logo
#

Latest news with #NorthsideMusicLtd

All di charges against Jude Okoye
All di charges against Jude Okoye

BBC News

time05-03-2025

  • Business
  • BBC News

All di charges against Jude Okoye

Jude Okoye, di elder brother and ex- manager of Peter and Paul wey pipo know as P-Square appear bifor for one court for Lagos on Tuesday on allegation of stealing. Dis incident happun just afta court bin grant am N100 million Naira bail for im alleged fraud case. Oga Okoye plead "not guilty" to all di charges against am for court. According to di Economic and financial crimes commission, di fresh four offence dem, allege be say im commit am between 2016 and 2023. Wetin be di charges and allegations against Jude Okoye? For im federal high court case, Oga Jude Okoye dey face seven count charge wey get to do wit money laundering wey reach N1.38billion, $1million and £34,537.59. One of di charges read say: Dem say: " Jude Okoye Chigozie and Northside Music Ltd sometimes for 2022 use mago-mago take buy one landed property for No 5, Tony Eromosele Street, Parkview Estate, Ikoyi, Lagos wey worth 850,000,000.00 naira ($566,000) and dis dey against di law. Anoda charge read say: Dem say: "Jude Okoye Chigozie and Northside Music Ltd sometime for 2022 indirectly use bureau de change, to convert di sum of $1,019,762.87 for Access Bank Plc account wey Northside Music Ltd get to di Naira equivalent and den put am inside various bank accounts wit di intention to hide am say di funds form part of di money wey dem get through mago-mago, so dem commit offence. Justice A.O. Owoeye grant Oga okoye N100 million bail, di trial go begin14 April, 2025 If court find am guilty for dis mata e fit go prison for nothing less dan four years or fine not less dan five times di proceeds of di crime or both. Jude Okoye Special Offences Court case For anoda separate case wey dey bifor di Special Offences Court for Ikeja, Lagos, Oga Okoye dey face fresh four-count charges on allegation of stealing wey reach $1,019,762.87 and £34,537.59. One of di charges read say: "Jude Chigozie Okoye and Northside Music Ltd sometime for 2016 use mago- mago to corner di total sum of $767,544.15 dat amount na Lex Records Limited pay for music digital distribution/publishing royalties, wit di intention to to permanently deprive Peter Obunmuneme Okoye im special interest for di property." Another charge read say: "Jude Chigozie Okoye and Northside Music Limited between 2016 and 2023 for Lagos, use mago-mago convert di sum of, wey be money wey Lex Records Limited pay for music digital distribution/publishing royalties and wit di intention to permanently deprive Peter Obunmuneme Okoye im special interest for di property." Dem further allege say im divert di sum of $133,566.49 wey Kobalt Music Services Limited pay and $118,652.23 wey Mtech Limited pay as royalties. Justice Rahman Oshodi adjourn di mata until 6, March 2025 for di hearing of di bail application and May 16 and 23, 2025 for trial, Oga Jude dey for Ikoyi Correctional Centre. If court find am guilty for dis case im fit face up three years for prison.

'Stay strong brother' - Paul Okoye stand elder broda Jude wey get wahala wit EFCC
'Stay strong brother' - Paul Okoye stand elder broda Jude wey get wahala wit EFCC

BBC News

time27-02-2025

  • Entertainment
  • BBC News

'Stay strong brother' - Paul Okoye stand elder broda Jude wey get wahala wit EFCC

Nigeria ogbonge singer Paul Okoye don react afta di Federal High Court for Ikoyi, Lagos state Nigeria order im elder brother and former manager to remain for Ikoyi prison until di court go hear im bail applications. For one post on im Instagram stories, Paul Okoye alias Rudeboy encourage im brother wey dey face charges wey border on money laundering say, "Dis too shall pass. Stay strong brother". E also write say "Exactly wetin e want". However, e no dey who e dey refer to, but na public knowledge say serious kwanta dey between Paul Okoye, Peter Okoye, wey be im twin brother and dia elder brother Jude Okoye, and di mata involve di EFCC. For August 2023, Peter Okoye, di twin brother of Paul wey dem togeda dey sing bin tok say im write petition give EFCC against dia elder brother Jude Okoye and im wife on top accuse of magomago. E allege say Oga Jude divert P-Square royalties inside secret account, and dat lead tensions and legal threats. Jude bin deny di allegations, and call dem baseless and defamatory. Na on Wednesday di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) drag di former manager of di defunct P-Square music group bifor di Federal High Court on top accuse of money laundering of ₦1.38billion, $1 million and £34,537.59. Di Nigerian corruption police bin arraign am alongside im company, Northside Music Ltd, bifor Justice Alexander Owoeye on seven-count charges. Wetin be di charges? EFCC on dia Instagram account post two of di charges wey allege say Oga Okoye buy properties wit money wey e know say no pure and e convert di sum of about one million dollars to naira wey e spread for different banks for Nigeria. One of di counts read: "Say you, Jude Okoye Chigozie and Northside Music Ltd sometime in 2022, for Lagos, within di jurisdiction of dis Honourable Court, did directly acquire one landed property for No 5, Tony Eromosele Street Parkview Estate, Ikoyi, Lagos wey worth ₦850,000,000.00 only, wit money wey you know or suppose know say form part of proceeds from unlawful act and you thereby commit offence contrary to Section 18 (2) (d) and punishable under Section 18 (3) of di Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022." Anoda count read: "Say you, Jude Okoye Chigozie and Northside Music Ltd sometime in 2022, for Lagos, within di jurisdiction of dis Honourable Court, indirectly use bureau de change to convert di sum of $1,019,762.87 (One million nineteen thousand, seven hundred and six-two dollars eighty-seven cents), wey dey Access Bank Plc wey Northside Music Ltd dey operate and convert am to di naira equivalent wey you spread into various bank accounts and you get intention to hide di money wey be part of di proceeds an unlawful act and thereby commit offence contrary to Section 18 (2)(a) and punishable under Section 18 (3) of di Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022." 'E plead not guilty' Oga Jude plead not guilty to di charges. In view of im plea, di prosecution counsel, Larry Peters Aso, apply for a trial date and e say make di court keep am for correctional facility pending trial. Di defendant counsel, Inibehe Effiong, tell di court about Oga Okoye bail application and e ask di court for short date of adjournment to allow dem hear di application for di bail. E also say make di court keep am for EFCC custody pending di hearing of di bail application. But di prosecution counsel object, as e argue say EFCC custody don already full wit suspects wey dey await arraignment. Justice Owoeye adjourn di mata to 28 February for bail hearing and April 14 for trial. E also order say make di defendant remain for Ikoyi correctional facility. Who be Jude Okoye According to di short bio on im Linkedin, Jude Engees Okoye describe imsef as elder brother, video director and artiste manager of P-Square. E say im dey very famous for im creative approach in video directing wey don make am win plenty awards for di music entertainment industry. Bifor P-Square scata, Jude play ogbonge role for di success of di music group as na im dey manage im brothers career, e be dia executive producer and na im dey responsible for building dia careers and negotiate deals wey position dem as one of Africa biggest stars. Afta P-Square split for 2017, Jude start Northside Entertainment, one record label wia e sign and manage oda artists like Cynthia Morgan.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store