logo
#

Latest news with #NigerianActivist

EFCC confirm arrest of VDM, justify BBC report on Verydarkman
EFCC confirm arrest of VDM, justify BBC report on Verydarkman

BBC News

time06-05-2025

  • BBC News

EFCC confirm arrest of VDM, justify BBC report on Verydarkman

EFCC confam BBC Pidgin report on VeryDarkMan arrest Wia dis foto come from, VDM/Facebook 15 minutes wey don pass Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don confam BBC Pidgin report on di arrest of Martins Vincent Otse aka VeryDarkMan. BBC Pidgin on Monday 5 May report say EFCC gbab di activist based on petitions by some complainants wey get grievances against VDM. However, EFCC on dia social media handles tag di report as fake news, and in response BBC Pidgin publish a statement wia we stand gidigba wit our report on di tori. "BBC stand gidigba for we journalism and di facts wey we report for dis tori. "We dey committed to impartiality, independent tori and we go kontinu to dey tok truth witout fear or favour. "Tori wey we dey tell around di world dey guided by public interest and we dey folow highest editorial standards," BBC Pidgin tok for di statement. For dia statement on Tuesday 6 May wia dem confam BBC report on VDM arrest, EFCC claim say VDM bin refuse to "show up in spite of several invitations wey dem send to am through im known addresses and medium of communication". "Di petitions pertain to grave allegations of financial malfeasance wey di Commission no fit ignore," EFCC tok. Di anti-graft agency say e dey needful to admit say dem dey aware of alleged several unguarded attacks of di suspect against dia operations. Dem add say im arrest no dey connected to VDM alleged attack on dem and add say di relevant law enforcement agency go dey allowed to look into dem. "Di EFCC get lawful right to hold Otse in custody like any oda suspect wey di Commission dey investigate. "Di appropriate Remand Order bin dey obtained in dis regard." Di anti-graft agency say dem don offer VDM administrative bail and dem go release am afta e fulfil im bail conditions. "Di Commission appreciate di interest of Nigerians in im operations. Di passion, enthusiasm and torrential reactions to all of im activities dey welcome. "However, make insinuations about im motive in carrying out im assignment no continue. Make di EFCC dey allowed to do im job witout fear or favour. As soon as investigations dey concluded, charges go dey filed," di Commission add. Who be VDM? VDM na activist wey dey controversial for di Nigeria social media space. Im dey known for confronting goment officials, corruption and pipo wey dey go against di law. Sake of im activism, im don chop arrest plenti times and get pending court cases for many Nigeria courts.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store