
I make two ogbonge reforms wey no make our kontri collapse
For one broadcast to mark di second anniversary of im administration on May 29, di Nigerian leader tok say di economic and general situation of di kontri wey im inherit bin require make dem redirect di kontri affairs wit a bold and new vision, and dat na why im implement "di two necessary policies make di kontri for no further fall."
Wen dem inaugurate President Tinubu on 29 May two years ago, di first two reforms wey e introduce na di removal of fuel subsidy and floating of di naira.
Dis two reforms bin get serious impact on kontri pipo as di prices of goods and service bin dey on record high and inflation rise, Nigerians bin experience di worst cost of living crisis in a generation.
"E bin dey clear say if di federal goment plus di oda two tiers of goment wan remain viable and cater to di citizens' welfare, dem must do away wit years of fuel subsidies and di corruption-ridden multiple foreign exchange windows. Di two no longer dey sustainable and don become needle for our kontri neck, wey dey chock us and strangle our nation future," President Tinubu tok.
However, di president say despite di bump for di cost of living, dem don make "undeniable progress" as di reforms dey work and di economy don stable.
"Inflation don begin go down, as di price of rice plus oda food stuff don dey reduce. Di oil and gas sector dey recover; rig counts don go up by ova 400% in 2025 compared to 2021, and dem don commit ova $8 billion in new investments. We don stabilize our economy and we dey better positioned now for growth and very prepared to withstand global shocks."
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


Reuters
an hour ago
- Reuters
South African rand range-bound as markets await local inflation data, Fed signals
JOHANNESBURG, Aug 19 (Reuters) - South Africa's rand was on the back foot for much of Tuesday's trading session as markets awaited the U.S. Federal Reserve's upcoming Jackson Hole symposium and inflation figures from Africa's most industrialised economy. At 1545 GMT the rand traded at 17.6625 against the dollar , down about 0.3% from Monday's close. Fed Chair Jerome Powell is due to speak on the economic outlook and the central bank's policy framework on Friday. ETM Analytics said the risk-sensitive rand will likely take cues from this meeting as it currently remains range-bound against the dollar. "The USD-ZAR started the week on the defensive, which looks set to continue," the note said. "Expectations are for central banks to adopt a more dovish stance, but with some conservatism as the full effects of the tariffs remain unknown. Early signs that the global economy may be slowing require confirmation, which will take several more months." Statistics South Africa will release July inflation data on Wednesday, with most analysts expecting a rise from 3.0% in June (ZACPIY=ECI), opens new tab. The Johannesburg Stock Exchange's Top-40 (.JTOPI), opens new tab index was little changed from Monday's close. South Africa's benchmark 2035 government bond was also flat with the yield up half a basis point at 9.65%.


BBC News
2 hours ago
- BBC News
Why Ghana dey pursue pipo wit fake and 'unearned' doctorate and oda academic titles
If you be pesin wey dey di public eye, make sure say di doctorate or academic title you don add to your name, na proper one. Sake of di Ghana tertiary education commission (Gtec) bin dey pursue public officials and oda ogbonge pipo wey dey use fake doctorate, honorary titles and oda academic titles. Director general for Gtec, Professor Ahmed Jinapor Abdulai tok say to dey use honorary academic titles na against di kontris education regulatory bodies Act 2020 (Act 1023). "Pipo wey bin dey use titles like "Dr." or "Professor" sake of honorary award don dey break di law wey dem go face prosecution." Inside one press conference, oga Jinapor Abdulai explain say "even di accredited institutions wey gat di authority to confer honorary degrees - pesin no fit use such titles as if dem be earned academic qualification." Im tok say di law bin give Gtec di mandate to regulate how pipo dey use dis titles. "If pesin misuse such titles, e fit result for penalties of up to 250 penalty units, imprisonment for up to one year or both." Di Ghana tertiary education commission for di last few months bin dey lead campaign to "name and shame" public figures and oda pipo wey continue to dey use dis "unearned titles" afta dia warning. According to di commission di way pipo bin dey abuse dis "Dr" titles - especially politicians, religious leaders, herbalists and oda businessmen sake of one group or school don give dem as honorary doctorate, don become too much. "Sake of di way dem bin dey abuse di titles, e don dey mislead di public especially pipo dey mistake dis honorary recipients say dem be qualified medical professionals or academic experts," oga Abdulai Jinapor explain. E don dey "threaten academic credibility wey we neva dey recognize titles like honorary professor or honorary doctor for any official or academic setting." If pesin bin get honorary award sake of im contribution to di society, dat neva be di same as academic or professional qualification. Di deputy health minister and odas wey dem ask to stop using dia 'fake' titles Gtec bin write to di chief of staff for di presidency make im ensure say di deputy health minister Dr Grace Ayensu-Danquah drop di title of 'Professor' wey she don add to her name. For one 4 August letter, Gtec bin ask di deputy health minister say make she provide verifiable evidence of her appointment to di rank of professor by 11 August deadline. Gtec tok say lawyers for di deputy health minister bin respond wey dem tok say dem appoint dia client as Assistant Professor of surgery by di university of Utah for di US. Di lawyers bin question di authority of Gtec to ask for such evidence when di appointment of dia client (di deputy health minister) don happen outside di jurisdiction of Ghana. But Gtec insist say she gatz to provide evidence say she bin earn di 'Professor' title. Na so di commission don write to di university of Utah to confam if Dr Grace Ayensu-Danquah na professor true true. According to state-owned newspaper Daily Graphic, di university of Utah bin respond wit one letter wia Prof. Bradford Rockwell wey be vice chair for academic affairs for di department of surgery don sign for 7 August. Inside di letter, im tok say di deputy health minister na "adjunct assistant professor" for di department of surgery for di university of Utah. But Gtec tok say di university tok differnt tin wey her lawyers also bin tok different tin. While di university of Utah tok say she be 'adjunct assistant professor', her lawyers inside di letter to di commission tok say she be 'assistant professor.' Gtec now write to di deputy health minister say for Ghana, pesin wey be adjunct assistant professor na part-time lecturer wey neva fit compare to di rank of even senior lecturer, not to tok about professor. During her vetting to become deputy health minister for July, dem bin ask her how she don get her title as professor. Dr Grace Ayensu-Danquah explain say "I be professor of surgery for di university of Utah for di US, I don defend two thesis wey I bin do so many publications, I no fit to even count." She also add say "I don do plenty research too wey I no fit count, I don teach surgery for di past 15 years; sake of surgery na skill, we bin teach for di theatre. Na full professor I be." But di Ghana tertiary education commission insist say di deputy health minister neva be professor. Inside one interview on top local radio station Joy Fm, di Gtec boss Prof Abdulai Jinapor tok say "we don give di minister di opportunity to meet wit di board chairman at her place of convenience - wey we tok her say make she neva use di professor title, but she neva listen." "Now her lawyers bin dey give us two weeks to retract, I neva sabi wetin dem wan make we retract, but I gat to state am here say her lawyers no try give her for dis advice." Di Gtec boss add say "we bin tink say immediately di university of Utah bin write to us wey dem tok say she be adjunct assistant professor, common search for dat rank for Ghana, na part-time lecturer." Di commission say dem go dey "compelled to take legal action against di deputy health minister on di grounds of public deception, if she continue to dey use di 'Professor' Oda ogbonge pipo wey dem ask to drop dia 'fake' doctorate title Di central region chairman of di govment party National Democratic Congress (NDC) oga Richard Asiedu don formally drop di use of di title "Professor" afta di Ghana tertiary education commission bin warn am. Gtec bin write to di party executive on 28 June 2025, to ask say make im provide verifiable evidence of how im earn di title or make im drop am altogether. Oga Richard Asiedu bin respond to Gtec wey im issue public disclaimer. Im tok say "as pesin wey be law-abiding for dis kontri, I don take di warning from Gtec so I don stop to dey use di title professor." Oga Asiedu bin dey use di title for di last three years, afta im receive as honorary award from one university for Ukraine. "I neva sabi say pesin no fit use honorary title until Gtec don tok me. I wan put for record say Alfred Nobel University for Dnipro, Ukraine wey confer di title for me sake of di work I bin dey do for human development." Oga Richard Asiedu on im 1 August public notice explain further say make di public take note of di change for im name and act accordingly. Rashid Tanko Computer - CEO of Ghana investment fund for electronic communications (Gifec) On 3 June 2025, Gtec bin ask oga Rashid Tanko-Computer to stop to dey use di title "Dr". Oga Tanko-Computer for many years bin dey call imserf Dr Rashid Tanko-Computer until di tertiary education commission don write to warn am. Di commission tok say dia investigation show say di school wey don allegedly award di doctorate to di govment official no dey accredited. Gtec tok say di PhD from "Kingsnow University" no dey valid as im bin from "unaccredited institution". Na so Gtec order oga Rashid Tanko-Computer say make im remove di title from all official documents and platforms. At di time, oga Tanko-Computer explain for one local TV network JoyPrime say "na lecturer I be wey I don teach students for long. If you give attention to dis kind mata, na waste of time." "My students neva fail. I bin earn di PhD from Kingsnow university one online school wia I start di programme for 2012 wey u finish 2016." But di tertiary education commission insist say na fake doctorate wey dem warn am say make im neva use di title again for im public documents and records. Factcheck Ghana don find say "Kingsnow university" na degree mill wey neva get personalities as facility members. "We don find say di university bin get active website bifor but now e dey defunct since 2019. Wey di university no dey accredited." Di latest tori be say oga Rashid Tanko-Computer don drop di "fake Dr title." For im public engagement on top local media platforms, dem bin dey introduce am wit im name without di title. Former presidential candidate Hassan Ayariga insist say im doctorate na legit but Gtec no gree Di founder and leader of di All Peoples' Congress (APC) Hassan Ayariga na former presidential candidate. Im bin contest all di kontris elections since 2012. But for 14 July 2025, im na one of di ogbonge pipo wia di Ghana tertiary education commission bin ask to "provide verifiable evidence say im doctorate na genuine". Di letter by Gtec for di public bin tok say oga Hassan Ayariga bin tok different tori about im PhDs - one for political science and anoda for business management togeda wit oda honorary doctorates. Di APC founder tok say im get three doctorates na so im tok say im go take legal action against di commission. Oga Hassan Ayariga tok on top JoyNews say "Gtec don get agenda, wey dem neva write to me directly, na on top social media I bin see di letter." But Gtec boss Professor Abdulai Jinapor insist say make di APC founder provide di evidence of im PhD and if dem verify say na genuine no be fake, im go fit continue to use am. In response Hassan Ayariga tok for di TV programme say "you bin destroy my reputation by di way you handle dis mata, how long e go take for me to enter my room and pull out piece of paper wey go show say I get di PhD?." "I gat two honorary degrees and one PhD for political science, so I be Dr., na so I go take legal action against Gtec for destroying my name." Di Gtec boss wey bin dey on top di same TV show explain say "we neva dey witch-hunt anybody. All we want na evidence of di PhD." Gtec ask two lawmakers for parliament to drop Dr title For 3 June 2025 di tertiary education commission don write to di member of parliament for Awutu Senya East, Phillis Naa Koryoo Okunor say make she provide evidence of her doctorate title or remove am from her official documents and record. Di commission bin ask her to remove di title sake of she no get "verifiable academic credentials to support her claim." On di same day, di commission write to anoda lawmaker, MP for Gomoa East, Desmond De-Graft Paitoo say make im remove im "Dr" title. Dem bin ask am to provide evidence of di legitimacy of di title, including di school wey award di degree and di process dem take confer di doctorate. For di same month of July, Gtec bin also write to di chief executive officer (CEO) of di ambulance service at di time, Dr Nuhu Zakaria say make im drop di "Professor" title im bin dey use. Gtec don acknowledge at di time say dem sabi say oga Nuhu Zakariah na medical doctor but wetin dem dey ask di evidence of im professorship. "We neva get any verifiable evidence wey don show say you bin dey hold any substantive academic position." Not long afta, di president bin remove di CEO for di ambulance service wey im appoint new pesin as oga for di ambulance service. E no dey clear if na sake of di "Professor" title wahala wey make di president remove am from di ambulance service. Academic title rank for Ghana For Ghana, established protocols dey for di award and use of dis kind titles and ranks. Gtec say standards dey wey don provide how di academic ranks and titles dey awarded. Di academic progression for di kontri na to move from - Assistant lecturer to - Lecturer to - Senior lecturer to - Associate Professor to - Professor (full professor) For university to confer professor title for pesin for di kontri, di pesin gat to comune academic qualification wit ogbonge research contribution, togeda wit expertise for di specific field. Na academic rank wey dey require formal appointment or promotion by di university. Di university also don dey consider oda factors like teaching and mentorship credentials, service to di university and community. Di system na different from wetin dey happun for di US. For dia, some universities bin dey call all teaching staff for dia as professor. But di Ghana system na different, e get proper structure and specific hierarchy wit specific ranks wey I already bin mention. Oda countries wey ban "honorary doctorate" titles Di ministry of education for Ethiopia don announce fresh direction wey bin dey ban govment officials and public officers from being nominated for honorary doctorate degrees. Di minister of education Professor Berhanu Nega tok for one 23 July letter tok say dis na "to ensure say only well -established institutions bin meet academic standards" "For any school to confer doctorate, dem gat to bin graduate at least eight rounds of students, offer PhD programme and meet recognised national and international academic standards. Di Ethiopian education ministry add say "pipo wey receive honorary doctorates no dey permitted to use di title "Doctor" or "Honorary Doctor" or any oda similar designations outside di one wey di institution bin dey award. Dis according to di education minister, na to safeguard di integrity of academic honours and to ensure say only credible institutions don dey award am. For September 2024, Nigeria don ban foreign universities wey chop accuse of awarding fake degrees. Early dat year, di kontri suspend degrees wey Nigerians don obtain from universities for Benin and Togo. Dem later open am to cover some universities for Kenya, Uganda and Ghana. Di authorities tok say dem wan "maintain credibility of dia educational system and protect employers from potential fraudulent practices."


BBC News
6 hours ago
- BBC News
How much President Tinubu and ministers dey collect as salary - why dem wan review am?
Di reviewing of salaries of political office holders for Nigeria don dey gada plenty reactions for di kontri. Dis dey come afta di Revenue Mobilisation Allocation and Fiscal Commission (RMAFC) announce say dem don begin di process to review di current Revenue Allocation Formula between di federal, state and local governments. RMAFC Chairman Mohammmed Shehu during one presser for Abuja, Nigeria capital argue say di current salary wey politicians dey receive too small, unrealistic and outdated for di face of dia rising responsibilities and economic challenge. Oga Shehu say di current monthly salary of President Bola Tinubu na 1.5 million naira ($977), while dat of ministers dey earn less dan N1 million evri month. "You dey pay di President of di Federal Republic of Nigeria 1.5m naira a month, wit a population of ova 200 million pipo. You no fit pay minister less dan one million naira per month since 2008 and expect am to put im best and e no go involve for oda tins." Di chairmo argue say meanwhile, Central Bank of Nigeria govnor or di Director General dey collect 10 times more dan di salary wey di president dey collect. "E no dey not right. Or you pay am [di head of an agency] twenty times higher dan di Attorney-General of di Federation. E no dey right at all," Oga Shehu add. Oga Shehu disclose say di last time dem carry out comprehensive revenue allocation formula review na for 1992, and dem dey adjust am small-small through executive orders from 2002 to date. E say sake of dat dem wan review di current Revenue Allocation Formula (RAF) to ensure equity, fairness, and responsiveness to di changing social economic realities of di kontri. E describe di exercise as constitutional responsibility wey don become imperative in light of Nigeria evolving socio-economic and political landscape. As tori pipo ask if di commission go review di salary of civil servants too, di RMAFC boss say dia work dey strictly restricted to political office holders, govnors, senators, legislators, ministers, DGs, and oda pipo. "Time don reach wey pipo like you and odas suppose support di commission to come up wit reasonable living salaries for ministers, DGs, plus di President. Why RMAFC dey review di salary of politicians According to Oga Shehu, dem dey review di revenue allocation formular to produce a fair, just, and equitable revenue-sharing formula wey go reflect di current responsibilities, needs, and capacities of di three tiers of govments in line with di constitutional roles. "Di recent constitutional amendments, wey share responsibilities like power generation, railways, and correctional services to subnational govment don place financial and administrative burdens on dem. Dis situation don make am essential to re-evaluate di structure of fiscal federalism to foster economic growth and ensure sustainability," e tok. E add say under di current revenue allocation formula, di federal govment share na 52.6 per cent, 26.7 per cent for di state governments, and 20.6 per cent dey allocated to di local governments. Di committee also give one per cent each to di Federal Capital Territory, ecological fund, natural resources, plus di stabilisation fund under the vertical revenue allocation. Speaking further, e quote Paragraph 32 (b), Part I of di Third Schedule of di1999 Constitution of di Federal Republic of Nigeria (as amended), wey compulsory RMAFC to "review, from time to time, di revenue allocation formulae and principles in operation to ensure conformity wit changing realities". "In line wit dis constitutional responsibility and in response to di evolving socio-economic, political, and fiscal realities of our nation, di commission don reolve to initiate di process of reviewing di revenue allocation formula to reflect emerging socio-economic realities. Nigerians reaction Some Nigerians don react following di announcement of di RMAFC, while some question why di commission go wan add to di salary of politicians wey already dey live very lavish lifestyle while dia citizens dey suffer, and govment dey find am difficult to pay N70,000 minimum wage. Odas hail di initiative as ogbonge development.