logo
#

Latest news with #AuduOgbeh

Former Nigeria minister under Buhari, Audu Ogbeh don die
Former Nigeria minister under Buhari, Audu Ogbeh don die

BBC News

time3 days ago

  • Politics
  • BBC News

Former Nigeria minister under Buhari, Audu Ogbeh don die

Former Nigeria minister for Agriculture wey also be one time chairman of di opposition Peoples Democratic Party (PDP) Audu Ogbeh don die at di age of 78. Ogbeh die on Saturday 9 August 2025, according to report wey di Nigeria Television Authority (NTA) bin credit to di family. NTA say di "Fmr Minister of Agriculture Audu Ogbeh, don die at 78". For 2018, wen Ogbeh be Agriculture minister, di goment bin say dem ready to close border to stop pipo wey dey smuggle rice enta di kontri. E serve as minister under di late Muhammadu Buhari. Audu Ogbeh profile Audu Innocent Ogbeh be Nigerian farmer and politician wey serve di minister of agriculture and rural development from 2015 to 2019. E bin also serve as di chairman of di Peoples Democratic Party from 2001 till January 2005. For di second republic of Nigeria, Ogbeh serve as di Minister of Communications from 1982 to 1983. before e later become Minister of Steel Development. Na wen military coup bring Major-General Muhammadu Buhari to power for 1983, na dat time im tenure end. Dem born di late former minister for July 1947, for Benue State. E attend King's College for Lagos before e come go study for Ahmadu Bello University, Zaria, including di University of Toulouse, France E lecture for di Institute of Education, Ahmadu Bello University, Zaria before e head some oda departments for di institution. For 2001, dem appoint am as di National Chairman of di People's Democratic Party (PDP), e replace Chief Barnabas Gemade. E dey di position until January 2005, wen e bin dey pressed to resign due to im criticism of di way di den President Olusegun Obasanjo handle one crisis for Anambra State

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store