3 days ago
Court tell Senate to recall Senator Natasha Akpoti-Uduaghan to kontinu her work
Di court don order di Senate to recall Senator Natasha Akpoti-Uduaghan back to her legislative duties.
Justice Binta Nyako of the Federal High Court for di judgement dem tok say her six months suspension dey too much.
According to di section 14(2) of di Privileges Act of di Senate, suspension dey in default.
Di judgement add say constituents no suppose dey witout representation and make Senate review dia laws on suspensions.
Meanwhile, court bin find Senator Natasha in contempt of court, sake of di satirical apology wey she bin post for her Facebook page.
Justice Binta Nyako fine am five million naira ($3,266), wey she go pay into di court registry.
Court also order her to publish a formal apology for her Facebook page and for two national newspapers.
She must to do dis within seven days of did ruling.