Latest news with #JuliusAbure


BBC News
23-07-2025
- Politics
- BBC News
Datti-Ahmed and Abure reconciliation - wetin be di next tin for Peter Obi?
New tins wey be like say drama wan start don begin happun for Labour Party. Di vice presidential candidate of di Labour Party for di 2023 election, Senator Yusuf Datti Baba-Ahmed, bin attend one National Executive Committee (NEC) meeting wit Julius Abure wia e say e wan reconcile all parties. Baba-Ahmed say im oga wey be di Labour Party presidential candidate for 2023, Peter Obi dey aware of im presence to di Abure-led NEC meeting. Dis na afta several kasala don rock di Labour Party since di 2023 elections bin end wit different factions from Abure and also Senator Nenadi Usman. Na di different factions within di Labour Party di Vice presidential candidate Baba-Ahmed bin tok say im wan bring togeda. During di meeting, Datti show support for di Abure-led leadership of di Labour party - e tok say im mission na to bring evribodi for di party togeda. "Labour Party no be party to waka away from. To di best of our knowledge Peter Obi na still member of Labour Party. Dis party no be one to abandon and I wish to reconcile all parties " Datti also tok say im and im oga, Obi dey solidly togeda and di tok about coalition no be threat as dem no be member of any political party wey dem form. Howeva, di Labour Party chairman Abure say anybodi get right to join oda political parties but e gatz dey according to di constitution. "Evri Nigerian get di right to belong to any political party of dia choice. Anyone wey feel say dem wan dey wit any group, na dem get di choice but di constitution of di party dey clear say you no fit belong to two political parties at di same time." Obi and Abure no be padi padi for now, sake of di different kasala wey dey rock di party. Meanwhile, Senator Nenadi Usman wey also dey lay claim as di Interim National Chairman of Labour Party, say di decision of Datti dey personal to am. According to di statement by Ken Eluma Asogwa, Senior Special Adviser on Media, to Nenadi, e allege say di court no recognise Abure as Labour Party chairman, but rather, na she be di chairman of di party. Although dis na part of di wahala wey di labour Party dey face, Senator Nenadi say e no dey right for Datti to refer to Abure as di party chairman, and dat evri member of di Labour Party gatz follow wetin di court rule. "While di party respect di right of Dr. Baba-Ahmed and oda members to hold personal views, e dey important to rememba say di acceptance of di judgements of di Supreme Court no be mata of choice but e dey compulsory." Senator Nenadi say e good say Datti wan reconcile all parties back to di Labour Party but e gatz dey according to di 'respect for di rule of law and existing legal realities.' Di gbas-gbos for Labour Party no be today e just start. For 4 September 2024, one faction of LP hold NEC meeting for Umuahia, di Abia State capital, wia dem announce madam Usman and 28 odas as membas of di new caretaker committee wey go handle di affairs of di party. Meanwhile, anoda National Convention bin don happun bifor for Nnewi, Anambra State for March 2024 wia dem put Julius Abure to remain as di party chairman. Di mata later go court, and still, both factions dey claim say na dem be di chairman of di party. And even Peter Obi no too show full support for wetin dey happun for di party. For July 2025, Peter Obi say e dey ready for coalition wey go always put Nigerians first for all dia decisions. Even as Labour Party give am 48-hours make e resign from di party sake of im decision, Obi say to join coalition na deep reflection for am and e go do evritin wey go move di kontri forward. How Obi and Datti become 2023 flagbearer for LP Peter Obi and Datti Baba-Ahmed na Labour Party candidate for 2023 elections, and since den, dia mata dey enat each oda. Labour party reveal Datti as Peter Obi running mate for Friday, 9 July, 2022, bifor di presidential election. Senator Datti come from a very popular family wey comot from Zaria, Kaduna State inside northwest Nigeria, and na part of wetin make am bring am on board be dat. Senator Datti Baba-Ahmed follow BBC tok for one interview wia e say di reason why e accept to be Peter Obi running mate na sake of say dem get di same principle. Dat time Baba-Ahmed, say e decide to join Labour Party becos of im stand on corruption. "Di main reason why I decide to run with Peter Obi na sake of say we wan rescue Nigeria." E tok dat time. As at dis period, Peter Obi neva react to Datti decision to support one faction of di party and e neva also tok anytin about Labour Party decision ontop coalition mata.


BBC News
04-04-2025
- Politics
- BBC News
Julius Abure and senator Nenadi Usman lay claim to victory afta Supreme Court judgement on LP
Different interpretations don dey on di judgement wey di Supreme Court give on di leadership of di Nigeria Labour Party. While one faction of di Labour Party tok say di ruling of di Supreme Court affirm Julius Abure as di National leader of di party, di oda faction wey dey loyal to di caretaker committee dey of di position say di ruling sack Abure as di national chairman of di party. On Friday, 4 April, di apex court bin set aside di judgement of di Court of Appeal for Abuja, di kontri capital wey recognise Julius Abure as di National Chairman of di party. One five-member panel of di Supreme Court togeda agree say di Court of Appeal no get di right to pronounce Oga Abure as di national chairman of di LP, since e know say koko of di case na about di party leadership. Di apex court dey of di position say di issue of leadership na internal affair of a party and di courts no get authority to shook mouth for di mata. Di National Publicity Secretary of di Labour party Obiora Ifora for one statement afta di apex court judgement explain say Julius Abure remain di National Chairman of di Labour Party and dat na di position of di Supreme Court. E say di supreme court judgment no sack Oga Abure instead e hold di judgements of di high courts and appeal court wey give di responsibility of di party structures to choose dia leaders. "Di Supreme Court insist say di lower courts no suppose rule on di leadership of a political party. Di court therefore strike out Senator Nenadi Usman appeal for di appeal court plus di Labour Party suit for di trial court." Oga Ifora add say di leadership of di party dey satisfied wit di judgement of di apex court wey further reaffirm Julius Abure as di national chairman of di Labour Party and di current national working committee as validly elected as dem dey duly nominated, endorsed, and ratified through di internal mechanism of di Labour Party statutory organs in line wit di party constitution. E call on all true members of di party to obey di judgement of di apex court, and say make dem always resort to internal party mechanism in resolving party affairs make dem no all di time dey run go court. "Na only di political parties get di powers to choose dia leaders no be di courts," Ifora tok. Meanwhile, Labour Party Caretaker Committee wey one former Minister of Finance, Madam Nenadi Usman dey head no reason am like dat. Madam Usman for statement hail di judgement as she say dis na time to move di party forward. "E dey important to emphasize say dis no be time to dey jubilate — victor no dey and no vanquished. Wetin mata most na our shared commitment to di ideals and aspirations of di Labour Party plus di Nigerian pipo. We must now come together, united in purpose and vision, to move di party forward." Also one Obedient movement hope say di supreme court judgement go mark di end of di long leadership crisis within di party. For statement wey di tok-tok pesin Obi-Datti Campaign Team Nana Kazaure issue, e say dem choose to embrace di "no victor no vanquished position, as dem recognise di contributions of Abure National Working Committee to di growth of di party and dia sacrifices especially during di 2023 election." For January, di Court of Appeal for Abuja bin rule say Abure remain di chairman of di Labour party. One three-member panel of di appellate court, for one judgment wey Justice Hamma Barka deliver hold say dia judgment of November 13, 2024, wey recognise Abure as national chairman, remain and no court don change am. Justice Barka bin make di declaration as e dey deliver judgment for two separate appeals wey senator Esther Nenadi Usman plus di caretaker committee and di Independent National Electoral Commission (Inec) file. Di appellate court for di two separate appeals hold say dem no put hand for di issue of di leadership of di Labour Party bicos dem no dey carry dos kain mata come court.