logo
#

Latest news with #JusticeEmekaNwite

Owo attack suspects trial dey set to begin after three years
Owo attack suspects trial dey set to begin after three years

BBC News

time2 days ago

  • Politics
  • BBC News

Owo attack suspects trial dey set to begin after three years

Court for Abuja don fix August 19, 2025 to start di trial of di five suspects wey dey face accuse say dem bin St. Francis Catholic Church, Owo, Ondo state , South-West, Nigeria. Di five suspects dey face nine count charges of terrorism sake of say dem be di suspects wey bin attack Saint Francis Catholic Church for Owo, Ondo State for 2022. Na ova 40 worshippers bin die for di bombing attack wey wound plenti pipo wen jaguda pipo bin attack di church during Sunday mass. Nigeria govment also accuse dem say dem be members of di Al-Shabab terrorist group wey get branch Kogi State. Di suspects plead not guilty to di nine counts of terrorism wey Nigeria goment sama dem. Justice Emeka Nwite of di Federal High Court, Abuja wey preside ova dia arraignment on Monday 11 August, order di suspects to dey for di Department of State Services [DSS] hand. Dis na di first time dem dey arraign di suspects for court since 2022 and na three years afta di Chief of Defence Staff, General Lucky Irabor bin tok say dem arrest dem. Di National security Council bin link di attack to collabo wit Islamic State West Africa Province [Iswap]. Former Govnor of Ondo State, di late Rotimi Akeredolu, wey be govnor dat time bin describe di attack as crime against humanity. Im bin tok say di attack, even though e dey terrible, no go stop di indomitable spirit of di pipo of di state as dem dey try to fight insecurity. Di Owo massacre E go hard for pipo to forget di massacre wey happun for Owo, Ondo state south-west Nigeria on Sunday June 5, 2022. Some jaguda pipo carry gun enta di town and attack St Francis Xavier catholic church during Sunday mass. Di Pope dat time, late Francis and former President of Nigeria, late Muhammadu Buhari bin condemn di attack. Police for di state say dem bin don begin investigate di mata and e no tey dem arrest dis suspects wey show face for court.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store