Latest news with #LagosState


BBC News
26-06-2025
- Politics
- BBC News
Lagos state respond to Peter Obi on demolition of im brother property
Di Lagos state goment tok say dem no get hand for di demolition of property wey belong to di brother of di former Anambra state govnor and di candidate of di Labour Party for di 2023 elections Peter Obi. Di state commissioner for information Gbenga Omotosho give di informate afta Oga Peter Obi raise alarm say some pipo invade im younger brother company property wey dey located for Ikeja area of Lagos state, and dem demolish am. For one statement e post on X on Wednesday, di Labour Party presidential candidate bin lament how some pipo bring down im brother property without permit or court order. Although, e no mention say na di state goment demolish di property, however, some pipo however don drag di goment say na dia handwork. Dis na becos di state goment recently begin demolish some structures wey dey dem claim say dey illegal, shanties, and unapproved buildings for Ikeja Government Reserved Area (GRA). Dem cite mounting security threats and violations of urban planning regulations as reasons for di demolition. However, to clear dia name from dis particular one, di state goment for statement say Lagos State Building Control Agency (LASBCA) or any oda arm of di Lagos State Government no carry out di said demolition. "Dr Olajide Abiodun Babatunde, Special Adviser, eGIS and Urban Development, wey dey supervise LASBCA, don confam say di agency no get and for di demolition. We find am disturbing say Peter Obi go make such allegations without verifying di facts. Dem no serve anybody, dem no write any name, yet dem show up wit excavators begin destroy structure - Peter Obi On Wednesday, Oga Obi for im X handle bin lament about di state of lawlessness for di kontri, as share informate on how some pipo demolish im younger brother property company without court order or permission. Di former Anambra state govnor wey share fotos of di demolished structure say all effort to know who dey responsible for di action no yield any result. E say di excavators wey im meet for di site of di demolition tok say na pesin send dem, wen im request to see di pesin wey send dem, nobody show up afta im wait for more dan 5 hours. E add say di property don dey di area for ova 15 years. "I rush go Lagos from Abuja afta di call dis morning and head straight to di property. As I reach there, I meet security pipo wey try to stop me make I no enta. I beg dem say di property na my brother company, and for di records, di company don get di property for ova 10 years. "Dem tell me say dem get court judgment, and I immediately request for am. You no go believe say di court judgment dem claim say dem get dey issued against an unknown person, and squatters. I ask about demolition order or permit, dem no get. "How you go sue unknown pesin? How court dey take issue judgment in such a farce of a case? Dem no serve anybody. Dem no write any name. Yet dem show up wit excavators and begin destroy structure wey don stand for ova 15 years. Lagos goment order investigation into di mata Di Lagos state goment say dem go investigate di mata - dem deny di accuse say dem no touch Peter Obi younger brother property. Di goment say dem don direct di Permanent Secretary, Office of Urban Development, Gbolahan Owodunni to carry out full investigation for di mata. "Dis investigation go help clarify di circumstances surrounding di demolition and ensure say dem take any necessary." Di commissioner tok for di statement. For May, di Lagos state goment begin demolish illegal structures for Ikeja GRA, dem demolish shanties plus unapproved buildings, sake of security and planning concerns. Di exercise, wey di Permanent Secretary of di Lagos State Building Control Agency, Gbolahan Oki lead bin target areas wey violate building regulations, di goment tok for statement. Oga Oki say some property owners get valid approvals but dem violate building terms sake of say dem convert structures from di original plan to anoda thing. For instance, dem go turn four flats to eight flats, thereby straining infrastructure and distorting di urban plan, e add. LASBCA Permanent Secretary tok say di agency don earlier issue letters to all property owners for Ikeja GRA, and ask dem to submit dia building approvals for verification. E explain say di enforcement exercise follow adequate notice and engagement wit stakeholders, and dia aim na to remove shanties, makeshift stalls, and unauthorised structures wey dey linked to illegal activities for di area, in order to restore safety, order, and proper urban planning.


Bloomberg
30-05-2025
- Business
- Bloomberg
Nigeria Plans $464 Million Waterway Boost to Ease Lagos Traffic
The state housing Nigeria's economic hub is engaging the European Union to develop inland waterways as part of an integrated urban-transport system intended to ease gridlock in Lagos, which is also its most populous city. They are due to break ground on the €410 million ($464 million) project in June, the Lagos state government said in an emailed statement Friday.