Latest news with #NANNM


BBC News
01-08-2025
- Health
- BBC News
Nigerian nurses don call off nationwide strike
National Association of Nigeria Nurses and Midwives (NANNM) don call off dia ongoing strike. Di strike wey start on Wednesday bin cause di shutdown of operations for many hospitals as many patients also suffer from a lack of proper health care. Di association bin ask dia members make dem down dia tools until August 5, 2025. Di association start dia seven-day warning strike on July 29, 2025, accusing di goment say dem refuse to act on di 15-day ultimatum, dem bin issue on July 14. Minister of Health, Prof Ali Pate, on Friday confam say di nursing association don call off di strike afta one brief meeting wit di association. Tashikalmah Hallah di tok-tok pesin to di Nigerian Minister of Health and Social Welfare also confam give BBC say dem don call off di strike. "We just finish di meeting wit di nurses dem don gree to call off di strike immediately," di tok-tok pesin say. Meanwhile, di association no gree make any comment on di strike afta di close door-meeting. Di association dey demand for beta work condition, and di goment unwillingness to address dia issues. Di association dem demand for improve welfare packages, equitable allowances, and betta working environments for nurses wey dey work for federal health facilities. BBC Pidgin bin report say di strike don affect activities for Accident and Emergency ward for University of Port Harcourt Teaching Hospital.


BBC News
01-08-2025
- Health
- BBC News
'Me and oda pipo dey suffer, di wahala too much' - patients lament nurses strike for Nigeria
Patients across federal hospitals don begin feel di impact of di nurses and midwives strike wey start on Wednesday 30 July. Di National Association of Nigeria Nurses and Midwives (NANNM) bin announce say di warning strike go last for seven days. Di strike go affect only federal goment hospitals and facilities. Di strike dey come afta di association give Nigeria goment 15 days ultimatum to address all di issues wey dey disturb dem. BBC News Pidgin waka go some hospitals wey federal govment get for Kano, and our tori pesin see pipo worried sake of di strike. Many sick pipo dey suffer and dem no happy becos of di strike. Some pipo for di hospital look like relatives of di sick pipo, and e clear say di strike dey affect dem well-well based on how dem dey waka up and down dey worry. One woman tell BBC News Pidgin say dem carry sick pesin go Malam Aminu Kano Hospital, but now di pesin no dey get di treatment wey e suppose get again. "We carry our pesin come hospital, dem don even start treatment, but now health workers don go on strike. "I dey beg govment make dem help us beg di workers make dem come back to work, so dat our children go fit get beta," she tok. One man wey im name na Rufa'i, wey dey for Emergency ward, also tell BBC News Pidgin say as e carry im younger broda wey injure for leg come hospital, di tin wey e meet no sweet am at all. "I carry my broda come wey get wound for leg, but wen I reach here, I see say workers dey on strike. "Di tin really pain us, we dey beg pipo wey fit help to enta dis mata make dem help us," e tok. Anoda patient wey dey for male ward tok say e need medical help, but dis strike dey make am hard for am. "I no well and my sickness need special treatment or maybe even operation, but sake of dis strike, me and oda sick pipo dey suffer. Di wahala don too much." BBC News Pidgin also visit di University of Port Harcourt Teaching Hospital (UPTH), wia patents for dia dey also feel di impact of di strike and dem don discharge most of dem. Even though di hospital get a strike action protocol wia dem till dey try to offer some medical services, patients still dey feel di sad impact of di strike as many clinics wey suppose run no dey open. "Dem still dey offer service for di Accident and Emergency section but dem no dey admit anybody becos nurses no dey on ground. "I need to see doctor becos of di infection I get for my face but di doctor on duty just prescribe tablets wey I take, even though e say dem suppose admit me to monitor me well, but dem no admit me becos nurses no dey. I pray make dem call off di strike soon," na so George Okpokiri, a patient wey go do hospital tok. Despite di fact say doctors and oda medical personnel like pharmacist still dey work, di services dey grounded sake of di ongoing nurses strike.


Daily News Egypt
31-07-2025
- Health
- Daily News Egypt
Nigerian Nurses Launch Nationwide Strike Over Pay and Staffing Crisis
Nurses across Nigeria's public hospitals began a seven-day warning strike on Wednesday, calling for better wages, improved working conditions, and urgent recruitment of new healthcare workers. The strike, announced by the National Association of Nigeria Nurses and Midwives (NANNM), comes after the federal government failed to respond to their demands within a two-week ultimatum. The union has warned that failure to reach a resolution within the next week will trigger an open-ended nationwide strike, the first of its kind in more than two decades. 'We hope to get the government's attention and a positive response before the seven days elapse,' said Christiana Adeboye, NANNM chairperson in Lagos. Healthcare services in government hospitals across Nigeria are bracing for disruptions as nurses walk off the job, leaving already overstretched facilities further understaffed. Hospitals fear the situation could escalate, jeopardizing the care of thousands of patients. A critical meeting held Tuesday between a government delegation — led by Labour Minister Mohammed Dingyadi — and union representatives ended in deadlock. Tensions rose further due to the absence of Health Minister Ali Pate, which union officials described as a 'glaring failure of leadership.' 'It was a crucial meeting about the future of Nigeria's healthcare, and yet the Health Minister didn't show up. That says everything,' said Toba Odumosu, NANNM Secretary-General in Lagos. Mass Exodus of Nurses Deepens Health Crisis The nurses' strike throws a harsh spotlight on Nigeria's healthcare sector, which has been grappling with chronic underfunding, low salaries, and a massive brain drain. According to the Nursing and Midwifery Council of Nigeria, over 42,000 Nigerian nurses have left the country in the past three years, lured by better pay and working conditions abroad. Hospitals across major states such as Lagos, Abuja, and Kano are already experiencing critical staff shortages, leading to longer patient wait times, overworked personnel, and a rise in preventable deaths in some facilities. NANNM is demanding immediate action to address the shortage of nurses, revise salary scales in line with current economic realities, and improve safety and working conditions for healthcare workers. 'We are not asking for luxury. We are asking for dignity and fairness. The lives of patients and healthcare workers are both at risk,' said Adeboye. A System Under Strain Nigeria's public health system is widely considered overstretched and under-resourced. Recent economic challenges, currency instability, and inflation have exacerbated the situation, making it harder for healthcare workers to survive on stagnant wages. Striking nurses report working under intense pressure, with some managing over 30 patients per shift. Many have been forced to take on extra jobs or borrow money just to survive. The strike has drawn support from various civil society groups, including the Joint Health Sector Unions (JOHESU), which has also raised concerns about the exodus of medical professionals. 'Unless this crisis is addressed comprehensively, Nigeria risks a collapse of its public healthcare system,' warned a JOHESU spokesperson. Government Urged to Act Swiftly With the warning strike now in effect, public hospitals are activating emergency response protocols. However, many worry that without government intervention, healthcare facilities will not withstand a prolonged walkout. The Federal Ministry of Health has yet to issue a formal statement, while the Ministry of Labour said negotiations are ongoing. For now, Nigerians face growing uncertainty, and patients — especially in rural areas — are left in limbo, fearing what comes next if a full-scale strike is declared next week.


Reuters
30-07-2025
- Health
- Reuters
Nigerian nurses strike for pay and staffing as talks collapse
LAGOS, July 30 (Reuters) - Nurses in Nigeria's public hospitals began a seven-day "warning" strike on Wednesday, demanding improved remuneration, better working conditions and increased recruitment, after a two-week ultimatum to the government expired without resolution. The National Association of Nigeria Nurses and Midwives (NANNM) warned that if their demands are not met by next week, the union will embark on an indefinite strike, the first in over two decades. "We hope that before the seventh day, we'll have attention and positive response from the federal government," said Christianah Adeboboye, head of the nurses' and midwives' union in Lagos. A meeting on Tuesday between the union and a government delegation led by Labour Minister Muhammad Dingyadi ended in a stalemate. "When you look at the composition of the meeting, it already shows that no outcome could have been gotten out of that meeting," said Toba Odumosu, union secretary in Lagos, citing the absence of Health Minister Ali Pate as a critical gap. The impasse underscores the growing rift between healthcare workers and the government, leaving patients vulnerable as hospitals brace for further disruptions. The union is pushing for the recruitment of more nurses, pointing to a sharp decline in personnel as over 42,000 nurses have left Nigeria for jobs abroad in the past three years, according to the Nursing and Midwifery Council of Nigeria.


BBC News
30-07-2025
- Health
- BBC News
Why Nigerian nurses dey strike and how e fit affect medical care
Nurses and midwives for Nigeria don start industrial action [strike] across di kontri. Di National Association of Nigeria Nurses and Midwives [NANNM] announce say di warning strike go last for 7 days. Di strike go affect only federal goment hospitals and facilities. Di strike dey come afta di association give Nigeria goment 15 days ultimatum to address all di issues wey dey disturb dem. For letter wey di General Secretary of di association Dr. Shettima sign, di nurses association tok say dem dey give goment 15 days ultimate to meet dia demands. "Afta plenti tok-tok by di NEC-in session on di issues wey dey at stake, di house don resolve to give 15-day ultimatum to di Federal Ministry of Health so dat dem go address di demands wey we give dem." Di strike wey suppose start on Monday 14 July, 2025 don start on Wednesday 30 July, 2025. "If di goment fail to do di needful bifor di ultimatum expire, di association go start warning strike for 7 days," di nurses association bin tok. Why di nurses and midwives association dey para For di letter wey give goment notice about dia planned strike, di association say goment don neglect di needs wey di profession get for many years. Dem say even though di association bin dey veri "understanding wit goment and employers to ensure say dem work togeda well for di past four decades", dia employers for all levels don remove di respect wey di profession get. According to dem e don lead to "gross insensitiveness" to di legitimate demands of dia members and anytime dem wan go on strike dem dey tink about di needs of patients and clients. "And e dey make us to painfully avoid di only language [strike] wey goment dey understand." We go dey update dis tori