logo
#

Latest news with #BBCNewsPidgin

'Me and oda pipo dey suffer, di wahala too much' - patients lament nurses strike for Nigeria
'Me and oda pipo dey suffer, di wahala too much' - patients lament nurses strike for Nigeria

BBC News

time01-08-2025

  • Health
  • BBC News

'Me and oda pipo dey suffer, di wahala too much' - patients lament nurses strike for Nigeria

Patients across federal hospitals don begin feel di impact of di nurses and midwives strike wey start on Wednesday 30 July. Di National Association of Nigeria Nurses and Midwives (NANNM) bin announce say di warning strike go last for seven days. Di strike go affect only federal goment hospitals and facilities. Di strike dey come afta di association give Nigeria goment 15 days ultimatum to address all di issues wey dey disturb dem. BBC News Pidgin waka go some hospitals wey federal govment get for Kano, and our tori pesin see pipo worried sake of di strike. Many sick pipo dey suffer and dem no happy becos of di strike. Some pipo for di hospital look like relatives of di sick pipo, and e clear say di strike dey affect dem well-well based on how dem dey waka up and down dey worry. One woman tell BBC News Pidgin say dem carry sick pesin go Malam Aminu Kano Hospital, but now di pesin no dey get di treatment wey e suppose get again. "We carry our pesin come hospital, dem don even start treatment, but now health workers don go on strike. "I dey beg govment make dem help us beg di workers make dem come back to work, so dat our children go fit get beta," she tok. One man wey im name na Rufa'i, wey dey for Emergency ward, also tell BBC News Pidgin say as e carry im younger broda wey injure for leg come hospital, di tin wey e meet no sweet am at all. "I carry my broda come wey get wound for leg, but wen I reach here, I see say workers dey on strike. "Di tin really pain us, we dey beg pipo wey fit help to enta dis mata make dem help us," e tok. Anoda patient wey dey for male ward tok say e need medical help, but dis strike dey make am hard for am. "I no well and my sickness need special treatment or maybe even operation, but sake of dis strike, me and oda sick pipo dey suffer. Di wahala don too much." BBC News Pidgin also visit di University of Port Harcourt Teaching Hospital (UPTH), wia patents for dia dey also feel di impact of di strike and dem don discharge most of dem. Even though di hospital get a strike action protocol wia dem till dey try to offer some medical services, patients still dey feel di sad impact of di strike as many clinics wey suppose run no dey open. "Dem still dey offer service for di Accident and Emergency section but dem no dey admit anybody becos nurses no dey on ground. "I need to see doctor becos of di infection I get for my face but di doctor on duty just prescribe tablets wey I take, even though e say dem suppose admit me to monitor me well, but dem no admit me becos nurses no dey. I pray make dem call off di strike soon," na so George Okpokiri, a patient wey go do hospital tok. Despite di fact say doctors and oda medical personnel like pharmacist still dey work, di services dey grounded sake of di ongoing nurses strike.

'To Kill A Monkey come at di right time for my life'
'To Kill A Monkey come at di right time for my life'

BBC News

time28-07-2025

  • Entertainment
  • BBC News

'To Kill A Monkey come at di right time for my life'

Ogbonge Nollywood actress Stella Damasus say acting for di ogbonge movie 'To Kill A Monkey' come at di right time for her life. Damasus tok wen she siddon wit BBC News Pidgin to tok about di latest Kemi Adetiba film wey dey totori pipo and wey she act inside as Nosa - one of di main characters. "Evri choice wey you make get consequence. No mata di reason wey you take make am. If you put hand for dirty, dirty go follow you." Damasus tok as she share di lesson wey di movie dey try pass across. She say di big lesson from di film na to show how human beings take be and na evribodi get flaw, get problem and na wetin di storyline dey try show be dat. On how some pipo receive di movie sotay dem dey try relate Nosa role to who Damasus be for real life, Damasus say: "Na beg I dey beg, na feem. Becos I don see pipo say Nosa make you no enta mainland o. Anoda one say if una see wia dem dey flog Nosa, make una call me I must join." Howeva, to her, wetin pipo dey tok get anoda meaning as she see am as opportunity to prove say di pipo like di acting for di movie, and di cast do ogbonge work. "I like di fact say dem no fit tell di difference becos dat mean say we do veri good work, wey be say dem believe say na me be dat, but make dem also remember say na story we dey tell. "All di emotions, all di cry, all di triggers evritin, I don face am bifor I enta set. Becos if I enta set, I no fit let dose tins affect me. I go dey react to di characters but wen I don do dat part finish, I need to now come transition." Also, di opportunity to act di role according to Damasus, bin come at di time wey she tok say she bin wan come back Naija from America to do more tins. 'Marriage dey end' - Stella Damasus Di movie dey also come at a time wey Stella Damasus dey news sake of her marriage wey end. Damasus say she don move on. "Di role come at di right time wey I wan dey come naija now dey work. Afta evritin end for corner, I don alreadi move on, I get work wey I dey do." Di actress say she no dey allow wetin pipo dey tok to affect her and she no dey listen to dem becos she dey focus on hersef. "I don dey di game to understand say, no mata wetin hapun, pipo go get dia own opinion. If you notice, I no dey ansa anybody, I no dey fight anybody. "I dey tell pipo say my life, I dey too interesting. I neva understand mysef finish for di tins wey I get to do. I no get di time to begin tok." According to Damasus, marriage dey end and no be today. "Pipo dey marry, marriage dey end. Nobodi follow me dey inside bedroom or parlour. I no get di energy to begin address tins,. My own na say if you wan tok beta, come my front." Wen BBC News Pidgin ask Stella Damasus if she go marry again, she say she no dey look for. "Dat one na God hand e dey o. As I dey so, I dey okay. I no dey actively look for, I don born pikin. I no want, but na God na im go decide.

Eight ogbonge health benefits of watermelon
Eight ogbonge health benefits of watermelon

BBC News

time27-07-2025

  • Health
  • BBC News

Eight ogbonge health benefits of watermelon

Watermelon na one fruit wey many pipo like well-well, especially for places wey dey hot. Pipo like am becos e get plenty water and e sweet for mouth. Watermelon na centuries old fruit wey dey juicy and sweet, and many pipo see am as perfect treat to quench thirst during serious heat. Wit bright red flesh and little seeds wey full di body, watermelon get plenty nutrients and antioxidants wey include vitamins A and C. For interview wit BBC News Pidgin, one dietitian, Sa'adutu Sulaiman for Kano state, northern Nigeria tok say "apart from say watermelon sweet, e get plenty beta health benefits." She add say all dis beta tins wey watermelon dey do na sake of di water wey full am and some special tins wey dey inside like lycopene (wey dey make am red) and citrulline. Watermelon na natural source of citrulline. Citrulline na amino acid wey fit support beta erections. Dietitian Sulaiman say watermelon na natural Viagra wey dey help men wey get low sexual performance, e dey increase blood flow to di penis, wey dey allow men to easily get erection wit arousal. "Research don show say citrulline wey dey watermelon fit help men wey get small wahala wit performance as e dey help blood flow well to di penis" she add. Health benefits of watermelon Dis na some of di health benefits wey dey inside watermelon according to Dietitian Sulaiman. Nutritional profile (per 100g of raw watermelon) Watermelon seeds dey good for eating? Health experts say watermelon seeds get less sugar and more fiber pass dia flesh. Di seed also contain citrulline. Watermelon seeds — dried or raw — dey rich in magnesium and folate, wey dey help your body work well and avoid disease. Seeds also get di types of fatty acids wey dey lower bad cholesterol for your blood and help you avoid heart attack and stroke. Research show say melons, in general, dey good for you, but we need more studies to understand how watermelon specifically affects your body.

'We don make statement wit SIN'
'We don make statement wit SIN'

BBC News

time25-07-2025

  • Entertainment
  • BBC News

'We don make statement wit SIN'

Filmmaker and entrepreneur Jim Iyke say im latest movie na di "boldest action thriller to ever come out from dis side". Iyke wey siddon wit BBC News Pidgin to tok about di new film - SIN - say, di film take three months to film for three different kontris and about 2,000 actors work for am on di set wit over 168 crew members. "Nobody go fit tok now say we no fit do am, e no be great feem but na statement and nobody go fit challenge our worth and skill anymore". Iyke tok, as e say e don make statement wit di film to showcase wetin Africa dey made of, to di world.

Meet di grandpa dem wey dey run car wash for Enugu Nigeria
Meet di grandpa dem wey dey run car wash for Enugu Nigeria

BBC News

time15-07-2025

  • Automotive
  • BBC News

Meet di grandpa dem wey dey run car wash for Enugu Nigeria

Emeka Ede, now 70 years old bin enta car wash business wen e fin work many years ago but e no see and e decide to join di group of car wash for Enugu, Southeastern Nigeria. "I be 70 years now and 42 years for car wash and e make me to dey strong, if I no work for one day, two days, I no go get myself." Dis na true life tori of one old man wit im oda colleagues about how dem dey live dia life for many years. For dis car wash wey dey along Nkpokiti road for Enugu Nigeria, na old men dey work for dia and dem dey enjoy wetin dem dey do. BBC News Pidgin enta Enugu to meet and speak to dis men to know wetin dey build and fuel dia energy for di car wash business despite dia age. Dis group of older men wey dey ova 70 and 80 years come togeda to form Ochomma association of car wash. Dem say dem dey do di car wash business to keep fit and make money to fit feed dia families. I sidon for hours wit dis men to see how dem dey operate, how dem dey get customers and run dia jobs evri day. E dey surprising to find say dis men stand for long sake of say dem gatz hustle for customers wey dem go wash dia car. All thru our stay wit dem, dem no quarrel and nobodi abuse di oda - but dem gada dey work togeda and help each oda. Mr Emeka tok say im don spend 42 years for car wash business inside Enugu wia e join im oda mates to dey wash vehicles evriday. "We get law say if you see motor wey dey come, first to rush go be di one to wash di motor. And we no dey allow all dose small boys to come here," Mr Emeka tell me. E say di work dey make am fit and im dey take am as exercise for im bodi. Anoda memba of di carwash team na Mr Ferdinand Okoye wey be 81 years old. E surprise me to see pesin of im age to dey do di car wash business but e say im like am. "For this business ehn, pipo don tell me say how I like to dey wash car for dis age. I tell dem say well, I like am," Mr Okoye tok. For Mr Okoye, e fit wash up to three to four cars in one day and dat go fit put food for im table for di day. E dey sweet Mr Okoye for belle say di work dey make am fit and di only reason im no go come work any day na if e no well. "You know say na part of exercise wey we dey do. Na im make me like dis work." Dis car wash get about ova 20 old men wey dey work for dia, and according to dem, na means to make dia daily bread and also keep dia bodi fit.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store