logo
#

Latest news with #NigerianCommunity

Nigeria goment ready take action over death of Daniel Eheri for Luxembourg police custody
Nigeria goment ready take action over death of Daniel Eheri for Luxembourg police custody

BBC News

time28-05-2025

  • General
  • BBC News

Nigeria goment ready take action over death of Daniel Eheri for Luxembourg police custody

Di Nigerians in Diaspora Commission (NiDCOM) say dem go work wit Nigerian embassy for Belgium so dem find wetin cause di death of a Nigerian man wey die for Luxembourg custody. Dis na afta one Nigerian man wey dem identify as Daniel Eheri die for di custody of Luxembourg Police, Grand-Ducale, according to NIDCOM. NiDCOM say dem condemn di act and dem go ensure say dem get justice. According to NiDCOM, Nigeria go "demand for investigation into di circumstances wey lead to di death of a Nigerian national Daniel Eheri for di custody of Luxembourg Police, Grand-Ducale." Wetin happun to Eheri Daniel According to Abdur-Rahman Balogun wey be di Director of Media, Public Relations and Protocols Unit for NiDCOM, e say dem receive petition from di Nigerian community wey dey Luxembourg ontop Eheri matter. E say di petition wey dem send to di Federal Govment of Nigerian contain request say make dem do urgent investigation into di 'alleged extrajudicial killing' of a Nigerian citizen wey die for custody of di Luxembourg Police. According to di National Coordinator of di Nigerian Community for Luxembourg, Mr Sunday Adekolu, e write say di matter happun for February wen dem arrest Eheri for Luxembourg and e later die for police custody. "According to di petition, Eheri chop arrest for di hand of Luxembourg police on 10 February 2025 while e dey in possession of foodstuffs and dem confam am dead by di following day," according to di petition. Di Nigerian community for Luxembourg say di authorities for dia now give any explanation of wetin cause di death of di Nigerian. "Di late Eheri Daniel na Nigerian wit an untainted record for Luxembourg and a residence permit holder," Adekolu tok. Adekolu also add say di Nigeria Ambassador to Belgium, Ambassador Obinna Chiedu Onowu wey im coverage include Luxembourg bin write two letters concerning di case but e no receive any response. "We, di Nigerian Community for Luxembourg, do hereby seek your urgent assistance on di matter, to put records for right perspectives, to persuade di Luxembourg Police Grand-Ducale to conduct autopsy for di bodi of Eheri Daniel. Wetin Nigeria goment go do Adekolu bin call on di Nigerian govment say make dem chook mouth into di matter so dis kain issue no go happun again. As di Nigerian community for Luxembourg bin write petition to di Nigerian Govment, dem say make NiDCOM press di Luxembourg police to conduct an autopsy. Howeva, according to di statement by di Director of Media and Public Relations of NIDCOM, e say di chairman of di commission Abike Dabiri-Erewa, condemn di allegation of di death of a Nigerian ' for di custody of di Police authorities' for Luxembourg. "Dabiri-Erewa condole wit di family of di deceased as well as Nigerian Community for Luxembourg say di Commission go work wit oda stakeholders and ensure say justice dey served," di statement tok. According to NiDCOM, dem go work wit di Nigerian Embassy for di kontri wey di incident happun so dem go fit demand for thorough investigation into di matter.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store