logo
#

Latest news with #B734

Max Air flights suspended for three months after aircraft incident
Max Air flights suspended for three months after aircraft incident

BBC News

time29-01-2025

  • Business
  • BBC News

Max Air flights suspended for three months after aircraft incident

Nigeri Civil Aviation Authority (NCAA) don sama Max Air wey be one of di local airlines for di kontri wit three months suspension. Dis dey come afta di incident wey bin involve Max Air B734 aircraft wit registration marks 5N-MBD. Di Max Aircraft bin dey land for di Mallam Aminu Kano International Airport, Kano on Tuesday, 28th, January 2025 at about 12 midnight wen di flight experience landing issues. For statement wey di Director, Consumer Protection and Public Affairs, (NCAA) Michael Achimugu sign, im tok say dem neva know wetin really cause di problem. Im add say dem dey wait di outcome of di investigation wey Nigeria Safety Investigation Bureau (NSIB) dey do. "Nigerian Safety Investigation Bureau (NSIB) don initiate investigation into di occurrence. Di NCAA go provide di required support to di NSIB for dis regard. We must state say di specific cause(s) of dis incident go only dey established afta di NSIB don conduct dia investigation." Di statement tok. Why goment suspend Max Air According to di statement, NCAA bin start organizational risk profiles for each scheduled operator, including Max Air, wey dem don almost dey conclude. But dem still sama Max Air three months suspension sake of di incident wey happun on Tuesday midnight. "However, as a result of dis incident, Max Air dey suspend domestic flight operations for a period of three months with effect from midnight, 31st January, 2025, to allow di internal appraisal of dia operations by di management. NCAA tok say during dis three months, dem go chook eye well-well, do safety and economic audit for di domestic airline operator. Di safety audit go get re-inspection of Max Air organization, procedures, personnel and aircraft as specified by Part 1.3.3.3(b) of di Nigeria Civil Aviation Regulations, while di economic audit go critically examine di financial health of di airline to guarantee dia capability to sustain safe flight operations." Max Air go resume domestic flight operations only if goment satisfactory complete dis audit. Di NCAA say safety and di wellbeing of passengers dey important to dem and dem dey aware of any inconvenience dis action fit cause pipo wey bin don plan to use Max Air travel. Wetin happun on Tuesday According to Max Air for statement wey dem put for dia social media handle, one of dia flights bin experience one incident wen e bin dey try to land on Tuesday night for Kano. Dem say dia crew handle di situation professionally as dem safely evacuate all di passengers and crew members wey bin dey di flight. "No injuries and we don remove di aircraft since from di runway as of 04;28." Di statement add say di Kano runway dey temporarily closed sake of di incident and e fit lead to some delays for flight operations on Wednesday. Meanwhile, di Federal Airports Authority of Nigeria, FAAN, for statement say di aircraft, Max Air Boeing 737, registration 5N-MBD, bin experience a nose wheel landing gear collapse and a rear tire burst while landing on Runway 06/24 for MAKIA. Dem say 53 passengers and 6 crew members bin dey on board and dem no injure. Dem say dem open di runway at 08:00hrs, after cleaning and normal flight operations bin resume. Aviation sector for Nigeria Some domestic airlines for Nigeria dey get one issue or di oda wey don raise concern about di safety of di air space. For December, 2024 one Cargo aircraft jump comot from runway enta bush for di Nnamdi Azikiwe international airport for Abuja. Di aircraft wey belong to di Allied Air Cargo wit registration number 5N-JRT jump comot from di runway around 10:05am on December 11, 2024. Nobody injure for dat incident. On 24 October, 2024, One helicopter crash for Atlantic Ocean near Bonny Finima wey involve eight pesins onboard. Out of di six passengers and two crew members, authorities bin confam di recovery of three bodies at dat time. For April 2024, Nigeria goment bin announce full audit for all local airlines for di kontri. Di Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA) na im go carry out full audit of all local airlines for di kontri. Di minister for aviation, aerospace and development Festus Keyamo give dis informate wen e feature for one programme on Channels TV. E say goment go review all di airlines wey dey carry passengers for di kontri, to guarantee di safety of all passengers plus di health of di civil aviation industry. Dis informate bin come afta goment suspend DANA airlines, one local airline for Nigeria afta one of dia planes wey bin carry passengers from Abuja enta Lagos bin get one small accident on di runway. Nigeria goment suspend Dana airline on Wednesday, 24 April, 2024. Wit all dis incidences for Nigeria Aviation sector, Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo assure pipo say "Nigeria airspace dey safe".

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store