11-06-2025
Airpeace condemn 'top' politician wey disturb travellers for airport
Video wey dey circulate online show di back view of one pesin wey resemble Nigerian politician, Senator Adams Oshiomole as im barricade di check-in entrance of di Murtala Muhammed Airport Terminal 1 (Zulu Hall) on Wednesday morning.
Tori be say di politician forcefully block di entrance to di Zulu Terminal of di General Aviation Terminal (GAT) afta e arrive late at di terminal afta di scheduled departure time of im flight.
Airpeace schedule di flight from Lagos to Abuja for 6:30 am on Wednesday morning but di politician no meet up wit di time.
Inside di video, e begin dey call for di intervention of top officials from di airline. Although, di video no dey audible but di politician follow one official tok for di check-in entrance about im experience
While di entrance to di check-in remain closed and travellers remain stagnant on di queue, dem no fit move forward for dia boarding.
According to Airpeace statement on Wednesday, di airline tok say one prominent Nigerian politician disrupt dia airport operations afta im miss di flight scheduled for 6:30 am on Wednesday morning.
Di management of Airpeace tok say di politician arrive around 6:10 am for im boarding but di boarding process don close and di flight don dey set to fly.
Di airline tok say di politician resort to violence and physically assault dia staff and e even go as far as stopping dia passenger from gainning access to di terminal.
"Di prominent individual in question arrive for Murtala Muhammed Airport Terminal 1 (Zulu Hall) at approximately 06:10 AM for Flight P47120 wey don dey schedule to depart Lagos for Abuja at 06:30 AM. In line wit our standard on-time departure policy, di boarding process don close, and di flight depart as scheduled," di statement tok.
"Upon being inform of di missed flight, di politician resort to violence, physically assaulting our staff and forcefully barricade di terminal entrance. Im go as far as closing di entry gate and manning di access point, effectively obstructing oda passengers from gaining entry into di terminal."
Di airline tok say dem swiftly seek oda alternatives to board affected passengers for dia flight.
"We dey deeply saddened say such high-profile figure display conduct so unbecoming and disruptive to fellow passengers and our personnel. Air Peace maintain zero-tolerance stance on violence or any form of aggression against our staff and passengers," di statement tok.
"We urge all guests, to remain civil and cooperative at all times. Aviation operations dey bound by strict timelines and safety protocols, and we remain committed to upholding dia standards while delivering safe and timely services to di Nigerian public."
Airpeace tok say dem go kontinu to stand for discipline, integrity, and respect for due process and "no individual, no matter how influential, dey above dis values."