2 days ago
Di Ghanaian food content creator wey wan cook food from all 54 countries in Africa
Ghanaian food content creator Abena Amoakoa Sintim-Aboagye wey dey popular as Chef Abby's dey break new grounds every day.
Di young chef wey don start to dey create content as full-time job three years ago no ever tink say she go blow like dis so soon.
"When I bin start, sometimes I go stress and create di content wey I go get small views, but I neva shake, I still push wit confidence and consistency," Chef Abby's tell BBC News Pidgin.
She add say "today, my food content dey get ova 12, 10, 9, 8 million views, and I dey get followers for all ova Africa."
As a food tourist, di young female chef wey put her engineering job for one corner, dey aspire to cook food from all di kontries for Africa.
She say through di cooking, she don dey learn about di culture of oda kontris.
"Di goal na to cook food from di 54 African kontris, so far I don cook food from 23 kontris."
For her three-year journey, she say food don carry her waka enta places she for no eva tink including being selected for di 2025 TIME magazine100 influential creators list.
Chef Abby's don cook wit influential pipo like di mayor of London Sadiq Khan and Nigerian Influencer Enioluwa.
She don also share kitchen wit Manchester City star Jeremy Doku and im family di time dem enta di kontri for May 2025.