logo
#

Latest news with #AyoBabalola

Wetin cause anger between Coza pastor Biodun Fatoyinbo and CAC
Wetin cause anger between Coza pastor Biodun Fatoyinbo and CAC

BBC News

time2 days ago

  • Entertainment
  • BBC News

Wetin cause anger between Coza pastor Biodun Fatoyinbo and CAC

Social media dey hot for di past few days ova mata wey concern di founder of Commonwealth Zion Assembly (Coza) Reverend Biodun Fatoyinbo and im comment on di founder of Christ Apostolic Church (Cac), late Pastor Ayo Babalola. Di comment don cause serious tok tok for social media users wey kwesion why Oga Fatoyinbo go make dat kain comment about di founder of anoda church. While some pipo only watch di few seconds clip wey dem bloggers post, di real message na like one hour thirty minutes for wia e preach. And we look di video to check wetin Oga Fatoyinbo truly tok wey dey cause kasala. Wia Oga Fatoyinbo deliva im message na for di International Founders Conference (IFC) 2025 wey one man of God, Pastor Korede Komaiya bin host between 21 - 23 July 2025 for Warri, Nigeria. Meanwhile, di conference na for founders, pioneers, and leaders - dis mean say di participants na church pipo wey dey lead in one capacity or di oda. For July 22, 2025, Pastor Fatoyinbo deliva im message wit di title 'Financial Flow for Ministry' wia e preach on how money dey support Christian ministry. Wia di whole gbas gbos come begin na wia e give example of late Babalola, wey found one of di biggest Apostolic movement for Nigeria wen e receive calling as far back as 1928. For im preaching, Pastor Fatoyinbo say many miracle works wey di late CAC founder bin do no dey documented. E add say if to say dem document wetin dat man of God do bifor e die, oda pipo for dey come pay homage to am. "I bin dey study recently about wetin Apostle Ayo Babalola do. You fit correct me but wetin God do for di life of Chris Miglesworth, if dem document wetin God do for di life of dat man (Ayo Babalola), pipo go dey come pay homage," Pastor Fatoyinbo tok for im preaching. E bin dey tok to di participants on how more money go fit help dem express and fulfil dia ministry say make dem make money becos to dey poor no good. Pastor Fatoyinbo also tok say Ayo Babalola get plenti anointing wit grace but money no dey to make am go far. "E get anointing, and I bin describe to my church members some tins wey I hear about am (Ayo Babalola), e dey so anointed. E bin dey pray one day and python cross im leg and di python dry up." "E no even say I bind you dry up, e just cross leg. Anointed man wit heavy duty grace, but no money. So all di grace just go like dat?" E go on to say poverty fit destroy dreams becos God no create man to suffer for 'ministry'. Dis mata don far wit plenti criticism ontop Pastor Fatoyinbo head and e don also make di CAC issue dia reply to dat kain tok wey go public. CAC give reply Di Cac through dia Director of Publicity, Pastor Ade Alawode bin reply Pastor Fatoyinbo ontop wetin e tok about dia founder Babalola. "For one of your trending messages on YouTube, you acknowledge say Apostle Babalola dey highly anointed but "no get money", and den go on to ask sarcastically, "wia im children dey children?" Kwesion wey dey both insensitive and ill-informed." "To put anointing or ministerial success wit material wealth dey biblically flawed." Di church say Apostle Babalola get children and dem go don dey old by now. "Apostle Babalola dey called by God on October 10, 1928, at di age of 24. Im ministry reach Western and Midwestern Nigeria, and extend to di Gold Coast (now Ghana), by undeniable signs and wonders." "E dey blessed but no dey materialistic or greedy. E give lands to di Church, support di education of many, feed di poor, and live sacrificially and e give house to more pipo dan just im biological children." Cac say dia founder live for good home, drive good car and do plenti charity works. Dem add say di children of di Apostle dey serve for dia different churches. "Di measure of believer anointing no dey for material tins, but for sacrificial service." Pastor Fatoyinbo apologise to Cac Meanwhile, Pastor Fatoyinbo don offer apology for di statement wey e make about Apostle Babalola of Cac. E say e respect di late Ayo Babalola as 'most distinguished father of faith for Nigeria and indeed all ova di world.' "Di exploits of Apostle Joseph Ayo Babalola, for di video wey I tok dey too numerous to count and e remain di hall mark of most Christian organizations for Nigeria and beyond till dis veri moment." Pastor Fatoyinbo say most church for di world take dia root directly or indirectly from Cac under Apostle Babalola and e imsef benefit from am. "I dey honored, humbled and grateful for evri word, admonition and correction for statement wey dem issue dis morning by CAC. I be child wey grow up for di church and no fit erase dat part of my formative years." E say im no refer to di children of di late Apostle of faith in bad light and e no go do dat. Pastor Fatoyinbo say e dey proud of di achievements of di children of Late Babalola becos dem be good examples to follow. "I apologize if any oda statement wey I make bin cause any form of distress, hurt or discontentment to di CAC, di family of di late Apostle Babalola or im associates. "I no go eva disrespect or speak of dem for dat manner either publicly or privately." While dis mata still dey go on, many Nigerians still dey give dia comments on di kain statement wey Pastor Fatoyinbo make.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store