17-02-2025
How woman wey get male and female sex organs life change after she share her tori
For June 2024, BBC Pidgin tell di tori of 32-year-old Halima Sani (no be her real name) wey bin dey suffer from sexual differentiation disorder wey make her get both male and female private parts.
Sharing her tori, change her life.
One good Samaritan watch her interview and decide to pay for her operation.
Halima say her life don change now as she feel say she don become like any oda woman.
"I dey happi now because I dey feel myself like any woman."
Before di operation, Dr Aminu Mohammed wey be one of di surgeons wey handle am for Aminu Kano hospital for Kano state tok say Halima go fit live normal life afta her surgery.
"I don do over 130 of dis kain operations since 2006 and di pipo dey live normal lives after." E tell BBC Pidgin before di operation.
Sexual differentiation disorders na condition wey dey affect how male or female sex characteristics dey develop.
For now, Halima dey continue to do her grains business but dey pray say one day man go come as suitor and dem go marry and born children.
She say her dream na to "marry and born her own children."
Tori by Mansur Abubakar and Monday Idara