4 days ago
'Di helicopter crash against tree bifor e catch fire inside forest' - Eyewitness for Ghana plane tok how e happen
Di Ghana armed forces togeda wit oda agencies don dey investigate wetin cause military helicopter crash wey kill eight pipo.
Among di dead na two cabinet ministers, three ogbonge govment officials and three airforce crew members.
Di Defence minister Dr Edward Boamah, Environment minister - Dr Ibrahim Murtala Mohammed, Deputy national security cordonato Dr Muniru Limuna na among di pipo wey die.
Odas na Dr Samuel Sarpong wey be di first vice chairman of di govment party di National Democratic congress (NDC) and Samuel Aboagye wey be di deputy national disaster management organisation (Nadmo).
Three crew members on top di military helicopter - Squadron leader Peter Bafemi Anala, Flying Officer Twum Ampadu and Sergeant Ernest Addo Mensah.
Eye witnesses for di crash site bin dey explain wetin dem see.
One of dem na Agya Yaw wey bin explain to local media network UTV wetin im see.
"We see di plane from afar as we bin dey our farm; bifor we hear loud noise," Agya Yaw tok.
"Di plane hit some trees for di forest wey e start dey burn; na so we call di assembly man to report wetin happun."
Im add say "me and my colleagues waka through di Dampayaw forest wey we see di plane bin dey burn."
Anoda eyewitness Nana Kwame tok say "di weather don change at di time di plane bin dey come crash, na so we suddenly hear di loud noise say e crash."
Govment action afta di crash
President John Mahama bin cancel all im scheduled activities afta di incident.
In fact, im miss di programme to launch one govment initiative to deal wit illegal mining for Obuasi wia di crash happun.
Sources inside di seat of govment say di president don dey "devastated" since di crash.
Di government announce say flags gat to fly at half -mast wey dem declare three days of national mourning.
Activities for di three days
Govment inside one statement bin dey urge di public to observe di three days "with respect and dignity."
Dem transfer di bodies to Accra
Afta dem recover di bodies of di eight victims wey don burn from di crash site, di Ghana armed forces don transfer dem to Accra.
Dem organize small ceremony for di airforce base wey dem collect di remains of di eight citizens.
Dem don carry dem put di morgue for autopsy and oda analysis while govment don plead wit di families say make dem hold on wit burial arrangement until further notice.
Wit tears and pain, soldiers, top govment officials wey di chief of staff bin dey lead, don receive di bodies inside eight separate caskets wia dem use Ghana flag drape dem.
Dis na di first time wey top govment officials don die inside plane clash like dis for di kontri, for wetin dem describe now as "national tragedy".
Govment bin send various teams to visit di homes of di victims to formally announce dia death, as dem begin plans to arrange for proper burial and funeral rights.