logo
#

Latest news with #RaufAregbesola

Profile of ADC, why opposition leaders choose am as di rival party for 2027?
Profile of ADC, why opposition leaders choose am as di rival party for 2027?

BBC News

time14 hours ago

  • Politics
  • BBC News

Profile of ADC, why opposition leaders choose am as di rival party for 2027?

All eyes for Nigeria now don turn to di African Democratic Congress (ADC) afta di political party emerge as di anchor party for di opposition coalition to try to remove President Bola Tinubu from office for di 2027 general election. Di official announcement happun on Wednesday for di Shehu Yar'Adua Centre for Abuja, wia dem also announce former Senate President David Mark, and former govnor of Osun State Rauf Aregbesola as interim national chairman and secretary of di party. Dis na di most ogbonge move wey di opposition politicians don make so far since di tok-tok about a possible joinbodi start. However, many pipo still get questions about dis ADC party, how e come into existence, dia performance for former elections, and why dem chose am as di vehicle wey go carry di coalition. ADC brief history Founded in 2005 as di Alliance for Democratic Change by Mr Ralph Nwosu - a politician from Awka, Anambra State, in di southeast region of Nigeria - di party later change dia name to African Democratic Congress and dia slogan na 'Arise and Shine Nigeria'. Inec register dem in 2006 ahead of di 2007 general elections wia di party bin get candidates but dem no win any position. Dia first presidential candidate na Professor Pat Utormi who get just about 50,849 votes for dat election. Dia first win bin come in di 2011 elections wia dem win some five seats for di National Assembly. From di 2007 general election till date, di ADC don dey field presidential candidates for each election, as follows: Di ADC primary election for di 2023 general election bin cause plenty controversy as two big aspirants - former deputy guvnor of Central Bank of Nigeria, Kingsley Moghalu and Dumebi Kachikwu. Eventually, Kachikwu win di primary and contest di election wia e get only 78,930 votes. Crisis in di ADC Like many political parties for Nigeria, di ADC dey also go through serious gbege wey many political sabi pipo say e fit affect dis new opposition joinbodi. In 2022, Justice Binta Nyako of di federal high court Abuja bin sack Ralph Nwosu as di national chairman of di ADC, and pronounce one Ms Patricia Akwashiki as di authentic National Chairman of the party. Di judge also grant an order of perpetual injunction restraining oga Nwosu and im National Working Committee from parading diasef di National Chairman and NWC members of di party. Even though oga Nwosu bin appeal di judgement, e no dey clear weda di higher court bin reverse di decision. Already, Ibe Kachikwu, presidential candidate of di ADC in 2023 don tok say Ralph Nwosu no be di national chairman of di ADC and say di opposition joinbodi wey e dey lead no go get head. Kachikwu say e go challenge di "hijack" of di ADC by "some old politicians" for court. APC mock di joinbodi Di ruling All Progressives Congress (APC), who bin win power in 2015 sake of a similar joinbodi of different opposition parties, don wave off dis ADC movement and describe am as a joke. Bayo Onanuga, di tok-tok pesin for President Tinubu, say di former APC politicians wey join di ADC na pipo wey bin don comot for di party years ago sake of dia personal interests. "Diz politicians na desperados, hungry for power, not for di benefit of Nigerians but for diasef. Dem want power at all costs because dem no fit endure anoda four years for di political wilderness ..." Anoda big APC member and di Minister of Aviation, Festus Keyamo, say dis ADC joinbodi tin na di best pathway for APC to retain power by di next general elections. Keyamo say di law forbid one pesin to be member of two political parties di same time, so di politicians wey embrace di ADC don already disqualify demsef from di elections. "Wen di dust go settle, you go discover say di PDP and di Labour Party don lose sometin, di ADC only gain sometin wey be like caricature, but di APC lose absolutely notin," Keyamo tok. E continue say: "Wetin all of dis mean be say since di 2023 elections, di APC don dey stronger, but di opposition parties don dey fragmented and bicom weaker. Evribodi gatz make sacrifices - Peter Obi Presidential candidate of di Labour Party for di 2023 election, Mr Peter Obi, bin dey present for di event on Wednesday wia dem unveil di opposition coalition. However, e no dey clear weda he go now resign from im Labour Party and join di ADC. Obi tok for a post on im X handle say di commitment of di joinbodi group na "to sacrifice and work together towards di 2027 General Elections, to make sure say Nigeria go get competent, capable, and compassionate leadership". "No one group fit change Nigeria alone. To dismantle di structures wey don keep our pipo for poverty and insecurity, we must build bridges, not walls even wen dose bridges no dey easy," Obi tok. Meanwhile, former Minister of Transport Chibuike Amaechi don announce im resignation from di APC to join di ADC. Amaechi who bin contest di APC presidential ticket wit Tinubu, tell tori pipo say e resign from di APC on Tuesday, and even bifor den, e neva attend dia meeting. "Di last time dem invite me to dia meeting, I cut dem warning," Amechi tok. "I bin neva believe say Tinubu na material to govern di kontri. "Nigeria don dey completely destroyed. Pipo no fit eat. Money no dey to buy food. Evritin don scatter. Inflation dey very high. And di federal goment dey busy going around trying to hijack di election," Amaech tok.

Who be di political actors behind di coalition wey wan comot Tinubu from office, dem fit achieve am?
Who be di political actors behind di coalition wey wan comot Tinubu from office, dem fit achieve am?

BBC News

time2 days ago

  • Politics
  • BBC News

Who be di political actors behind di coalition wey wan comot Tinubu from office, dem fit achieve am?

Di move by some big opposition politicians to comot di current Nigerian President Bola Tinubu for office for di 2027 general election, don get stronger afta a meeting wey happen for Abuja on Tuesday. No be today tok-tok about a political joinbodi to comot di ruling All Progressives Congress (APC) from power start, but Tuesday meeting be like say na im be di one wey many Nigerians take serious. Afta di meeting, di participants announce say dem go adopt di African Democratic Congress (ADC) as di party for di joinbodi, and dem also announce former Senate President David Mark and former guvnor of Osun State Rauf Aregbesola as dia chairman and secretary respectively. But who be members of dis joinbodi? And dem go fit achieve dia aim of making Bola Tinubu a one-term president of Nigeria? Members of dis opposition joinbodi David Mark: Na former Brigadier General for di Nigeria army bifor e retire and also former military guvnor of Niger State from 1984 to 1986. Mark bin represent Benue South Senatorial District for di Nigeria Senate for many years and e rise to di position of senate president for eight years: 2007 to 2015. Dis Wednesday morning, oga Mark release statement say e don resign from di People Democratic Party (PDP) to join di opposition joinbodi group to make sure say dem "rescue our nation and preserve our hard-earned democracy". Rauf Aregbesola: Ogbeni as many pipo dey call am na bifor-bifor ogbonge ally of President Tinubu, who bin appoint am as commissioner wen e be guvnor of Lagos State. Oga Aregbesola bin complete eight years as commissioner for Lagos unda den guvnor Tinubu, bifor e run for guvnor of Osun State wit Tinubu support and e win, do two terms. But dia quarrel start wen Aregbesola bin quarrel wit im successor Adegboyega Oyetola, who bin also get di support of Tinubu. Aregbesola na di secretary of dis joinbodi and e tok for im acceptance speech say di task ahead no be easy one, "e go take time. E go demand sacrifice. But we fit do am". Atiku Abubakar: Incidentally, former vice president Atiku bin follow for di political joinbodi wey bring APC to power in 2015, now e don help form anoda one to comot dem. Atiku na one of di major PDP members wey pull out dat time to form di New-PDP and later enta di APC just bifor di 2015 general election, but shortly afta dat election e return to di PDP and na im be di party presidential candidate in 2019 and 2023. In fact, di quarrel wey dey tear di PDP apart currently na sake of di gbas-gbos betwin pipo wey dey loyal to Atiku and di ones wey dey loyal to Nyesom Wike, former guvnor of Rivers State who dey serve for di Tinubu administration as a Minister. Nasir El-Rufai: Anoda former Tinubu paddy wey later quarrel wit am. El-Rufai name bin follow for di pipo wey Tinubu bin appoint as ministers, but di senate no clear am. E don since announce say e don resign from di APC to join di Social Democratic Party (SDP). E follow for di pipo wey carri dis opposition joinbodi matter for head. Sule Lamido: Di former guvnor of Jigawa State bin also serve as Minister of foreign affairs unda President Olusegun Obasanjo from 1999 to 2003. He bin also contest di 2019 Presidential primary for di PDP but e lose to Atiku. Aminu Tambuwal: serve as Speaker of di House of Representatives and also two terms as guvnor of Sokoto State. Tambuwal follow for di pipo wey join di APC from di PDP bifor di 2015 general elections, but e jump bak in 2018. Babangida Aliyu: na two time guvnor of Nigeri State and even though e follow for di guvnors wey bin quarrel wit di PDP bifor di 2015 election, e remain for di party Sam Egwu: Former guvnor of Ebonyi State and also former Minister of Education. Liyel Imoke: Serve two terms as guvnor of Cross River State, afta e don work as minister of Power and Steel during di Obasanjo goment. Other popular names wey follow for dis joinbodi include: former PDP National Chairman Uche Secondus, PDP big oga Tom Ikimi, Senator Ben Obi, plus many odas. E neva dey clear wed di Labour Party presidential candidate for di 2023 election, Peter Obi, dey for dis group bicos e no follow for di meeting on Tuesday. However, im tok-tok pesin, Yunusa Tanko, dey always show face for all di discussion of dis joinbodi group. Weda e dey do am on im personal capacity, abi na Obi dey send am, neva clear.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store