logo
#

Latest news with #PaulIbe

Why Atiku lead di wave of resignations comot from PDP?
Why Atiku lead di wave of resignations comot from PDP?

BBC News

time17-07-2025

  • Politics
  • BBC News

Why Atiku lead di wave of resignations comot from PDP?

Former Vice President Atiku Abubakar don resign from Peoples Democratic Party (PDP), afta e be member of di political party since1998. Inside one letter wey Atiku write to di chairman of PDP of im ward, Jada Local Government Area of Adamawa State on July 14, e tok say im resignation na becos of "irreconcilable differences" and e go like resign wit immediate effect. E express im gratitude to di PDP for di platform wey allow am to serve as vice president between 1999 to 2007 and contest for presidency twice. "I write to formally resign my membership from di Peoples Democratic Party (PDP) wit immediate effect," e tok. "I go like to take dis opportunity to express my profound gratitude for di opportunities di party don give me. "Serving two full terms as Vice President of Nigeria and being Presidential candidate twice dis na one of di most significant chapters of my life. As a founding father of dis esteemed Party, indeed e dey heartbreaking for me to make dis decision." "However, I find am necessary to part ways due to di current trajectory di party don take, wey I believe diverge from di foundational principles we stand for. Na wit heavy heart I resign, recognizing di irreconcilable differences wey don emerge." "I wish di party and dia leadership all di best in di future. Thank you once again for di opportunities and support." However, many reactions don follow Atiku resignation from di party. Di tok-tok pesin to Atiku Abubakar, Paul Ibe tell Arise News say di letter na leaked document but e tok say becos some of di party members dey work wit di rulling party openly na im make im principal comot from di party. E tok say now wey Atiku don comot from di party e go tok about wetin be im next step tomorrow. "No be about any ambition or 2027 election. As tins stand now no opposition party for Nigeria, na only one party di All Progressives Congress. E be like bus stop, all di buses dey go one place Oshodi, na wetin APC don turn am into," Paul Ibe tok. "Wetin happun to democracy, if we no get framework for democratic engagement we no go get opportunity for good governance. Atiku wan give Nigerians a viable platform to confront APC." "Right now, as I dey folow you tok former vice president don turn in im resignation, as member of PDP. Wen we wake up tomorrow e go turn take im next step. I bin tink say dem go dey happy about am becos dem tok say na im di di problem of dia party." Meanwhile, PDP neva confam officially weda Atiku don leave di party but govnor Seyi Makinde of Oyo State, don hint say Atiku Abubakar don defect from di party. On Wednesday, Makinde tell tori pipo for Ondo state say PDP na institution, and any party member get di freedom to exit di party. "PDP na institution, and you get freedom of entrance and exit. Anyone wey dey hold PDP down, e betta for such individual to quit," e tok. "But one tin we must all realise be say players go come and go, governors go come and go, president go come and go but our state and kontri go remain." Oda keyholder stakeholders of PDP wey don comot from di party Also Dele Momodu, submit im resignation from di party on Thursday morning, e tok say some antidemocratic elements don seize PDP. Oga Momodu announce say im dey comot from di PDP to join di new coalition party, African Democratic Congress (ADC). "Our party don undeniably dey seize by antidemocratic elements, both from within and without, in broad daylight. "Diafore e dey honourable to give away di remain of di party to dem while di majority of us earnestly align wit di new coalition party, di African Democratic Congress (ADC)." In April, Delta state govnor, Sheriff Oborevwori comot from PDP to join APC, di news bin circulate for social media bifor di govnor and members of im cabinet declare say dem don join di ruling party. E neva dey clear but news don dey spread say Osun State govnor, Ademola Adeleke go soon defect from PDP to join anoda party to secure im seat for di 2026 govnorship election in Osun State. However, Iyiola Omisore wey be member of APC allege say Adeleke bon dey beg to join APC. Reaction from Nigerians and members of di rulling party Minister of Aviation Festus Keyamo, wey be key member of di ruling party, All Progressives Congress condemn Atiku decision to resign days afta di death of former President Muhammadu Buhari. "Your Excellency, whilst I acknowledge say e dey within your constitutional right to change political parties at any time you may wish, releasing your letter of resignation from di PDP during dis week of di mourning of our immediate past President, Muhammadu Buhari, na clearly attempt to draw di spotlight away from such occasion and direct am on yoursef," e tok. "E dey both morally and legally wrong to kontinu to use di Coat of Arms of di federal goment in your private or political communication wen you stop being functionary of di federal goment more dan 18 years ago. "Section 6 of di Flag and Coat of Arms Act, Cap. F30, Laws of di Federation of Nigeria, 2004 make dis offence." Atiku Abubakar political career under di PDP 78-eight-year-old, Atiku Abubakar serve under PDP as Nigeria vice president in 1999 to 2007, e contest as presidential candidate in 2019 and 2023 but e no win. Although Atiku don dump di PDP three times since im join, e leave for 2006 to go join Action Congress and 2014 to join APC wen dem bin newly form di party. E don try to become di president of Nigerian since 1993 under different political parties, Social Democratic Party (SDP), PDP, AC, and APC. Till today, Atiku remains one of Nigeria politician wey don contest for di seat of presidency but e neva win. Hopefully e fit win in di 2027 election, if im contest.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store