logo
#

Latest news with #Saliu

Bad smell surround community, as number of deaths pass 200, like 500 dey miss for Niger state flood disaster
Bad smell surround community, as number of deaths pass 200, like 500 dey miss for Niger state flood disaster

BBC News

time02-06-2025

  • Business
  • BBC News

Bad smell surround community, as number of deaths pass 200, like 500 dey miss for Niger state flood disaster

Di death toll for di flood disaster wey hit two communities for Mokwa town, Niger state north central Nigeria don increase to more dan 200 on Sunday. Search operation don continue as di residents help to locate around 500 wey still dey miss. Di flood happun on Wednesday night for Mokwa local goment area of di state sake of heavy rainfall wey destroy shops, houses, and farms. Musa Kimboku, di deputy chairman of Mokwa local government tell BBC say di search no longer be rescue effort, as dem believe say dem no fit find anybodi alive days afta di floods happun. E say dem tell nearby villages to bury any dead body wey dem find. Also, Mokwa district head, Muhammadu Aliyu say dem go soon start digging to bring out all di corpses wey dey buried underground to prevent di breakout of any disease. 'I lost 2.5 million and oda items for di flood' One eyewitness tok how di flood bin hit dem for early morning wen dem just pray finish. Saliu wey be 34 years say im mama bin come dey bang im door around 6:00am for morning wen di flood bin dey start. "My mama come dey bang my door. She dey bang am with force, she dey shout say water dey come out make we come outside. I wan pass di main gate but she tok say make I pass di back door. I come outside and flood dey." Saliu say e sell some goods one day bifor di flood bin start and lost about 2.5million becos im no fit go back go pick anytin for im house. "I remember my money becos I sell some goods of about 2.5 million naira but I bin wan go back inside di room but I dey tink di pressure of di water, maybe if I go back inside di room something fit happun I leave everything since di flood don become like dis." "I get 11 bags of groundnut and seven bags of beans. We no fit pick anything, na only me and my singlet comot. We no see anything pick everything don go. Di flood water dey high and e dey come wit high pressure, we dey see deadibodi inside di water wey we no fit count." Saliu say na im friends bin give am di cloth wey im dey wear becos evritin wey im get don go wit di flood. Anoda resident wey dey affected say na nine out of 15 members of im family don die oe dey miss and dem still dey find dia bodi. Di man say dem just wake up dat morning and water don full dia compound and dem no fit escape. E narrate say di water almost cover am as di water dey wash plenti tins away. "We just wake up in di morning around 7:30 to 8:00 am. We just see water for our compound, we no fit escape becos di water dey beyond our capacity. Wen di water flow into our compound we no get any oda alternatives di water dey above our capacity and di flood water reach my chest. "We be 15 pipo but nine pipo don die, we see one deadibodi, we neva see di bodi of di eight pipo. We believe say dem no dey alive again becos since we neva see anybody we leave everything to God," e tok. E say di water don wash away im house and im no see anytin becos di water don flush away im properties. "I dey feel sad becos no be di property but di lives wey I lose, e dey paniful. No be even me any pesin wey love me go feel sad. I wish my family rest in peace and oda pipo wey die. Bad smell for di community Di mood for Mokwa na grief for di dead, confusion for di missing and loss of dia properties. Clothes scata round, mattresses dey soaked wit water and different crushed metal roofing sheets show wia some of di dozens of houses bin dey bifor, for Tiffin Maza Community for Mokwa town, Niger state. BBC reporters find say some of di structures wey still dey stand, dia roofs don wash off and some parts don destroy. Di flood get harsh impact for di community. According to wetin BBC observe for di community, strong bad smell dey around di community and residents believe say dem fit no rescue anyone alive again. Di local govment dey fear say di bad smell, and contamination wey di deadi bodi dey cause for dia water fit lead to diseases wey dem no fit handle. Food trucks stranded, farmers association react Some truck drivers tok say di Mokwa bridge wey collapse don affect dem as dem no fit travel wit di food items wey dey dia vehicle. Mustapha Salaudeen wey follow BBC Pidgin tok explain say na traffic dem dey and e reach Dikko junction wia all di trailers dey stranded. E tell us say na one side of di bridge bin collapse and dem dey find alternative routes wey go help dem move and transport dia goods. "We dey inside traffic becos di flood cut a part of di bridge and we dey find alternative, but we dey move small small as di community pipo dey help us." "As di road cut, our truck just dey here and some get foods wey fit spoil if dem no offload am sharply." Meanwhile, di National Secretary for Tomato Farmers for Nigeria, Sani Danladi, tok say di collapse of Mokwa Bridge go affect foodstuff supply to southern part of Nigeria. E say dis na becos of festival season and di bridge dey among road wey dey link two parts of di kontri. Danladi tok say, "Dis Mokwa bridge for Niger state dey really important. Since na di only bridge wey dey link two parts of di country, e go affect southern part pass, as vegetable price fit go up becos supply no go dey." "Meanwhile, for northern part, price fit reduce sake say di vegetables and oda food stuff go plenty for market since dem no fit carry am go south again," e tok.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store