3 days ago
Meet one of Nigeria e-gamers wey dey make millions from online gaming
"Wen I start gaming, my mama no gree until I give her cheque of one million."
Young professional gamer Ayere-Victor Great Ehinome wey pipo sabi as Khalamanja tok to BBC News Pidgin on how e start im journey to be di biggest gamer for Africa and di challenges wey come wit am.
E say gaming industry dey contribute to di society and na safe haven for young pipo.
"I no go lie, wen I start gaming my mama no first gree. She first hold me for neck say go to school do accounting.
"Not until I dey do my gaming content creation. I come make small money, I come give my mama cheque of one million. Na dat time my mama come say okay, dis gaming e be like say you go put bodi properly."
Khalamanja become di first Red Bull Nigerian athlete and e don make am go viral for Africa.
To dey strong for gaming for Nigeria, network dey important and Khalamanja say dem dey struggle.