logo
#

Latest news with #FederalCapitalTerritory

'I no go contest for 2027, Tinubu go win'
'I no go contest for 2027, Tinubu go win'

BBC News

time17-05-2025

  • Politics
  • BBC News

'I no go contest for 2027, Tinubu go win'

Former govnor of Rivers State and di Minister of di Federal Capital Territory Nyesom Wike don confam say e no get plans to go against im oga, President Bola Tinubu for di seat of di presidency for 2027 as e confam say e no stop being a member of di opposition Peoples Democratic Party (PDP). In di build-up to di 2023 elections, Wike bin show interest, buy form to contest to become di PDP presidential candidate but e no win di party ticket. Former Nigeria Vice-President Atiku Abubakar win am and since den, Wike don dey very open, speaking against di party leadership and oda key members say dem dey wrong as dem decide to give dat ticket to di north. Since di defeat of di party for di 2023 election, di party don witness a lot of crisis, defections and in-fighting. For inside exclusive interview wit BBC Pidgin, Wike say di party no stand a chance for 2027 if dem no put dia house in order, even as e say e no get interest to run dis time around. "I no go contest again. I no fit contest against somebody wey I dey work wit. Who go win am except am? "You dey for opposition, opposition no dey show impunity, opposition no dey show arrogance, na ruling party dey do impunity and arrogance say we dey power. "Make I ask you, who dey PDP, Achike Udenwa, former govnor of Imo, e no get one Assembly member, e no get one National Assembly member, e no give im party 3% of di vote, e dey threaten, Saba Egu, former govnor Ebonyi, e no get one assembly member, e no get one national assembly member, you no produce govnor, e dey threaten, wetin you dey threaten, you dey empty. Wetin you dey threaten?" Wike tok as e comment about di crisis wey dey di PDP. E however insist say e no go defect from di party. "I no go fit do dat kain tin, I no be fear fear man, I be weak man? how I go build house, you go come come frustrate me, make I comot, who go comot, na you go comot, I no gree you spoil house wey I build, I go dey dia." 'I want peace but na Fubara hand e dey' On di ongoing crisis for Rivers state wey lead to di suspension of di Govnor, Siminalayi Fubara, Wike say, e dey out of im hands, e dey ready for peace but na di suspended govnor dey run di show. "Dat boy na my boy, my son how I go fight battle wit am? Di pipo wey I dey fight na pipo wey wan thief wetin dem no work. President call me say make we make peace, I say oga how you go tell me make I go make peace wen I no go go. If I no wan make peace, see wia e siddon here, I siddon, some govnors, one former govnor siddon. I tell am say, yam dey for your hand and di knife. Na you know how you want di peace. If you want beta peace, you take, if you want wayo peace, ok." Wike also counter allegations say e dey play dirty politics for im own selfish political interests. "Wetin you expect pesin wey hate you to tok? You want your enemies to praise you? If e praise you e never fail? Wetin I do for my own selfish interest? My interest be say you wan kick me out of politics I say I no go comot from politics, na my selfish interest? You wan take our sometin wey we don build for years, we say no, you fit carry your governance do, na selfish interest?. Wetin I do? Say I support Tinubu? I no tok am before say I go support Southerner? So wetin I dey do wey somebody go say e no know say na so I go do am. In any case, politics na wetin? No be interest? FCT IGR increase from 9 - 30 billion monthly Since e assume office as FCT minister, Wike don commission projects - rehabilitate roads, schools and invest in security. On di issue of generating funds to fund di projects, Wike say dem bin need to look inwards to generate more revenue. "I come here August 2023, dat time, wetin we dey get na between 8 and 9 billion every month, but I sidon wit my team, we say wetin 8, 9 billion go help us do, which job, our allocation from federal government na 1%. We come say we go block dis leakages for our revenue drive, we come dey serious, you fit dey hear say I revoke dis, I do dis and dat na to get our money back so we fit do di job we suppose do. As I dey speak wit you now, we dey hit 30 billion every month from 9 billion." Wike also address some pipo wey dey compare im work to dat of former FCT Minister, Nasir El Rufai "I no dey work make dem compare me to anybody, my own be say di President Bola Tinubu come say make I work wit am, I come see say e dey sincere for wetin e tok, e come give me every support wey pesin wey give you job, suppose give you, I come say true-true, dis man want make I support make I make sure say Abuja change. Na Nigerians dey judge, na dem dey see, I never live for Abuja before. I no dey come Abuja like dat. Dat time wey dem say El Rufai dey I be chairman of council, I no dey come Abuja, e go hard me to come dey tok about comparison but all I know be say dem say El Rufai try.

Wike give conditions to forgive Fubara, five oda tins FCT minister tok for media chat
Wike give conditions to forgive Fubara, five oda tins FCT minister tok for media chat

BBC News

time18-04-2025

  • Politics
  • BBC News

Wike give conditions to forgive Fubara, five oda tins FCT minister tok for media chat

Di current Nigeria minister of di Federal Capital Territory (FCT) and former govnor of Rivers State, Nyesom Wike, don tok say im go let go of di wrong tins wey im political godson and successor Siminalayi Fubara don cause if e come ask for forgiveness. Wike tok dis one during one monthly media chat wey im do wit journalist for Abuja. According to di former Rivers state govnor, e say im go 'sincerely' forgive Fubara if e come beg for forgiveness for im hand. Wike and Fubara na two political father and son wey don look each oda eyes as dem both dey struggle for who go kontrol di policial and economic structures for Rivers State. For January 2024, di Supreme Court bin confam Fubara as Rivers State govnor afta e dismiss di appeal wey Tonye Cole of di All Progressives Congress file ova di 18 March 2023 governorship election. Since dat time, Fubara neva rest as e dey face one wahala to di oda as govnor. Key takeaways 'I bin want outright removal of Fubara' FCT minister say wetin e want na di outright removal of Fubara comot for office as Rivers govnor, instead of di suspension wey dem sama am. Wike say President Bola Tinubu do di to declare a state of emergency for Rivers state. "As a politician, I no dey happy wit di declaration of Emergency Rule for Rivers state. I want di outright removal of di governor (Fubara)." We dey update dis tori

Morocco to Build New Embassy in Abuja, Strengthens Nigeria Partnership
Morocco to Build New Embassy in Abuja, Strengthens Nigeria Partnership

Morocco World

time21-02-2025

  • Business
  • Morocco World

Morocco to Build New Embassy in Abuja, Strengthens Nigeria Partnership

Doha – Morocco's Ambassador to Nigeria, Moha Tagma, announced plans to construct a new embassy in Abuja during his meeting with Federal Capital Territory (FCT) Minister Nyesom Wike on Thursday, signaling a new inflection point in the deepening diplomatic rapport between the two countries. 'We have now signed a contract with the company that will construct the building, and we are waiting for the facilities that the FCT will provide for us in the area allocated to us for the project,' Tagma disclosed during the visit. The ambassador articulated the desire to expand collaboration beyond federal government relations. 'As you know, for many years now, our relationship is very, very excellent, and we want to develop this relationship not only at the level of the federal government but also with your territory,' he stated. Tagma projected a vision of deeper integration. Moroccan citizens in Abuja 'have considered themselves citizens of Abuja, describing it as very beautiful and one of the best capital cities in Africa,' he said. The ambassador extended a formal invitation to Minister Wike to visit Rabat. 'I want to invite you officially to Morocco. I will transmit to you the official invitation and I hope that you can pay this visit to Morocco as soon as possible. We will be very happy to receive you in Morocco, to meet your counterpart in our capital city and many members of the government of Morocco,' he declared. Read also: FM Bourita on Africa Development: We Focus on Opportunities, Not Problems Responding positively, Wike proclaimed, 'Nigeria has a good relationship with Morocco and we would like to explore opportunities on how these two cities can cooperate. It is very key.' The minister revealed he had already directed the Department of Development Control to facilitate the embassy construction project. This expanding Morocco-Nigeria partnership, anchored by the Nigeria-Morocco Gas Pipeline (NMGP) project, signifies a profound realignment of regional dynamics. Extending over 5,600 kilometers, the pipeline will connect Nigerian gas to Morocco and potentially to European markets, bypassing traditional routes through Algeria. This deepening collaboration has paralleled Nigeria's strategic recalibration on key regional dossiers. Since 2016, Nigeria has demonstrated increased alignment with Morocco's positions, no longer including references to Western Sahara in its UN statements. This shift in diplomatic posture delivers a crushing setback to Algeria's regional influence and its proxy militia, the Polisario Front. Where Algeria once wielded considerable influence, its inflexible stance and its backing of the separatist group have left both increasingly marginalized in African affairs. In recent years, Algeria has been unable to secure meaningful diplomatic support even from traditional allies like Nigeria. The NMGP project, which circumvented Algeria's longstanding role as a regional energy hub, coupled with Morocco's OCP Group's commitment to constructing fertilizer plants in Nigeria, exemplifies the tangible economic benefits of this partnership. While specific agreements and tenders are yet to be finalized, the construction phase of the pipeline project is scheduled to begin this year. Wike concluded by affirming his commitment to diplomatic relations. 'Our hope is to make sure that all diplomats in Abuja carry out their business in peace without any hindrances,' he noted. 'You will agree with me that the security has improved so much. You can see the infrastructure development going on in the city. So, we are happy to do anything that will make your stay in Abuja comfortable.' Tags: Diplomatic PartnershipsMorocco-Nigeria Relations

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store