logo
All di charges against Jude Okoye

All di charges against Jude Okoye

BBC News05-03-2025

Jude Okoye, di elder brother and ex- manager of Peter and Paul wey pipo know as P-Square appear bifor for one court for Lagos on Tuesday on allegation of stealing.
Dis incident happun just afta court bin grant am N100 million Naira bail for im alleged fraud case.
Oga Okoye plead "not guilty" to all di charges against am for court.
According to di Economic and financial crimes commission, di fresh four offence dem, allege be say im commit am between 2016 and 2023.
Wetin be di charges and allegations against Jude Okoye?
For im federal high court case, Oga Jude Okoye dey face seven count charge wey get to do wit money laundering wey reach N1.38billion, $1million and £34,537.59.
One of di charges read say: Dem say: " Jude Okoye Chigozie and Northside Music Ltd sometimes for 2022 use mago-mago take buy one landed property for No 5, Tony Eromosele Street, Parkview Estate, Ikoyi, Lagos wey worth 850,000,000.00 naira ($566,000) and dis dey against di law.
Anoda charge read say: Dem say: "Jude Okoye Chigozie and Northside Music Ltd sometime for 2022 indirectly use bureau de change, to convert di sum of $1,019,762.87 for Access Bank Plc account wey Northside Music Ltd get to di Naira equivalent and den put am inside various bank accounts wit di intention to hide am say di funds form part of di money wey dem get through mago-mago, so dem commit offence.
Justice A.O. Owoeye grant Oga okoye N100 million bail, di trial go begin14 April, 2025
If court find am guilty for dis mata e fit go prison for nothing less dan four years or fine not less dan five times di proceeds of di crime or both.
Jude Okoye Special Offences Court case
For anoda separate case wey dey bifor di Special Offences Court for Ikeja, Lagos, Oga Okoye dey face fresh four-count charges on allegation of stealing wey reach $1,019,762.87 and £34,537.59.
One of di charges read say: "Jude Chigozie Okoye and Northside Music Ltd sometime for 2016 use mago- mago to corner di total sum of $767,544.15 dat amount na Lex Records Limited pay for music digital distribution/publishing royalties, wit di intention to to permanently deprive Peter Obunmuneme Okoye im special interest for di property."
Another charge read say: "Jude Chigozie Okoye and Northside Music Limited between 2016 and 2023 for Lagos, use mago-mago convert di sum of, wey be money wey Lex Records Limited pay for music digital distribution/publishing royalties and wit di intention to permanently deprive Peter Obunmuneme Okoye im special interest for di property."
Dem further allege say im divert di sum of $133,566.49 wey Kobalt Music Services Limited pay and $118,652.23 wey Mtech Limited pay as royalties.
Justice Rahman Oshodi adjourn di mata until 6, March 2025 for di hearing of di bail application and May 16 and 23, 2025 for trial,
Oga Jude dey for Ikoyi Correctional Centre.
If court find am guilty for dis case im fit face up three years for prison.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Nigeria's Tinubu touts economic gains at mid-term but inflation and insecurity persist
Nigeria's Tinubu touts economic gains at mid-term but inflation and insecurity persist

Reuters

time29-05-2025

  • Reuters

Nigeria's Tinubu touts economic gains at mid-term but inflation and insecurity persist

ABUJA, May 29 (Reuters) - Nigerian President Bola Tinubu on Wednesday marked his second anniversary in office by declaring that his economic reforms were working, but international bodies have warned of persistent economic and security problems. Since 2023, Tinubu's policies - the removal of a costly petrol price subsidy, cuts to electricity price subsidies, and two currency devaluations - have triggered the worst cost-of-living crisis in a generation, fuelled by inflation rates of more than 23%. "Our economic reforms are working. We are on course to building a greater, more economically stable nation," Tinubu said in an anniversary statement. He said the measures were needed to avert a severe fiscal crisis that would have led to "runaway inflation, external debt default, and a plunging Naira and an economy in a free-fall." Tinubu said the fiscal deficit has narrowed sharply to 3.0% of GDP in 2024 from 5.4% in 2023, supported by improved government revenue generation. He claimed inflation had begun to ease, but this is largely because the index was rebased for the first time in more than a decade. The World Bank has said that Nigeria's fiscal position has improved in recent months, but warned that persistently high inflation remains a challenge. Tinubu said security has improved, claiming banditry in Nigeria's northwest has been curbed, highways are safer, and farmers are "back tilling the land". But attacks and kidnappings persist, and insecurity continues across various regions. Amnesty International said in a report on Thursday that at least 10,217 people have been killed in attacks by gunmen in the two years since Tinubu took office. His ruling All Progressives Congress (APC) party has endorsed him to run for a second and final term in the next election, due in early 2027.

Nigeria's Senate passes tax reform bills to boost government revenue
Nigeria's Senate passes tax reform bills to boost government revenue

Reuters

time09-05-2025

  • Reuters

Nigeria's Senate passes tax reform bills to boost government revenue

ABUJA, May 9 (Reuters) - Nigeria's Senate passed four tax reform bills on Friday aimed at boosting government revenue, nearing completion of a plan that has faced criticism and pushback from within President Bola Tinubu's ruling All Progressives Congress. After ending costly subsidies and twice devaluing the naira currency in his first year in office, Tinubu has shifted his focus to reforming the tax system to boost revenue and efficiency. Critics say the measures, which include an increase in value-added tax to 12.5% next year from 7.5%, will worsen economic hardship in Africa's most populous country of more than 200 million. Parliament's passage of the four bills, despite opposition from lawmakers and governors within Tinubu's party, is a victory for his administration's efforts to shore up government revenue and overhaul the country's fiscal framework. Nigeria has one of the world's lowest tax-to-GDP ratios, at 10.8%, forcing the government to rely on borrowing to fund the budget. Sani Musa, who chaired the Senate committee that reviewed the bills, said their passage triggered an amendment to Nigeria's oil law. The changes transfer "fiscal administration duties, such as royalty and petroleum profit tax collection, to the newly proposed Nigeria Revenue Service", he said on Friday. Musa clarified that other provisions in the oil law remain unchanged. Nigeria's lower House of Representatives passed the tax bills in March. Now, the Senate's passage requires both chambers to reconcile their versions before sending the final bills to Tinubu for his assent.

'I find out say na Jude and im wife be di directors of Northside Music, im wife own 80% while Jude own 20%' - Peter Okoye tell court
'I find out say na Jude and im wife be di directors of Northside Music, im wife own 80% while Jude own 20%' - Peter Okoye tell court

BBC News

time15-04-2025

  • BBC News

'I find out say na Jude and im wife be di directors of Northside Music, im wife own 80% while Jude own 20%' - Peter Okoye tell court

Di Economic and Financial Crimes Commission EFCC don start dia prosecution of di former manager of di music duo wey dem dey call P-Square, Jude Okoye. Okoye dey on trial togeda wit im company Northside Music Limited dey charged wit seven counts wey dey border on money laundering of 1.38bn naira ($809, 000. One of di counts na say for 2022, e buy landed property for Parkview Estate wit money wey im know or suppose know say comot from unlawful act wey dey against wetin Section 18 (2) (d) and dey punishable under Section 18 (3) of di Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022. Jude Okoye plead not guilty to all di charges. EFCC call Peter Okoye wey bin dey part of P-Square bifor dem break up as dia first witness for di case as na im through im lawyer carry di mata of wetin dey happun for P-Square reach EFCC table. Na still di same EFCC reveal wetin happun for di first day of di case. Di case dey adjourned til June 4, wen di defence go cross examine oga Okoye. Wetin Peter tok as im testimony against Jude Okoye? Peter Okoye aka Mr P, tok for im testimoney say di mata bin start sake of say dem bin get problem wit di way wey Jude Okoye bin dey manage dem and Northside Entertainment Limited on top say e be di sole signatory for all dia accounts for Ecobank, Zenith and FCMB. E say, "Dis issues bin last for couple of months. I bin no get access to di accounts until di current Minister of Aviation, Festus Keyamo, SAN wey be our lawyer tok say we need sharing formula." As part of di evidence, e tok say di brodas bin dey build dia houses for Ikoyi, "na Northwest Entertainment Ltd. bin dey fund di house project but dem stop to dey fund my house for six months. Na so I go meet Jude and my twin broda, Paul to know why dem stop to finance my project. But wetin I hear from dem be say, 'As you leave P-square, you don leave di money'. Na so I go meet our lawyer Keyamo." E explain say all dia money bin dey inside Northside Entertainment and Jude be di only signatory. E add say na during dat time e find company wey dey similar to dia own wey be Northside Music Limited. E explain say di way e find out na for 2022. Peter say, "I find out wen some pipo bin wan acquire our albums. Dem come ask for our statements of account to know how much di albums dey make monthly, na dat time I demand to know di backend but e no gree." E tok say e meet Paul to tok di mata but Paul tell am say tell am say e don discuss di mata wit Jude, na im e go meet Jude again. Peter testify give di court say, "E tell me say my share of money dey wit some pipo for South Africa. I come tell am say no be money I dey ask for, na backend and statements of di account but no hear beta response." At dat point e go meet di account officers for statements of account but dem no ansa am infact "di account officer for di Zenith Bank later tell me say Jude say make e no give me say di only way wey I go get am na through court". E say till im call, e no know say any company dey called Northside Music, even di album by Cynthia Morgan wey be Jude artiste dat ime bin dey by Northside Incorporation. Later e tok say e meet Jude for di same backend wey Jude say e go take like three and half months to retrieve di catalogue. E reveal say wen e get di catalogue and dem send am to di pipo wey wan buy am na wen dem find out say dem din tamoer wit di back end, na wen e decide to find out who dey behind Northside Music. E say, "I bin go di Corporate Affairs Commssion (CAC) site and find out say na Jude and im wife be di directors of Northside Music. I also find out say Jude wife own 80% while Jude own 20%." Afta more discovery wey include how Peter no get anytin for di backend sake of say e bin dey tampered wit and meeting between who bin wan buy di catalogue and paul and even some tax issues wey join, na im Peter decide to contact im lawyer wey carry di case give EFCC. Wetin start all dis kasala? Na public knowledge say serious kwanta dey between Paul Okoye, Peter Okoye, wey be im twin brother and dia elder brother Jude Okoye, and di mata involve di EFCC. For August 2023, Peter Okoye, di twin brother of Paul wey dem togeda dey sing bin tok say im write petition give EFCC against dia elder brother Jude Okoye and im wife on top accuse of mago-mago. E allege say Oga Jude divert P-Square royalties inside secret account, and dat lead tensions and legal threats. One of di counts read: "Say you, Jude Okoye Chigozie and Northside Music Ltd sometime in 2022, for Lagos, within di jurisdiction of dis Honourable Court, did directly acquire one landed property for No 5, Tony Eromosele Street Parkview Estate, Ikoyi, Lagos wey worth ₦850,000,000.00 only, wit money wey you know or suppose know say form part of proceeds from unlawful act and you thereby commit offence contrary to Section 18 (2) (d) and punishable under Section 18 (3) of di Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022." Anoda count read: "Say you, Jude Okoye Chigozie and Northside Music Ltd sometime in 2022, for Lagos, within di jurisdiction of dis Honourable Court, indirectly use bureau de change to convert di sum of $1,019,762.87 (One million nineteen thousand, seven hundred and six-two dollars eighty-seven cents), wey dey Access Bank Plc wey Northside Music Ltd dey operate and convert am to di naira equivalent wey you spread into various bank accounts and you get intention to hide di money wey be part of di proceeds an unlawful act and thereby commit offence contrary to Section 18 (2)(a) and punishable under Section 18 (3) of di Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022." Jude bin deny di allegations, and call dem baseless and defamatory. Di first time we torchlight dis mata na for August 2024, wen Paul tok about am for interview wey im bin do. Paul for di interview also mention one case e get wit Nigeria corruption police, Economic Financial Crimes Commission (EFCC) for December 2023, wey e allege say na im twin brother set am up wit dem. E say im land EFCC custody afta one petition wey im twin brother petition di EFCC to arrest am on multiple charges, wey include im lifestyle. E claim say even though di EFCC clear am of all allegations afta thorough investigation, im twin brother no gree to apologise for di false claims. "Dis year, EFCC bin invite me afta dem receive one petition against me from my twin brother. I no ever tink say [our beef] go go dis far. I tink say na just music," e tok. Peter later deny di claim for open letter say di EFCC case na against Jude Okoye and im wife.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store