logo
'I no go contest for 2027, Tinubu go win'

'I no go contest for 2027, Tinubu go win'

BBC News17-05-2025

Former govnor of Rivers State and di Minister of di Federal Capital Territory Nyesom Wike don confam say e no get plans to go against im oga, President Bola Tinubu for di seat of di presidency for 2027 as e confam say e no stop being a member of di opposition Peoples Democratic Party (PDP).
In di build-up to di 2023 elections, Wike bin show interest, buy form to contest to become di PDP presidential candidate but e no win di party ticket.
Former Nigeria Vice-President Atiku Abubakar win am and since den, Wike don dey very open, speaking against di party leadership and oda key members say dem dey wrong as dem decide to give dat ticket to di north.
Since di defeat of di party for di 2023 election, di party don witness a lot of crisis, defections and in-fighting.
For inside exclusive interview wit BBC Pidgin, Wike say di party no stand a chance for 2027 if dem no put dia house in order, even as e say e no get interest to run dis time around.
"I no go contest again. I no fit contest against somebody wey I dey work wit. Who go win am except am?
"You dey for opposition, opposition no dey show impunity, opposition no dey show arrogance, na ruling party dey do impunity and arrogance say we dey power.
"Make I ask you, who dey PDP, Achike Udenwa, former govnor of Imo, e no get one Assembly member, e no get one National Assembly member, e no give im party 3% of di vote, e dey threaten, Saba Egu, former govnor Ebonyi, e no get one assembly member, e no get one national assembly member, you no produce govnor, e dey threaten, wetin you dey threaten, you dey empty. Wetin you dey threaten?" Wike tok as e comment about di crisis wey dey di PDP.
E however insist say e no go defect from di party.
"I no go fit do dat kain tin, I no be fear fear man, I be weak man? how I go build house, you go come come frustrate me, make I comot, who go comot, na you go comot, I no gree you spoil house wey I build, I go dey dia."
'I want peace but na Fubara hand e dey'
On di ongoing crisis for Rivers state wey lead to di suspension of di Govnor, Siminalayi Fubara, Wike say, e dey out of im hands, e dey ready for peace but na di suspended govnor dey run di show.
"Dat boy na my boy, my son how I go fight battle wit am? Di pipo wey I dey fight na pipo wey wan thief wetin dem no work.
President call me say make we make peace, I say oga how you go tell me make I go make peace wen I no go go. If I no wan make peace, see wia e siddon here, I siddon, some govnors, one former govnor siddon.
I tell am say, yam dey for your hand and di knife. Na you know how you want di peace. If you want beta peace, you take, if you want wayo peace, ok."
Wike also counter allegations say e dey play dirty politics for im own selfish political interests.
"Wetin you expect pesin wey hate you to tok? You want your enemies to praise you? If e praise you e never fail? Wetin I do for my own selfish interest?
My interest be say you wan kick me out of politics I say I no go comot from politics, na my selfish interest? You wan take our sometin wey we don build for years, we say no, you fit carry your governance do, na selfish interest?. Wetin I do? Say I support Tinubu? I no tok am before say I go support Southerner? So wetin I dey do wey somebody go say e no know say na so I go do am. In any case, politics na wetin? No be interest?
FCT IGR increase from 9 - 30 billion monthly
Since e assume office as FCT minister, Wike don commission projects - rehabilitate roads, schools and invest in security.
On di issue of generating funds to fund di projects, Wike say dem bin need to look inwards to generate more revenue.
"I come here August 2023, dat time, wetin we dey get na between 8 and 9 billion every month, but I sidon wit my team, we say wetin 8, 9 billion go help us do, which job, our allocation from federal government na 1%.
We come say we go block dis leakages for our revenue drive, we come dey serious, you fit dey hear say I revoke dis, I do dis and dat na to get our money back so we fit do di job we suppose do. As I dey speak wit you now, we dey hit 30 billion every month from 9 billion."
Wike also address some pipo wey dey compare im work to dat of former FCT Minister, Nasir El Rufai
"I no dey work make dem compare me to anybody, my own be say di President Bola Tinubu come say make I work wit am, I come see say e dey sincere for wetin e tok, e come give me every support wey pesin wey give you job, suppose give you, I come say true-true, dis man want make I support make I make sure say Abuja change.
Na Nigerians dey judge, na dem dey see, I never live for Abuja before. I no dey come Abuja like dat. Dat time wey dem say El Rufai dey I be chairman of council, I no dey come Abuja, e go hard me to come dey tok about comparison but all I know be say dem say El Rufai try.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

All di court cases wey Senator Natasha Akpoti-Uduaghan dey face
All di court cases wey Senator Natasha Akpoti-Uduaghan dey face

BBC News

timea day ago

  • BBC News

All di court cases wey Senator Natasha Akpoti-Uduaghan dey face

Justice Idris Kutigi of di Federal High Court Abuja don order di Senate President of Nigeria, Godswill Akpabio to appear bifor am, sake of one defamation case wey Senator Natasha Akpoti-Uduaghan bin file against am. Dis na just one out of di plenty court cases wey involve Mrs Akpoti-Uduaghan, di suspended lawmaker wey dey represent Kogi Central Senatorial District for di National Assembly. According to tori by local media, Justice Kutigi bin grant di lawyer of Mrs Akpoti-Uduaghan, Victor Giwa, permision to serve Akpabio wit di court proceedings thru substituted means, since di senate president bin no show face for court on 7 May, 2025 wey di matter bin suppose start. Di Judge order Akpabio to show face for di court on Monday, 9 June, 2025. Though e neva dey clear weda dis date go get head since di Nigeria goment don declare am as public holiday for di muslim celebration of Eid-El-Kabir. Since late February dis year wen di crisis start between di female lawmaker and di senate president Akpabio, na so court cases dey pile up betwin di two. Some of dem na Mrs Akpoti-Uduaghan start am, di odas na either di Nigeria goment or Akpabio family start am. Remember say Mrs Akpoti-Uduaghan dey accuse Akpabio of sexual harrasment, wey she claim say e happen several times including for Akpabio house and for di senate premises. However, Akpabio don deny di allegations. Here na listicle of dis court cases and wetin be di issues: 350 billion naira suit by Mrs Akpabio Shortly afta Natasha Akpoti-Uduaghan accuse Akpabio of sexual harassment during one TV interview, Mrs Ekaette Akpabio, wife of di senate president, call a press conference, wia she tok say she don sue Mrs Akpoti-Uduaghan for defamation against her husband. Akpabio wife say she file two court cases - marked CV/814/25 and CV/816/25 - for di federal high court Abuja, demanding damages of N250 billion and N100 billion respectively. She tok say di allegations against her husband don cause her and her children "emotional and psychological abuse", and e don make her family to dey live for constant fear of threat to dia lives. She want make di court restrain Mrs Akpoti-Uduaghan from making defamatory statements against di Akpabio family, and for her to withdraw di allegations and tender "unconditional apology to di senate president" wey go dey published for two national newspapers. 100 billion naira suit by Akpoti-Uduaghan Natasha Akpoti-Uduaghan bin also file court case against Godswill Akpabio and imegislative aide, Mfon Patrick, wia she allege say di aide bin post one article on Facebook wey wan damage her reputation. Di Kogi lawmaker ask di court to order di defendants to pay her N100 billion for damages and anoda N300 million in litigation costs. Inside di suit, marked CV/737/25, Mrs Akpoti-Uduaghan say di post by Mfon Patrick dey "defamatory, provocative, and damaging to her reputation". Oga Patrick bin make dis post afta di wahala wey happen for di senate chambers on 21 February, 2025, wia Mrs Akpoti-Uduaghan bin para and shout for di senate president afta dem change her sitting position. Di incident wey show for national TV bin see di female lawmaker telling Akpabio say "I am not afraid of you", "I don take a lot from you. I bin no wan go public, but if you want I go let Nigerians know how you don discriminate against me, how you dey malign me..." Days later, oga Patrick den post di article on Facebook wit di title: "She di Local Content Committee of di Senate be Natasha Birthright?" Di legislative aide say Mrs Akpoti-Uduaghan dey para bicos di Senate President bin remove her as di chairman of dat senate committee. But di female lawmaker vex for di part wia Patrick say she no sabi anything about being a legislator except to dey "pancake her face and dey wear transparent outfits to di chambers." Dis remarks, she tok, "dey false and na to ridicule her, damage her credibility, and expose her to public contempt". Natasha vs Senate, Akpabio, Senate committee E also get anoda court case wey Natasha file to challenge her six-month suspension from di senate, afta a report by di senate comittee on etichs, privileges, and public petitions. Di committee bin recommend di suspension afta Natasha fail to appear bifor dem for investigation into her conduct for di senate chambers on February 21. Natasha hersef explain say she no attend dat investigation sake of say court bin don order di committee to postpone di hearing pending di determination of di matter bifor di court. But di committee members say dem no dey bound by any court order since dem dey do dia work as independent arm of goment. Dis matter on weda Mrs Akpoti-Uduaghan suspension dey valid or not, dey bifor Justice Binta Nyako of di federal high court Abuja, and e dey expected say sho go deliver di judgement dis July. AGF vs Natasha Most recently, di office of di Attorney General of di Federation file anoda court case for di Federal Capital Territory High Court, sake of allegations of defamation against di senate president Godswill Akpabio and di former guvnor of Kogi State, Yahaya Bello. For di three-count charges wey di goment bring against di female lawmaker, dem say Mrs Akpoti-Uduahan bin claim say Akpabio and Bello bin get plans to kill her, and say dis allegation na lie. According to di AGF, Mrs Akpoti-Uduaghan know or she suppose know say "dis imputations go harm di reputation of Senator Godswill Akpabio, President of di 10th senate of di Federal Republic of Nigeria, and di reputation of Yahaya Adoza Bello, former guvnor of Kogi State". Di witnesses wey di FG say dem go call for dis matter include Akpabio, Yahaya Bello and one oda senator Asuquo Ekpenyong plus three oda pipo. Dis matter suppose start on Tuesday, 3 June, 2025, but e no come go ahead bicos of strike wey di Judiciary Staff Union of Nigeria (Jusun) bin start di previous day. E never dey clear wen di new date go be.

35 people including children deported from Ireland to Nigeria
35 people including children deported from Ireland to Nigeria

BreakingNews.ie

timea day ago

  • BreakingNews.ie

35 people including children deported from Ireland to Nigeria

35 people, including five children, 21 males and nine females, were deported from Ireland on Wednesday. The children were all part of family groups, gardaí said. Advertisement They were removed on a chartered flight which left Dublin Airport for Nigeria last night. Gardaí from the National Immigration Bureau carried out the operation of removing individuals from the State. A garda statement said that they continue to work closely with the Department of Justice in implementing immigration policy.

Who be Nigerian actress Angela Okorie wey dey di centre of Nollywood drama?
Who be Nigerian actress Angela Okorie wey dey di centre of Nollywood drama?

BBC News

time2 days ago

  • BBC News

Who be Nigerian actress Angela Okorie wey dey di centre of Nollywood drama?

Celebrity life dey come wit fame, influence, money and constant public drama wey dey make dia life different from ordinary pesin. Nollywood actress Angela Okorie don dey di centre of di ongoing gbas-gbos between am, Mercy Johnson and Regina Daniels wey dey trend ontop social media. Angela recently make one post ontop social media say she don forgive Mercy Johnson, wey she bin get beef wit but Regina Daniel respond say "we no dey forgive for dis side". Na dis make Angela fire back. She verbally insult Regina Daniels claiming Regina marry her husband, Nigeria politician Ned Nwoko for money. Regina deny her claim and respond say na Angela dey beg her husband make im support am financially for her next project. Afta days of staying quiet, Mercy Johnson don tok say she go speak up for hersef and clear di air about di allegations against her. Who be Angela Okorie Angela Okorie na ogbonge musician and actress for Nollywood wey start her career as a model, bifor she break into stardom for 2009 wit her first feem 'Holy Serpent' and she don feature for several movies including 'Heart of a Widow' and 'Secret Code.' She don win several awards for di Nigeria movie industry. Angela win di 'Best Supporting Actress' category for di 2015 edition of di City People Entertainment Awards. Angela come from Enugu State, southeast Nigeria, but dem born am for Cotonou, Benin Republic, bifor she relocate to Nigeria wia she bin start to model for cosmetic brand for 2005 until she find her real passion wey be acting for 2009. Di actress get one pikin from her previous marriage wit Chukwuma Orizu. Di two dey togada for ten years bifor Angela announce her divorce ontop Instagram in 2015. She claim say her ex-husband no wan make she dey work as actress but di two still maintain dia relationship and dem still dey co-parent dia son. Beef for Nigerian entertainment industry Beef for Nigerian entertainment industry no be new tin. From music to movies, drama between celebrities don become almost as popular as di work dem dey produce. Weda na about ego, competition, betrayal, or just plain misunderstanding, beef dey always make headlines, and sometimes e dey even boost careers. For Nollywood, beef fit spark between actors, directors, producers, or even influencers. Many times, na ova who dey inside big role, who dey earn more endorsement deals, or who dey get more attention from di media. Oda times, na about personal issues wey dem bring into public space. E fit also be old friendship wey turn to enmity or comments wey pesin make for interview wey go di wrong way. Music is even dey more notorious. From di days of 2Baba vs Blackface, to more recent beef between new cats for di music industry, Nigerian entertainment industry don see im fair share of ego battles. But shey na all beef dey bad? Some pipo believe say e dey create healthy competition. Wen two top entertainers dey compete, dem dey often drop dia best work. Di fan and di industry benefit in dat manner. But beef fit lead to division as fans dey pick sides and engage in toxic trolling online.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store