logo
#

Latest news with #N1.38billion

All di charges against Jude Okoye
All di charges against Jude Okoye

BBC News

time05-03-2025

  • Business
  • BBC News

All di charges against Jude Okoye

Jude Okoye, di elder brother and ex- manager of Peter and Paul wey pipo know as P-Square appear bifor for one court for Lagos on Tuesday on allegation of stealing. Dis incident happun just afta court bin grant am N100 million Naira bail for im alleged fraud case. Oga Okoye plead "not guilty" to all di charges against am for court. According to di Economic and financial crimes commission, di fresh four offence dem, allege be say im commit am between 2016 and 2023. Wetin be di charges and allegations against Jude Okoye? For im federal high court case, Oga Jude Okoye dey face seven count charge wey get to do wit money laundering wey reach N1.38billion, $1million and £34,537.59. One of di charges read say: Dem say: " Jude Okoye Chigozie and Northside Music Ltd sometimes for 2022 use mago-mago take buy one landed property for No 5, Tony Eromosele Street, Parkview Estate, Ikoyi, Lagos wey worth 850,000,000.00 naira ($566,000) and dis dey against di law. Anoda charge read say: Dem say: "Jude Okoye Chigozie and Northside Music Ltd sometime for 2022 indirectly use bureau de change, to convert di sum of $1,019,762.87 for Access Bank Plc account wey Northside Music Ltd get to di Naira equivalent and den put am inside various bank accounts wit di intention to hide am say di funds form part of di money wey dem get through mago-mago, so dem commit offence. Justice A.O. Owoeye grant Oga okoye N100 million bail, di trial go begin14 April, 2025 If court find am guilty for dis mata e fit go prison for nothing less dan four years or fine not less dan five times di proceeds of di crime or both. Jude Okoye Special Offences Court case For anoda separate case wey dey bifor di Special Offences Court for Ikeja, Lagos, Oga Okoye dey face fresh four-count charges on allegation of stealing wey reach $1,019,762.87 and £34,537.59. One of di charges read say: "Jude Chigozie Okoye and Northside Music Ltd sometime for 2016 use mago- mago to corner di total sum of $767,544.15 dat amount na Lex Records Limited pay for music digital distribution/publishing royalties, wit di intention to to permanently deprive Peter Obunmuneme Okoye im special interest for di property." Another charge read say: "Jude Chigozie Okoye and Northside Music Limited between 2016 and 2023 for Lagos, use mago-mago convert di sum of, wey be money wey Lex Records Limited pay for music digital distribution/publishing royalties and wit di intention to permanently deprive Peter Obunmuneme Okoye im special interest for di property." Dem further allege say im divert di sum of $133,566.49 wey Kobalt Music Services Limited pay and $118,652.23 wey Mtech Limited pay as royalties. Justice Rahman Oshodi adjourn di mata until 6, March 2025 for di hearing of di bail application and May 16 and 23, 2025 for trial, Oga Jude dey for Ikoyi Correctional Centre. If court find am guilty for dis case im fit face up three years for prison.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store