
How woman wey get male and female sex organs life change after she share her tori
For June 2024, BBC Pidgin tell di tori of 32-year-old Halima Sani (no be her real name) wey bin dey suffer from sexual differentiation disorder wey make her get both male and female private parts.
Sharing her tori, change her life.
One good Samaritan watch her interview and decide to pay for her operation.
Halima say her life don change now as she feel say she don become like any oda woman.
"I dey happi now because I dey feel myself like any woman."
Before di operation, Dr Aminu Mohammed wey be one of di surgeons wey handle am for Aminu Kano hospital for Kano state tok say Halima go fit live normal life afta her surgery.
"I don do over 130 of dis kain operations since 2006 and di pipo dey live normal lives after." E tell BBC Pidgin before di operation.
Sexual differentiation disorders na condition wey dey affect how male or female sex characteristics dey develop.
For now, Halima dey continue to do her grains business but dey pray say one day man go come as suitor and dem go marry and born children.
She say her dream na to "marry and born her own children."
Tori by Mansur Abubakar and Monday Idara

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
09-03-2025
- BBC News
Wetin pipo wit ulcer, diabetes, hypertension fit chop and no fit chop during Ramadan
Ramadan na holy month wey Muslims all ova di world dey observe by fasting from sunrise to sunset. But if you get diabetes, high blood pressure (hypertension), or ulcer, fasting fit dey hard for you. Despite di health challenges, pipo wit dis kain condition always still dey try to fast during Ramadan. Technically, dis kain pipo dey exempted from fasting until dem get beta, even though fasting dey among di five pillars of Islam and e dey veri important to di faith. Di Qur'an tok clearly for verse 185 of chapter one Surah Al-Baqarah say pipo wey dey sick or dey on a journey during Ramadan fit make up di fast for anoda time - but wit proper planning, advice from doctor, and correct eating habits. Dr Abdulmalik Ibrahim wey dey work for Gwarzo general hospital for Kano tell BBC Pidgin say pesin fit still fast and enjoy di spiritual blessings of Ramadan even say some risk dey. Ulcer and fasting Dr Ibrahim tok say ulcers dey happun wen too much acid or one infection (H. pylori) dey wound di stomach lining. If pesin dey fast, di stomach go still dey produce acid even wen food no dey, and e fit make ulcer pain worse. Dr Ibrahim say di possible risks wit fasting wit ulcer include: Who fit fast? Who no suppose fast? Dr Sa'adatu Sulaiman wey be dietitian and also dey work for Kano State Primary Healthcare Management Board tok about food wey good and bad for pipo wit health issues. Foods wey pesin wit ulcer fit chop for Ramadan Foods wey pesin wit ulcer no fit chop for Ramadan Hypertension and fasting Hypertension (high blood pressure) fit dey affected by di food wey pesin chop, water level, and stress. Fasting fit get good or bad effect, depending on di pesin condition. Possible risks Who fit fast? Who no suppose fast? Foods wey pesin wit hypertension fit chop for Ramadan Foods wey pesin wit hypertension no fit chop for Ramadan Diabetes and fasting Diabetes na one medical condition wey mean say too much sugar dey inside blood. Fasting fit come wit some risk like hypoglycemia, hyperglycemia, dehydration, or even serious wahala like hyperosmolar hyperglycemic state or diabetic ketoacidosis for pipo wey get diabetes. Who fit fast? Bifor pesin wey get diabetes go fast, e must first tok wit doctor. Di pipo wey fit fast na: Who no suppose fast? How you fit manage diabetes during Ramadan fasting If you get diabetes, fasting fit dey tricky, but you fit manage am well: Both Dr Ibrahim and Dr Sulaiman don give advice and some guidance wey fit help pipo wit dis kain sickness wahala for Ramadan. Below na di advice wey dem give; General ddvice for safe fasting Always dey monitor: Consult your doctor Final verdict: who fit fast?


BBC News
17-02-2025
- BBC News
How woman wey get male and female sex organs life change after she share her tori
For June 2024, BBC Pidgin tell di tori of 32-year-old Halima Sani (no be her real name) wey bin dey suffer from sexual differentiation disorder wey make her get both male and female private parts. Sharing her tori, change her life. One good Samaritan watch her interview and decide to pay for her operation. Halima say her life don change now as she feel say she don become like any oda woman. "I dey happi now because I dey feel myself like any woman." Before di operation, Dr Aminu Mohammed wey be one of di surgeons wey handle am for Aminu Kano hospital for Kano state tok say Halima go fit live normal life afta her surgery. "I don do over 130 of dis kain operations since 2006 and di pipo dey live normal lives after." E tell BBC Pidgin before di operation. Sexual differentiation disorders na condition wey dey affect how male or female sex characteristics dey develop. For now, Halima dey continue to do her grains business but dey pray say one day man go come as suitor and dem go marry and born children. She say her dream na to "marry and born her own children." Tori by Mansur Abubakar and Monday Idara


BBC News
10-02-2025
- BBC News
'I no fit poo-poo from di normal place again after my colostomy surgery sake of cancer'
"Di first time di doctor tell me say, I go dey poopoo from my stomach, e no really explain wetin e mean to me". Na so 21-year-old Oluwasina Tobiloba Elizabeth wey be Rectal Cancer Signet Ring Adenocarcinoma survivor tell BBC Pidgin. She share her tori for one interview wia she dey emotional, cry as she remember her journey to survive di cancer. Dem diagnose Tobiloba wit Rectal Cancer, Adenocarcinoma for March 2022. Di first tin her doctors bin do den na surgery. "E just tell me say I go dey pass out waste product from my stomach. I look myself and I tok to myself say, e don over, bicos how pesin go dey poopoo from stomach?" Tobiloba say di cancer bin bring serious stagnation, wey dey life threatening. "E get time wey I bin wan commit suicide, I bin don buy rope. Sake of say my mates don enta school already and me I dey house. She tok as she cover her face dey cry". During di first surgery, doctors no dey able to remove di tumour for Tobiloba bodi sake of di size. "Di tumor big sotey, e attach imsef to plenti organ for my bodi, so e go cost me my life to penetrate." She say doctors den bring out machine to do colostomy for her. Colostomy na surgery to create opening for di colon (large intestine) through di belle. According to John Hopkins medecine, colostomy fit be short-term (temporary) or long-term (permanent). Tobiloba colostomy na permanent one. Chemotherapy and more surgery Tobiloba bin start her Chemotherapy around April 2022 afta di first surgery. She say she bin do di first six courses but improvement no dey. Improvement no still dey afta she do anoda six course. Dat na wen she come arrange for her third surgery for February 2024. Dis time around, doctors bin dey able to comot di tumor during di third surgery but dem no dey able to reverse di colostomy for Tobiloba bodi. E mean say her colostomy na permanent one,- "I go dey poopoo from my stomach for di rest of my life," di doctors seal her anus. "Wen dem tell me say I no go dey fit defecate from my anus again, e bin dey heart breaking". Tobiloba further explain say doctors bin don seal her anus and rectum wen dem dey do her di colostomy. "Di nerves wey pesin dey feel say I wan poopoo, dem don remove everitin. My daily life wit Colostomy na say, If I wake up for morning, I go poopoo, I go go toilet go comot di poopoo from di bag and seal up di bag." She say if she no poopoo, she go fart, sake of say she dey fart through di colostomy too. Di condition don make Tobiloba separate from pipo.- She say she no wan mingle wit pipo sake of say she no wan make pipo sabi say somtin dey her bag. "I see say dat na di stigma wey colostomy put for my bodi." Tobiloba say now, she don dey try mix wit pipo. Wetin be Rectal adenocarcinoma Rectal adenocarcinoma na di most common type of rectal cancer and na one type of colorectal cancer. E dey start form cell wey dey produce mucus of di rectum lining, according to Cancer centre. How e dey develop Rectal cancer dey usually begin as polyp, wey be small growth for di rectum lining. Some polyps be adenomas, wey be pre-cancerous growths. As time dey go, adenoma fit develop into adenocarcinoma. Symptoms Symptoms of Rectal adenocarcinoma include: Risk factors Di risk factors include: