logo
#

Latest news with #EidElKabir

Muslims around di world dey celebrate Salah festival Eid Mubarak
Muslims around di world dey celebrate Salah festival Eid Mubarak

BBC News

time3 days ago

  • General
  • BBC News

Muslims around di world dey celebrate Salah festival Eid Mubarak

All around di world, Muslim faithful dey celebrate Eid-el-Kabir wey dem also sabi as Eid al-Adha or di Festival of Sacrifice. Dis holiday na one of di most important for di Islamic faithful. Plenti Muslims sabi say di day na to commemorate di willingness of Prophet Ibrahim (Abraham) to sacrifice im son Ismail (Ishmael) as act of obedience to Allah command, but dem believe say Allah bin provide ram for di sacrifice instead. One ogbonge tin about di festival na di special prayers wey come wit feasting, and di ritual slaughter of animals such as sheep, goats, cows, or camels, especially ram. Dem go come distribute di meat from di sacrificed animals among family, friends, and di less privileged. Dem dey use dis as sign of charity, community help, and obedience to God. Across different kontris, Muslims don come out to go pray for mosque in large numbers to do special prayers. Dressed in shining clothes and colourful attire, smile full dia faces as dem greet each other. Dis na how ogbonge pictures show us how dem celebrate di Salah festival for some kontris: Why animal sacrifice dey hapun for di festival Di Muslim festival of Eid Al-Adha - or Festival of Sacrifice na to rememba prophet Ibrahim willingness to sacrifice im son Ibrahim, wey dey known as Abraham for Christianity and Judaism. Di belief be say Prophet Ibrahim bin get one dream wey e take as message from Allah, say make e sacrifice im son Ismail as act of obedience. Wen im tell im son di mesaage, Ismail bin gree and ask im papa to obey di command. As Ibrahim wan kill im son, Allah bin stop am and give am one 'ram' (sheep) to sacrifice instead. Muslims around di world for ritual dey sacrifice different types of livestock. Traditionally, di act dey compulsory if pesin get di moni wey pass im or her need.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store