15-07-2025
'I belong to nobody, my wife belong to my kitchen and di oda room' - Some popular quotes of Buhari wen e bin dey office
Former president Muhammadu Buhari die on 13 July for one hospital in London. Nigerians dey mourn di death of di ex-president wey serve di kontri twice in 1984-1985 as military general and serve as democratic elected president for eight years 2015- 2023.
Wit so much excitement in di faces of di pipo, Nigeria former president Buhari finally win di presidential seat in 2015, afta three attempts.
During im inaugural speech im promise to fight corruption and restore di Nigeria economy.
During im eight-year tenure hia na some of di funny and popular comments im make during im time for office.
Lazy Nigerian youths
Many pipo bin criticise dis comment wey Buhari make during im appearance wit world leaders for one Commonwealth Business Forum in London in April 2018.
E say: "More dan 60 percent of di population dey below 30, a lot of dem no go school and dem dey claim say Nigeria na oil producing kontri, therefore, dem go sit and do nothing, and get housing, healthcare, education for free"
Di late President bin don make similar comments for one interview wit di UK Telegraph, wia e tok say most of di Nigerians youths wey dey seek asylum for di UK na di lazy ones wey dey disposed to criminality and say make di UK goment no dey grant dem asylum dia.
Pipo start to dey trend di hashtag #LazyNigerianYouths on social media to show dia works and protest against wetin di President tok.
I belong to evribody and to nobody
Buhari bin tok dis one during im swearing in as president in 2015, for di Eagle Square for Abuja.
E tok dis one to clarify say im no go look anybodi face for im fight against corruption, no matter di region wia di pesin come from.
"I intend to keep my oath and serve as President to all Nigerians. I belong to everybody and I belong to nobody," e tok dat time.
My wife belong to my kitchen... and di oda room
During one joint confrence wit di former German Chancellor, Angela Merkel for Germany in 2016, former president Buhari bin dey ansa question from one tori pesin wey ask am which political party wey im wife belong.
Dis question na sake of interview wey Aisha Buhari bin grant BBC News Hausa wia she claim say some cabal don hijack Buhari govment, and say Buhari no know many of di pipo wey dey serve for top positions for di kontri.
As di tori pesin ask di question, Buhari respond say: "I no know which party my wife belong to, but she belong to my kitchen and my living room and di oda room."
Baba go slow
Buhari tok dis during one meeting wit di Nigerian community for di United States of America during di 73rd United Nations General Assembly for New York.
Buhari bin tok say im adminstration go keep dia promises to di pipo depsite say opposition dey accuse am of moving slowly to fight corruption.
"Dem dey call me Baba Go Slow. Pipo wey dey go fast, wia dem go?" e tok dat time as di audience burst out laff.
Corruption na cancer
For 2016, wen Nigeria dey celebrate dia 56th idependence day, Buhari bin tok say corruption na cancer charging all judiciary make dem fight am.
E say: "Corruption na cancer wey we must fight wit all di weapons for our disposal. E dey destroy every fabric of goment and destroy society.
"Fighting corruption na key, no be to only restore di moral health of di nation, but also e go free di plenti resources wey we get for urgent socio-economic development."
Jubril of Sudan
In 2018, one rumor start to dey fly around say di main Buhari don die, and say di pesin wey dey rule Nigeria na one clone wey look like Buhari but di pesin real name na Jubril from Sudan.
During one visit to Poland, Buhari as e dey address di Nigerian community for dat kontri address di rumour as e tok say e still dey alive.
''Na real me (be dis), I assure you. I go soon celebrate my 76th birthday and I still dey go strong," Buhari tok.
"Pipo bin hope say I go die during my sickness. Some even reach out to di Vice-President to consider dem to be im deputy becos dem assume say I go die."