28-06-2025
'My five-year-old daughter die after she chop biscuit from a local vendor'
Di father of one of di two girls wey die afta dem allegedly chop one popular locally made biscuit for Cameroon dey call for thorough investigation and autopsy to reveal wetin really kill im daughter.
Oga Belmond wey be trader dey deeply confused as several children wey chop di same biscuit no die, but im five-year-old daughter Makeda, die afta she chop am.
"I no dey dia, but pipo say she chop di biscuits. Dem no be di only ones wey chop am. So why na say only two children die? Only thorough and well-conducted autopsy go reveal wetin di children actually chop." Oga Belmond tok.
On Tuesday, 24 June, two children bin die, and more dan one hundred and five odas land for hospital for Douala, di economy capital of Cameroon, afta dem allegedly chop one popular locally made biscuit.
Authorities for di city say di children wey dey between di ages of one and 16, begin sick afta dem chop galette cakes wey one popular local pastry vendor sell give dem.
"Di children wey chop dis galettes bin complain of serious stomach pains. We don record two deaths for di New-Bell district hospital," di govnor of Littoral Region tok.
E add say dem rush more dan one hundred and five children go Laquintinie Hospital, wia dem currently dey receive care.
Hospital officials say one child dey for critical condition, e dey on respiratory support, and dem dey treat about ten odas for abdominal pain.
Di head of Paediatric department for Laquintinie Hospital bin reassure di public say dem take proper care of di children and medical staff full ground. She confam say dem neo report any deaths for di hospital.
According to her, dem dey carry out tests to sabi di causes of di poisoning.
"For Laquintinie Hospital, we receive 105 pipo. Nobody die. Everybody we treat don go house. we don conduct biological tests to know exactly wetin cause di sickness," she explain.
"Di medical and paramedical teams work hard to care for di children. We also get team of psychologists to reassure both di children plus di parents," Marie Solange Ndom Ebongue, Director of Laquintinie Hospital tok.
Di pastry seller don hand imself ova give di police and e currently dey under investigation. Authorities say e claim say im no know wetin cause di poisoning.
Dem don seal off im shop as part of di investigation.