4 days ago
Ibom Air incident: 'Comfort Emmanson dey OK for now and in good condition'
Comfort Emmanson Bob na im go decide wetin go hapun next wit di incident wey involve her and Ibom Air.
Dis na wetin Barrister Adefunke Adewale wey be women's right advocate and one of di lawyers wey represent Ms Emmanson for her case tok.
Di incident wey don form big conversation for Nigeria and beyond and cause several reactions bin hapun on Sunday, 10 August.
Ms Comfort Emmanson bin board Ibom Air Uyo–Lagos flight and di airline bin accuse her say her conduct bin pose serious threat to di safety of dia crew, passengers, and aircraft.
Dem say Ms Emmanson bin attack dia hostess sake of say dem instruct her to switch off her mobile phone wey dey in line wit standard aviation safety procedures, wey she no gree do until di Pilot-in-Command make di announcement, afta which one fellow passenger wey sidon beside her collect di phone and switch am off. action wey lead to gbasgbos from Ms. Emmanson.
Na di video wey circulate wey di public see spark different reactions as to di conduct of both Ms Emmanson and di airline and ground staff wit di way dem handle di mata and also release di video wey show Ms Emmanson in an indecent state.
Authorities go later detain her, charge her to court and remand her for Kirikiri.
Although Ms Emmanson never tok her own side of di tori, one eyewitness bin don tok for one interview for Channels Television say dem provoke her, sometin wey her lawyer repeat.
"Comfort na pesin pikin, if na minister pikin, president pikin or senator pikin, dem for treat am dat way?
Na Comfort go tell us wia we go go from hia, she be adult, we no fit decide for am, If she decide to further file civil case, she go carri us along". Adewale tok.
Barrister Adewale and two oda lawyers Barrister Adams Atakpa and Barrister Idowu na im follow represent Ms Emmanson for court.
"I no get di direct consent of Comfort or her family to represent her, Na free work we do. I no collect any money for di work, I do wetin I do for humanity".
She say she bin go court on her own on Tuesday to see if dem fit meet di bail condition but di court reject di two sureties wey show face, say make dem bring family member wey go follow do surety for am, so dem no fit release am dat day.
"Na Wednesday morning we come hia say minister don direct make dem withdraw di case. We come court and di prosecution team withdraw di case, dem release Comfort unconditionally. No be say we no dey happy, we dey happy".
She confam say Ms Emmanson dey ok for now and dey good condition.
According to di lawyer she and Comfort do small tok tok and she say wetin hapun inside di aircraft na sake of di way di second air hostess take confront Ms Comfort provoke her to react di way she react.
She confam say two air hostess bin approach her client inside di aircraft, say one dey polite but di second one dey confrontational wen she approach di passenger.
"Di air hostess for let di girl be wen di 26 years old tell her say di phone don already dey for airplane mode and her switch off button dey bad. She no show professionalism for her work" na so she tok.
According her, after landing dem restrict di lady from disembarking and push her to one corner and allow odas to comot from di plane while dem hold her back.
According to her, for pesin wey wan file civil cases for matas like dis one, di pesin go cari di mata go high court, she go bring action for compensation wey mean say she go tok wetin she want to calm bodi, as dem don breach her fundamental human rights wey dey di kontri constitution.
She go tok her claims and court go begin di case.