, di Okija Shrine native doctor wey dem arrest for Anambra State?
Who be Ekene Hit, di Okija Shrine native doctor wey dem arrest for Anambra State?

BBC News

time13-02-2025

  • Politics
  • BBC News

Who be Ekene Hit, di Okija Shrine native doctor wey dem arrest for Anambra State?

Security operatives for Anambra State, southeast Nigeria, don arrest one ogbonge traditional priest, Ekene Igboekweze, popularly known as Ekene Hit. Di arrest of dis native doctor dey based on one new law wey di state govnor Chukwuma Soludo bin sign for January dis year to tackle increasing insecurity. Dis new law wey di name na 'Anambra State Homeland Security Law 2025' also get provisions to stop wetin di goment describe as di increase of fake traiditional priests and priestesses wey dem say na im dey behind rising insecurity for di region. Videos of wen plenty security pipo go arrest 'EKe Hit' wey im real name na Ekene Igboekweze for im house for Okija community don go viral on social media. Di native doctor dey popular on social media wey im dey use to spread im work, including claims say e fit do money rituals for pipo, and e fit make fraudsters successful for dia work. One of im pages for Facebook get more dan 42,000 followers. Dis arrest dey come only few days afta authorities bin arrest anoda native doctor for di same Anambra State wey im name na Chidozie Nwangwu popularly known as Akwa okuko tiwara aki. Who be Eke Hit? Im real names na Ekene Igboekweze, and e hail from Umuofo Okija, a rural community for Ihiala Local Goment Area of Anambra State. For one Interview, e tok say di name 'Eke Hit' come from one customer who im bin work for and afta di work dey successful, di man nickname am 'Eke Hit' - Eke from im first name and 'Hit' to show say e dey always hit im target wit im medicine. Eke Hit tok say e inherit di practice of native doctor from im father Nwokocha Igboekweze. According to him, im mama born 12 children but na only him dey alive. He bin dey go Catholic church and bin dey for Mass Servers, bifor e later enta Watchman. E bin do travel to Ghana to do business but later come bak as e claim say na di spirit of im father carry am come bak. Di man dey always boast say "If I do medicine for you and e no work afta four days i go refund your money". Even though im na native doctor, Eke Hit tok say e also believe in God and im dey go church once evri year. Anambra State Homeland Security Law 2025 Di rising insecurity for di south eastern region dey directly connected wit di rise of fake traditional practices for di region, according to Anambra State govnor Chukwuma Soludo. According to di govnor, for all di kidnappers camp wey security operatives don burst for di state, one common thing wey dem don notice na say native shrine dey always dey dia. Na bicos of dis, di Anambra State Assembly bin come up wit di Homeland Security Bill wey Soludo sign into law for di beginning of di year. Di law na primarily to establish a security outfit for di state called Agunechemba, however section 18 of di law tok about decriminalisation of money rituals. Di section say: "Any person wey administer powers or charm on any other person for di purpose of commission of any offence or for di purpose of accumulation of wealth by supernatural means other dan by any known lawful means of livelihood commits an offence and is liable on conviction to imprisonment for a term of six years wit an option of fine of N20 million or both". Di law also tok say na offence for anybodi to claim say e get supernatural powers, and anybodi wey dey arrested for di offence must prove say e get di powers true-true or im go dey liable on conviction six years imprisonment or fine of N20 million or both.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store