29-06-2025
Wetin law tok about indecent dressing wey Delta police say dem wan begin collect 50,000 naira for
Di Delta State Police Command on Saturday say di state don ready to dey punish anybodi wey no dress well wit section 16 of di state VAAP law.
For dia X handle, dem post one poster of woman wey wear tank top and miniskirt wit di caption: "As you nor like wear cloth wey dey cover your body well, and you prefer dey waka go work, school or anywhere with clothes wey dey show everywhere for your body, make you hear am – Delta State government nor dey smile for that kain dressing….
"VAAP law don ready to punish anybody wey nor dress well. Punishment: Community service or N50,000 fine."
Di mata cause tok-tok among Nigerians wey see am as violation of dia human right.
Na why BBC News Pidgin check out di VAAP law wey di police command quote to chook eye for di mata.
Our finding show say di section wey di state police command quote na Economic Abuse.
Di first two subsections read:
(1) Pesin wey cause economic abuse to anoda commit offence and dey liable on conviction to a term of 3 years imprisonment or to a fine not exceeding N500,000.00 or both.
"(2) Pesin wey attempt to commit di offence wey dey provided for in subsection (1) of dis Section, commit offence and dey liable on conviction to a term of 1 year and 6 months imprisonment or to a fine wey no exceed N200,000.00 or both.
Subsections 3 and 4 no also mention anytin about indecent dressing.
We dey update dis tori