logo
#

Latest news with #ReginaJohnson

Nigerian girl wey bike accident cut her leg dey inspire hope
Nigerian girl wey bike accident cut her leg dey inspire hope

BBC News

time11-04-2025

  • Sport
  • BBC News

Nigerian girl wey bike accident cut her leg dey inspire hope

Swimming na di passion of Regina but wen many pipo see her, dem go dey wonder how she take dey do am pass pipo wey get two full legs. Regina Johnson, na 23-year-old swimmer wey don win medals for di State wey she represent for national Games. She neva get di thought to go into swimming even bifor di dangerous accident wey cut her leg. For 2014, Regina bin dey waka for road, she bin wan cross to di oda side but as she no look road well bifor she cross, na so bike hit her. To survive, dem gatz cuts one of her legs. BBC Pidgin follow dis young Nigerian girl tok, and she open up say she get dream to represent Nigeria for Paralympics Games. Regina, wit her swimming skills win four medals for Oyo State for di 2024 Para National Games for Abuja. Dis don give her more confidence to do more trainings and prepare for bigger competitions. Na one coach bin discova her swimming talent and encourage her to compete. Wit hope and training, Regina compete for di Para Games for Abuja- dis na sometin wey she say many no believe say she fit do. "For 2014, dat time I be small pikin, so I bin wan cross di road, na so bike hit me," Regina tok. Regina dey battle day to day survival, even as she dey also do sports so as to pursue her dream of representing Nigeria for di Paralympics. "Some pipo go dey look say how dis pesin wey dey disable go dey do dis kain tin wey pipo wey get two legs no fit do." "I dey train by mysef, all dis big rivers for my village, I dey use am swim well. na one man see me for road wit im daughter, and dem collect."

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store