logo
#

Latest news with #OgaSanwo-Olu

Wetin cause traffic wey lead to standstill for Lagos Island axis and wetin to expect next
Wetin cause traffic wey lead to standstill for Lagos Island axis and wetin to expect next

BBC News

time03-04-2025

  • Politics
  • BBC News

Wetin cause traffic wey lead to standstill for Lagos Island axis and wetin to expect next

Lagos state Govnor Babajide Sanwo-Olu don apologise to di state residents after one ogbonge traffic gridlock wey cause standstill for di Island area of di state on Wednesday enter Thursday morning. Thousands of motorists and commuters bin dey stranded for road on Wednesday, wit some spending hours before reaching dia destination while some no even reach till di next day. Some pipo hala say e take dem almost eight hours to reach dia destination on Wednesday night while some choose to tanda for dia work place. While many more take to social media to rant about dia experience. Wetin cause di traffic Dis mata start for April 1st wen di Federal Controller of Works for Lagos, Olukorede Kesha announce a temporary closure of di Independence Bridge wey dey Marina and say di bridge go dey closed until May 2025 for urgent repairs. Di closure bin affect traffic from Ahmadu Bello Way and Adeola Odeku towards Marina, Eko Bridge, and Onikan by Zone 2. Although di Lagos Ministry of Transportation come put out statement on top di closure wit alternative routes wey pipo fit pass on Wednesday but e no do anytin to stop di terrible hold up for di road. As a result, di Nigerian Minister of Works and Housing, David Umahi don greenlight for di re-opening of di road to stop di disaster. But pipo dey wonder how e go dey possible as dem don already comot di asphalt from di bridge road. Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu on Thursday visit di site of di bridge and apologise to Lagosinas for wetin dem take dia eye see as di goment bin dey run di urgent fix for di bridge. E say di fix na necessity to "avoid future disaster wey bin dey wait to happun". Oga Sanwo-Olu say "wetin happun here be say Messrs Buildwell, get contract wey dem don sign ova three years ago to protect di integrity of di independence bridge. Indepence bridge na one of di oldest bidges for di kontri. If you check am na almost 80 to 90 years old". E add say wetin happun be say di part of di bridge wey connect Victoria Island and Marina don dey under heavy threat. So wetin next for Lagos commuters? Even wit di Work minister statement, di situation on ground no be like sometin wey goment fit just open like dat. As at now, na to follow wetin di Lagos State Traffic Management Authority tok wey be to find alternative routes. Oga Sanwo-Olu remind Lagosians say dem bin face dis kain tin bifor and dem don pass am. E say wetin go happun be say more Lastma officers go dey road. "We dey call dem from oda parts of di city so dem go dey around here. "We go do like we do for November, December wey dem work late, to very early hours of di morning to make sure say pipo fit go home safely." Dis no be di first time wey bridge or road repairs dey cause serious traffic disruption for Nigeria commercial capital, Lagos. For February 2021, di authorities for Lagos bin confirm say dem go finally open di Third Mainland bridge afta ova six months of closure wit partial opening. Wen dem close am for July 25 2020, na only one lane motorists bin dey use on di bridge while repair work dey go on. Dem change some joints, lay some concrete and do patching work among oda engineering work on di bridge. For November 2023, Lagos goment close some parts of di Third Mainland Bridge sake of say dem wan do some repairs. Anytime dis closures happen, e dey cause serious traffic wey dey lead to serious stress as well as a loss of man hours, time and revenue .

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store