23-06-2025
Ondo state govment tok why dem demolish Owo massacre memorial park wey late ex-Govnor Akeredolu build
Report say dem don demolish di memorial park wey Ondo state govment bin build in honour of victims of di Owo attacks wey happun for June 2022.
Di Memorial Park na in honour of di victims of 5th June, 2022 massacre for St. Francis Xavier Catholic Church for Owo, Ondo State.
Pipo of Owo no go forget Sunday June 5, 2022 anytime soon as e mark one bad day wen some unidentified gunmen enta di town and attack di catholic church wia pipo die from gunshots.
Na dose wey die during di attacks make di state govment build a memorial park in honour of dem.
Dem build di memorial park opposite di palace of di traditional ruler of di town, Olowo of Owo.
According to di former Ondo state Govnor, Oluwarotimi Akeredolu, di reason for di memorial park na to immortalise di victims attacks.
Di recent demolition don cause serious reactions from di pipo of Ondo state wey dey question why dem pull down di building.
Why dem demolish di memorial park
According to video wey dey go viral for social media, one caterpillar bin estroy di memorial park.
Howeva, Yomi Oyekan wey be di special assistant to di Ondo State govnor on Digital Media, say di reason why dem pull down di building no be for political reason but for sake of spiritual.
E say di Olowo-in-council bin request say dem wan demolish di building becos symbol of death no suppose dey face di palace of di king. In Yoruba tradition, symbols of death must not face di palace.
"Di Olowo-in-Council make a formal request through di LG, and Govnor Aiyedatiwa to respectfully approve am."
"We honour di sincere efforts of di late Gov. Akeredolu, wey build di monument wit love, but tradition matters.
Also, informate from di Olowo-in-council na say, di traditions of di town no allow make dem celebrate deadi body around di palace.
According to di council, dem advice di late Govnor Akeredolu dat time make e no build any di structure for di place but e no gree.
"E must dey clear say di decision to build di structure for di particular location no go well wit di Olowo-in-Council wey di pipo of di community bin frown at wen di late di late Govnor Akeredolu conceive am."
Dem add say dem advice di "late govnor say to celebrate di dead around di palace no dey in line wit di age-long culture and traditions of Owo, but di govnor no listen."
Akeredolu side react
Meanwhile, according to di former chief press secretary to di late Akeredolu, Richard Olabode, e say di intentions na only to honour di memories of di victims wen dem build di park.
E say dem no bury any deadi bodi for di memorial park, but na just to dey remember di pipo wey lose dia lives for di attack.
"No bodies or corpses dey buried for di memorial park, di park na to celebrate di lives and memories of di departed souls."
Olabode say di late Govnor Akeredolu bin call a meeting wit di Olowo of Owo and im chiefs, wia e tok di vision for di park, and add say dem no go bury any deadi bodi for dia.
"Di Olowo and im chiefs agree to di site. I dey present for di meeting. Di late Govnor Akeredolu respond to di tragedy of June 5, 2022, wit courage and e do wetin any responsible and responsive leader go do anywhere for di world."