8 hours ago
Canada update fields of study wey qualify for post-graduation work permits
Canada goment don change di kain education programmes wey fit give you work permit afta you graduate.
On 25 June, di Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) make some important change to di field of study wey qualify for Post-Graduation Work Permits (PGWP), so e go fit reflect dia updated labour market demands for 2025.
Dis na part of IRCC plans and priorities for Canada immigration for 2025 -2026.
Canada Minister of Immigration Refugees and Citizenship, Lena Metlege Diab, say immigration dey bring economic advantage for di kontri, but dem go work to reduce di kontri population.
"Many newcomers dey come here to build beta lives and to be part of Canada. Immigration don become economic advantage to Canada, and dat one dey come wit responsibility to maintain sustainable immigration level wey dey consistent wit our kontri community and service capacity."
For many wey wan japa go Canada through di student visa way, dis new changes go determine weda di field wey dem dey go study go fit qualify dem for PGWP.
Students for 119 new fields of study go dey eligible for PGWP, while IRCC don comot 178 fields of study from di eligibility list.
Dis new changes go affect all international students wey wan apply for non-degree programmes. Dis na programmes wey no go give you bachelor, master, or doctoral degree certificate.
E go also affect all di students go apply for study permit on or afta 1 November 2024.
If you don submit your study permit application before June 25, 2025, you go remain eligible for PGWP as long as your field of study dey di approved PGWP-eligible list during di time wey you apply, even if dem remove.
Changes to eligible fields of study
For di year 2025, na 920 fields of study dey eligible for di Post Graduate Work Permit.
Di IRCC completely remove educational programs in Transport from di current list of PGWP-eligible programmes, but dem leave only one educational programme in Agriculture, dat na Agri-food field.
Di latest eligible educational programs dey directly related to work for some key sectors wey di govment say dem experience ogbonge labour market shortage.
On di oda hand, di 178 fields of study wey no eligible again na sake of di kain work wey demd ey linked to, wey no dey experience labour shortages again.
Di 119 education programmes wey dem newly add na for fields like healthcare and social services, education and trades.
Dis na di first time wey dem dey add programmes for di education field of study to di PGWP-eligible fields of study.
Fields wey no elegible
Inside dis new change, if you wan do programmes for Agriculture, unless na for Agri-food field, you no go dey eligible for PGWP.
Education programmes wey eligible for 2025 na French language plus teacher education, biology and chemistry teacher education, computer teacher education, and drama and dance education.
Some STEM programmes sef no dey PGWP eligible again, including fields like environment, water, and natural resources, among odas.
Although di PGWP-eligible fields of study dey help immigration department give priority to students wey dey non-degree level, wey meet labour market demands for work permits, Express Entry categories dey allow IRCC to give priority to immigration candidates wey meet labour market demands for permanent residence (PR) selection.
Still, no mata which field of study pesin wan apply for, all students wey wish to get PGWP afta dem graduate, must to meet di kontri language proficiency requirements, according to di level of study.
Inside all of dis, graduates of PGWP-eligible flight schools no need to meet di field of study requirements.