logo
#

Latest news with #JosephKwadwoBaduBoateng

'Dada Joe Remix', Kofi Boat and 8 oda Ghanaians dey face charges of wire fraud, money laundering for US
'Dada Joe Remix', Kofi Boat and 8 oda Ghanaians dey face charges of wire fraud, money laundering for US

BBC News

time12 hours ago

  • BBC News

'Dada Joe Remix', Kofi Boat and 8 oda Ghanaians dey face charges of wire fraud, money laundering for US

Di Federal Bureau of Investigation (FBI) for di United States of America bin dey pursue at least eight Ghanaians wey dem allegedly dey involved for some crimes against old American citizens. For di latest press release to celebrate World elder abuse awareness day, di US attorney general, Pamela Bondi tok say dem dey "pursue everybody wia dey involve for transnational schemes wia cost billions of dollars, wey be how dem dey steal moni from old pipo." "For di last few weeks alone, investigators and prosecutors don arrest wia dem file cases against foreign fraudsters wit domestic actors wey bin dey help di foreign-based crimes," di statement on top di US deportment of justice website tok. Di Attorney general office tok say dem dey work wit "domestic law enforcement and dis counterparts for oda kontris to find dis criminals to face justice." Some of di crimes dem tok say dis pipo don commit dey involve romance scam, lottery fraud and grandparent scams. 'Dada Joe Remix' dey face extradition to di US afta dem arrest am for Ghana Di US department of justice tok say dem file case against Joseph Kwadwo Badu Boateng wia pipo for Ghana sabi as 'Dada Joe Remix'. On 30 May, one jury for di district of Arizona bin charge am wit conspiracy to commit wire fraud and conspiracy to commit money laundering. According to court documents dem bin dey dis fraud business between 2013 to March 2023, when Boateng and oda pipo wia im dey work wit, don do romance/inheritance scheme wey target elderly American pipo. Di pipo im dey work wit (co-conspirators) bin "use false means say dem get gold and oda jewels na so to release dis tins, dem gat to pay taxes and oda moni; dat be how dem dey collect victims dia moni." Authorities for Ghana bin arrest 'Dada Joe Remix' on 30 May 2025, wia dem extradite am to di US on di request of American authorities. Na FBI wey investigate dis mata. 'Dada Joe Remix' na popular pesin for Ghana wia pipo for di entertainment industry dey describe am as "business mogul and philanthropist". Im dey associated wit plenty of di entertainment industry pipo like Shatta Bundle, Showboy, Abutrica and odas. Im dey flaunt luxury cars and oda properties wia dem tok say im allegedly dey involved in real estates, oil and gas among odas. For September 2024, many of di kontris celebrities don attend di funeral of im papa for Accra, na ogbonge funeral. Isaac Kofi Oduro Boateng alias 'Kofi Boat' and three odas chop arrest Tori be say authorities for Ghana bin arrest Kofi Oduro Boateng (Kofi Boat), Inusag Ahmed, Derrick Van Yeboah and Patrick Asare for dia alleged role for one ogbonge million dollar fraud mata wia involve wetin dem describe as Business Email Compromise (BEC) and romance scam. Di arrest wey happun on 13 June 2025, afta di kontri interior ministry don secure warrant for di district court for Accra, na part of joint Interpol and FBI operation afta US indictment charge dem wit wire fraud and money laundering. Inside one letter from di Interior ministry to di district court, dem tok say "di arrest na in line wit extradition request by di US thru di foreign ministry." Kofi Boat bin chop accuse say im na kingpin of one cybercrime syndicate wia bin dey operate for Ghana between 2016 - 2023, wia dem bin dey use spoof emails and forged letters to impersonate pipo to defraud dia victims. One court for Accra don demand di suspects on 16 June, na so dem dey begin di process to extradite dem to di US to face prosecution. Kofi Boat also bin dey associated wit top celebrities for Ghana, wia dem don dey call am business mogul and entrepreneur. Im too dey live luxury life wia im get plenty cars. Dancehall artiste Shatta wale say Kofi Boat na im godfather. Im bin roll wit am wia im tok for many videos in di past how Kofi Boat don help am for im career. But afta tori about di fact say dem arrest am don comot, Shatta Wale do one video wia im tok say make pipo no use di mata tok say im (Shatta Wale) na fraud boy. "Make una no watch my life and link me wit any bad case. I be clean pesin; na so every foreign authorities come dis kontri dey do dia research, i neva make my moni thru fraud." Shatta Wale add say "even dis my rolls Royce wey i buy, dem research am, wia dem sabi di moni i take buy am, na music moni. I neva be fraud boy." Dwayne Asafo Adjei and five odas dey face charges of wire fraud and money laundering On 4 June 2025, di US attorney office bin charge Dwayne Asafo Adjei, Nancy Adom and Eric Aidoo wit alleged fraud and money laundering conspiracies. According to court documents for di Northern Ohio District, from December 2017 to March 2024, dis pipo bin use different wire fraud and Romance fraud scams to target old Americans. Dem use dis scams take collect plenty money from dia victims by "false pretences wia dem share di money wit oda pipo for Ghana and elsewhere." Na so did FBI investigate dis mata wia dem dey prosecute dem. Di same Dwayne Asafo Adjei and Hannah Adom dey involve for anoda case of fraud. Na so for May 13, di US attorney office charge di two or dem togeda wit Otuo Amponsah, Anna Amponsah and Portia Joe for di role dem bin play for di fraud and money laundering case. Di US say dem go kontinu to pursue pipo wia don dey defraud dia citizens of dia money and properties due to dis kind scams. Ghanaian socialite 'Mona 4 Real' don return home afta she serve one-year jail-term for di US One court for di United States bin jail Ghanaian social media influencer and musician Mona Montrage for one year for 2024. Dis na afta she plead guilty say she receive proceeds from ogbonge romance scams for di US. For February 2024, Mona, wia her stage name be 'Mona 4 real' admit to conspiracy to receive moni wey dem tiff and also laundering moni from romance scams, bifor di US magistrate Sarah Cave. Na so she don spend one year inside jail for di US. For May 2025, Mona don return to Ghana afta she serve di one-year jail term. Pipo bin day suspect if she day connected to di latest arrests wia dey happen for di kontri but di social media influencer and musician don bounce back. She already release song wia she sing about di fact say if Pesin fall, dem gate to rise again - she use her experience for jail to produce di song wit she don shoot music video already.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store