14-07-2025
Body of late President Buhari dey on di way from London for a simple burial for Daura
Di body of late President Muhammadu Buhari dey on di way now as dem dey fly am in from London to Daura im hometown for Katsina state wia dem go give am simple burial.
Buhari die for one London hospital on Sunday at di age of 82.
Guvnor of Katsina State, Dikko Radda, who already dey for London wit Buhari family tell tori pipo say dem go bury am later dis Monday for Daura town, about 80 kilometres from di state capital.
Nigeria Vice-President Kashim Shettima and di Chief of Staff of President Bola Tinubu, Femi Gbajabiamila, also fly into di UK capital early Monday to accompany Buhari body home.
"I just leave im family for di hospital wia e die and di decision be say we go take im body to Daura for burial," Radda tell tori pipo.
Also in a social media post, Vice President Shettima confirm say na for Daura dem go bury Buhari.
E tok say Buhari bin die afta small sickness but e no tok di exact sickness wey e suffer from. However, Buhari bin don dey sick for many years now.
In line wit Islamic religion, dem go bury Buhari as quickly as possible for simple ceremony, according to weitn one Islamic cleric Abdullahi Garangamawa tell di BBC.
"Di only tin wey fit stop di burial of Buhari bodi today [Monday] na if im body arrive Daura for night bicos Islam no dey allow night burials. In dat case, Tuesday morning go dey ok," di cleric tok.
Tributes still dey pour in for di late army general who be one of only two pipo wey don led Nigeria two times, both as military and civilian president. Di oda pesin na former President Olusegun Obasanjo wey dey 88 years old now.
Former President Goodluck Jonathan, who Buhari bin win for di 2015 election, don describe di late leader as someone wey "dey selfless for im commitment to im duty and bin serve di kontri wit character and deep sense of patriotism".
Also, former military head of state Ibrahim Babangida, who Buhari bin overthrow in a coup in1985, shower praises on di late president..
"He na man wey, even for retirement, e remain moral compass to many, and na example of modesty for public life,' Babangida tok.
President Bola Tinubu dey expected to attend di funeral prayer for Daura, and e don declare seven-day national mourning period in honour of im predecessor.
Tinubu say di nation would pay dia final respect to di former leader wit dignity and honour, starting with bringing down all national flags to half-mast across di kontri from Sunday.
BBC Pidgin go dey bring you all di update about Buhari burial later dis Monday.