logo
#

Latest news with #NigerianGovernment

I make two ogbonge reforms wey no make our kontri collapse
I make two ogbonge reforms wey no make our kontri collapse

BBC News

time29-05-2025

  • Business
  • BBC News

I make two ogbonge reforms wey no make our kontri collapse

President Bola Tinubu tok say di first two policies wey im administration take wen e enta into office na im save di kontri further collapse. For one broadcast to mark di second anniversary of im administration on May 29, di Nigerian leader tok say di economic and general situation of di kontri wey im inherit bin require make dem redirect di kontri affairs wit a bold and new vision, and dat na why im implement "di two necessary policies make di kontri for no further fall." Wen dem inaugurate President Tinubu on 29 May two years ago, di first two reforms wey e introduce na di removal of fuel subsidy and floating of di naira. Dis two reforms bin get serious impact on kontri pipo as di prices of goods and service bin dey on record high and inflation rise, Nigerians bin experience di worst cost of living crisis in a generation. "E bin dey clear say if di federal goment plus di oda two tiers of goment wan remain viable and cater to di citizens' welfare, dem must do away wit years of fuel subsidies and di corruption-ridden multiple foreign exchange windows. Di two no longer dey sustainable and don become needle for our kontri neck, wey dey chock us and strangle our nation future," President Tinubu tok. However, di president say despite di bump for di cost of living, dem don make "undeniable progress" as di reforms dey work and di economy don stable. "Inflation don begin go down, as di price of rice plus oda food stuff don dey reduce. Di oil and gas sector dey recover; rig counts don go up by ova 400% in 2025 compared to 2021, and dem don commit ova $8 billion in new investments. We don stabilize our economy and we dey better positioned now for growth and very prepared to withstand global shocks."

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store