17-07-2025
3 illegal miners die, more dan 30 odas trap inside mine pit wey collapse for Ghana
Local authorities for southern Ghana don resume efforts to rescue ova 30 illegal miners wia trap inside one mine pit wey collapse on Wednesday, 16 July.
Dem confam say three pipo don die, anoda pesin dey battle for im life for hospital, afta di pit wey bin dey Akyem Wenchi for di Denkyembour district for di Eastern Region, bin collapse.
E neva dey clear wetin cause di collapse.
Security pipo bin run comot di area wen angry residents storm di place wen dem come for rescue operations.
Oga wey be district chief executive and di chair for di security council, Umar Ahmed tok say "di atmosphere don become dangerous for di rescue team wey bin dey for ground."
"Na so we run comot di place sake of e don become dangerous and unsafe for us when di youth storm di scene wey dem bin dey chant."
Umar Ahmed tok local media say im become afraid wey im gatz to comot di place.
"Dem bin scata my car; di residents bin vex well well, wey dem neva listen to di police for di scene serf, na so we run away," Umar Ahmed tok.
Police for Akwatia bin dey struggle to deal wit illegal mining for dat region since.
"Dat area na galamsey prone area we bin try several times to clear di illegal miners for dia but we neva succeed."
Oga for di district security council say "we go return to di site if we get military reinforcement to kontinu di search."
"From wetin we sabi, ova 30 pipo fit dey trapped inside di pit wey water don also full di pit, if we fit go back quick wit di military, e go beta," Umar Ahmed bin explain.
Authorities bin tok say sake of water don full di mining pit, di rescue effort dey affected for Wednesday evening.
Dis incident bin dey come one day afta di Ghana President John Mahama bin tok say illegal mining (galamsey) don become national emergency, wey demand quick action.
For many part of di kontri, illegal mining bin dey happun, wia di miners don scata waterbodies and forests.
Sabi pipo dey put pressure for govment to declare state of emergency for places wia waterbodies don spoil and forest reserves don scata.
Meanwhile di kontris Attorney General bin write to di economic and organized crime office (EOCO) say make dem investigate two executives of di govment party binational democratic congress (NDC), wey dey allegedly involved for illegal mining.
Di attorney general also bin ask EOCO say make dem expand di investigation to cover di period bifor 2024 when former environment minister professor Kwabena Frimpong Boateng bin find inside one report say plenti ogbonge politicians and govment officials dey allegedly involved for illegal mining under di ex president Nana Akufo-Addo.